Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,192,125 members, 7,946,779 topics. Date: Thursday, 12 September 2024 at 07:04 AM

Nigeria has finished me!! - Politics (54) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Nigeria has finished me!! (196631 Views)

[Classified Video, MUST WATCH]: NNAMDI KANU HAS FINISHED NIGERIA!!! / Nigeria Has Finished Me: Lessons Learnt / Nigeia Has Finished Me Rejoinder (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (51) (52) (53) (54) (55) (56) (57) ... (118) (Reply) (Go Down)

Re: Nigeria has finished me!! by Sprintson(m): 8:17am On Jul 08, 2016
DDeliverer:


Na d question be that....what's the way forward??

Abi make we gather go aso.rock tell buhari say we no dey comot there until we get better job? if dem wan shoot us make dem shoot?

abi na to use leg run comot from this country?

Really if some graduates do this thing e be make sense oo..instead of dying in silence and poverty, ALL Nigerians Lives remain 1BAR; I CONCUR

1 Like

Re: Nigeria has finished me!! by theresaese(f): 8:18am On Jul 08, 2016
.
Re: Nigeria has finished me!! by Sprintson(m): 8:20am On Jul 08, 2016
signature2012:


Guy,what I will just say is,never give up!

I remember one time I had only a single Jean,na dis Jean I dey wear daily,this tori don tey small o.
One particular day,na so I wear this same Jean,I dey road dey go,something fell for my hand,as I say make I pick am,na so my Jean just dey tear,I just turn am to crazy Jean,but today,things don better,life don change for good,don't rely on any govt but God,so as far life dey,their is hope.

Hahahahaahahahahah very funny but true story
Re: Nigeria has finished me!! by theresaese(f): 8:21am On Jul 08, 2016
,
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:23am On Jul 08, 2016
Make I talk my own join. No be government dey do us alone, we hate each other like shit in this country. since I commot from service in 2014, I no get nothing meaningful to do, I took the bull by the horn and started going to Jamb coaching center to seek part time teaching position. d guy say him go pay me 150 per class, I think am, but a begger got no choice. if you think say na lie. Na ilorin dis one happened o. each class na 2hrs. my transport to and fro na 100 naira. in a day I go struggle teach Mathematics three times in a day. my guy talk say d student no dey pay yet, say make I just continue. After 3wks, d guy call me and give me 500 naira... I just sit down for ground say make I manage am..he said I should keep coming things will get better. 3wks hardwork 500 naira, didn't even cover my Tfare. every day ijmb students go come d idiot won't charge them anything less than 40,000 for training. in my mind I swear for am big time with out holding back tears.

After that I struggle enter one private school and the pay was 12k as. my first day, na only one teacher I see, I was told d others were unavoidably absent. After one week I realized only two of us was commissioned to teach 4 classes Jss1 to Ss1 plus one teacher who comes to teach physics and chemistry on part time basis. I taught basic science, technology, agric science, ,maths, English to 4 different classes. my other partner get him own evening job, so na only me go do lesson from 2-4pm. dem dey pay the guy only 8k.. At d end of the month the owner called me into her office and gave me half salary of 5650 naira instead of 6000 , said the 350 na for tax purposes. up till now I never get my balance.

Midway into the second month, my uncle saw how lean and fragile I was looking coupled with my partial disability. He said don't go to that school again, apply for a masters, I will sponsor you. I was so happy I got a admitted into U. I last year, things were going smoothly until this "change " rubbish started. From December last year my uncle has not received his salaries. after completing my course work, no money for third semester fees. on top of that project supervisor wey dem allocate to me wan make I come do project of 250,000 naira. I never even chop belle food or pay the 50k plus for third semester school fee. Since March I just commot my self from school go back home to take care of my mother who is a single mother.And thanks to Kwara state government dem never pay local government for a while now. I no go come fit kill myself, took up a few private coaching, now we dey chop.

But I just pray people who use others like slaves for their own selfish reasons go receive their punishments In folds.
So tell me, in Nigeria individual problems surmount what the government is doing to us. I go keep my up alive... one day me self go hammer and I will lead a better life.

9 Likes 3 Shares

Re: Nigeria has finished me!! by dadebayo1(m): 8:23am On Jul 08, 2016
Good morning family.. Thanks to the entire team last night.. Will definitely save this thread for reference later in the future.. Hustling continues all the best to everyone.. I hope we have all come to realise that the politician weather in pdp apc or ffa or kdk have failed us, I sincerely pray we would look for ways to improve our lives and focus less on singing praises to our politicians.. As ajimobi no gree pay 6months salary manpikin dey go out to find part time job to keep body and soul together.. Wish everyone a blessed day and thanks to ymodulus and his entire team once more...
Re: Nigeria has finished me!! by Lordkratus(m): 8:27am On Jul 08, 2016
No bother about enterprenuership that ish na scam.me graduate from uniben geology since 2012 with 2.1 na so joblessness wan finish my enemy naim last year I come hear say if you be agent to bet company say you dey get better money naim I hustle bet para people take gather capital start my brother my shop get vituals and everything with just one staff me they there 247 dey work after all expensis in a month na only 15k dey reach me as profit.the painful part be say inside dat 15k when I dey go hustle from morning till night everyday for one month so na there I go give mumsi something atleast to support her na there I go take give my younger ones make dem no say bros stingy na dere my gf dey I never talk of cloths or even save to rent house abeg make una tell me how man go take gather 120k to take rent house leave him papa house for this warri when everything cost.so brothers abeg na job sure pass I am currently dusting all my c.v submitting reactivated I dun give up b4 but maybe grace go smile on me this time

