Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,435 members, 7,808,555 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 01:23 PM

Andy Blaze - Wida Na Lyrics... - Music/Radio - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Music/Radio / Andy Blaze - Wida Na Lyrics... (1447 Views)

Check Out This Song By Nairalanders! Andy Blaze & 3Geez - Lit Rich / Nairaland Artiste Andy Blaze drops Two New Singles " Put Call" And "Pikachu" / Jay P Ft. Andy Blaze - Imo State (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Andy Blaze - Wida Na Lyrics... by NessaFresh(f): 3:22pm On Mar 24, 2016
Intro:

Wida Na you sef don dey feel like a leader na (bad man something)

Wida Na you sef don dey feel like a leader na (bad man stunting)

I go by the name of
Andy Blaze and I rep BITG

You know wetin dey happen na, when PH boys dem turn up on a track maan

We ma kill that track

And this track is dedicated to all of them boys damma form a lot

And them other girls demma form a lot mehn

Dem dey form like say na dem get everything (get packaging?)

Never...okay let's go....

Verse 1 :

Abobby Wida Na
You sef don dey feel like a leader na
Yesterday tonye today belema the other day I saw you with Freda na(eh)
Shey you sef don dey run package
You like big y***h get big advantage
You wan climb her shey she don turn stage
Na your type dey wan fetch water carry basket(aah)
You never see something
When dem obtain you, you go feel something
Dem go chop you raw like fresh pumpkin
Dem go make sure say you feel something

(Bridge)
Street things street things
We can't walk n****r we can't talk n****r
Wida na you sef don dey feel like a leader na

Verse 2

Leggo!
Fine Girl Wida na
Me hear say you be cheerful giver na
You don give Musa, you don give Ejima
Me too go like be a receiver na(eeh)
Make my network connect to your own
My antenna signal go strong for your phone
Shey you understand the point I'm tryna make
Its your waist not your heart that I'm tryna break(eh)
Me sef go like run your package
Make you come my place give me home advantage
Shey you understand the point I'm tryna make
Its your waist not your heart that I'm tryna break(eh)

Bridge:
Wida na you sef don dey feel like a leader na...boomba!

You dey form big boy you don run all the bannies all of them hmm you have it
You dey form fresh boy but na sambisa forest dey under your armpit
You raise hand up for church pastor hear the smell him shout Blood of Jesus, Jesus!
There's a demon In our midst and today we must kabash until he leave us, leave us!
For outside you dey form clean boy but inside your boxers you get craw craw
You dey form fine girl you carry marykay full face but then you still worwor
(But then you still worwor eh)
Wida na you sef don dey feel like a leader na..
(Wida na you sef don dey feel like a leader na)

Verse 3 :

Andyblazeyyy
Eh! You dey...
You dey form fresh girl but you dey change top ontop one leggings
You dey form miss independent but you dey use whatsapp for your coded beggings
(Sweetheart I have headache,I'm feeling pain I'm feeling bad eh
To make me feel better you have to send me heh some recharge card ehn?)
Shey recharge card don dey cure headache...Wida Na
Dem dey preach for nairabet...(Wida Na)
Dem no fit racks you but whenever you dey walka you dey always walka with your friends(chai)
Big boy dey borrow airmax....Wida Na
You don see community boy dem dey racks....Wida Na
No dey form wetin u no be cos one day dem go surely bring you to the ground...Wida Na

Andy blaze andy blaze on a beat I dey jumpan a beat I dey kill am pronto
I dey rap, I dey sing, I dey do MC I'm music like in-toto
And on the M.I.C abum dike abum dike boy I aint talking Tonto



Outro:

Wida na you sef don dey feel like a leader na
Wida na you sef don dey feel like a leader na
G-don the music maker...
Rep B.I.T.G

Music fades.....

1 Like 1 Share

Re: Andy Blaze - Wida Na Lyrics... by NessaFresh(f): 3:33pm On Mar 24, 2016

(1) (Reply)

Kwesi Arthur - Nkwasiasem Ft. Lil Win & Bisa Kdei (prod. By MOG) / Anyone Wants To Swap Nigerian Music? / Dj Dee Money Presents Old School Gbedu Series 5

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 18
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.