3 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by Kosy79(f): 8:29am On Jul 08, 2016
cromz:
Hmmmm, I can see the youths voicing out their anger. What u don't know is that the situation you are complaining about someone is praying to be there. At least u still HV Money to buy mb comment for nairaland. No matter ur situation or victim of what u have become a hero lies in you. U can't just sit ur lazy ass down and comment on nairaland about ur plight. The difference between u and those in power is their ability to think outside the box and do something for their selves.
Whenever situations like this arise a hero is needed. U can lead a protest, write about the situation. There are so many ways u can be a revolutionary. And make a name for yourself. Am advising u to do something about your current situation and help others around u too. Finally am ready to help any two youths with 5k cash each the money will be deposited in ur accounts next week so that I can assist too.
3100200914 First bank. Thank u sir. If my luck shine fine if e no shine fine as longer as u help others. May GOD replenish u 100 folds of what u wll give out Amen.
Re: Nigeria has finished me!! by spoton16: 8:30am On Jul 08, 2016
[quote author=Opiletool post=47320124]What I'm seeing here is the exact reason a revelotion will never stand. Many will start the course, but 70% will derail from the course later due to stipends. I don't blame pple though; the struggle is real. This guy started this thread to voice out the terrible state of his present situation, many like minds joined him and the clamour for revolution was at one point intensified only to be mitigated by innocent offer of token by some generous few (a move I'm not against, but ask yourself after 5k what next?) . Now this is the exact power the Politicians/Elites have over us.

This thread assuming it has not unfortunately being shifted from his earlier stance, it would have sensitized a lot of people out there. I hope it doesn't die a natural death.

God bless those generous guys though. Come to think of it, some people wey get a means of earning go still follow apply o. God help us all. [/quot
Bro u see what we ar facing ehn lik 50 pple hav said dis buh nothin dem just dey drop acct no wetin 5k go do ehn. Dis is hw it happens ehn my brother or guys older dan me will say lets go n meet chairman we nid road dey will reach his office as a sharp chairman he will tak dem 2 bar buy dem beer n giv dem change 4 d next 2wks same tin d guys will nw forget d road dey wanted 2 ask 4 n wait till next election imagine. Tanks to d pple dat dropped mny buh seriously we nid solution naa

1 Like

Re: Nigeria has finished me!! by nabiz(m): 8:30am On Jul 08, 2016
to also help my country people. I need 5 guys wey i go train for free on my skill. The trainiing will start on 20th august. U can click on my profile to see my skills.

2 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by nairaman66(m): 8:32am On Jul 08, 2016
Nigerians una see una life? na account una don dey drop!! Very soon na una prick una go chop after 5k don finish. This nor be thread to dey beg money una hear? If you wan beg money, go 3rd mainland bridge!! Wetin dey worry una? OP nor fit beg money when him start this talk? Anybody wey accept or send money give anyone na thunder go fire am!!

When Fela dey sing that time of old dem say him dey craze... Dem say na igbo don finish him brain. Dem throw Fela up and down to different prisons like Naira against US dollars. Between Fela and the Nigerian Government na who talk truth pass? Government don dey lie like Linus Mba since the 1970's.

Finally dem take their Ogboni meeting kill the poor musician, now him dey rest for grave but him words and prophesy dey live on. Make you see the Nigerian Government life- Fuel scarcity, Kidnapping, adultnapping, budget missing, constituency project fighting, subsidy, subsidy removal, police brutality, etc.

When we small that time, dem dey call us the leaders of tomorrow. Now, I don get white hair remining small na walking stick I do dey use, na still thesame people dey for government! Which kain country be this? No judiciary, police nor electric power because some people dey this country wey dey powerful!! My prayer since na for crude oil to equal $1 to a barrel, I know say prayers will be answered.

I nor sure say Nigerians (The Masses) go enter Hell fire.., because dem don already do their time for hell here while on earth.

2 Likes

Re: Nigeria has finished me!! by titane: 8:32am On Jul 08, 2016
djlaqua91:


Oga Ymodulus. If change still remain for your hand abeg. Jungle rough walahi.
bro modulus, are you distributing money? bikp, epp me
Re: Nigeria has finished me!! by Adisa89(m): 8:33am On Jul 08, 2016
MaziOmenuko:
Ee come be like say everything for this country dey harsh, mosquitoes come harsh pass. No insecticide dey kill them again, abi dem don mutate come develope resistance for insecticide. I don spray tire, pour snipper sotey na me the snipper wan come kill. To breathe na wahala, still mosquitoes dey bite, sulk and even chew.

The other day I no sabi as rat take run enter my kitchen. I no even border myself to look for am. I just secure my certificate them because I know say if hunger finish with am for that my kitchen, the next thing him go do na to dey find my certificate. This morning, na so I see the rat lie down for my kitchen. I been think say him don die until I notice say him dey breath small small and dey blink him eyes. I just use broom sweep the thing comot.

The huzzling is real!
You mean say hungry wan kill the rat too? grin grin grin grin
Re: Nigeria has finished me!! by theresaese(f): 8:34am On Jul 08, 2016
S
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:34am On Jul 08, 2016
DDeliverer:
as I dey here now...my temper dey hot..I dey vex!!

Source of income no dey anywhere..some fools go save 'become an entrepreneur' shey na my kidney go give me capital to take set something up? Abi dem go gree give person loan?

Those foools dey deceive themselves say them dey empower youths...which youths? why we like to dey deceive ourselves? shebi na because Nigerians too quiet na him make dem think say we be mumu?

Boys vex enter street begin play bet9ja, baba ijebu and all whatnot....yet, no level...Games dey cut back to back.. if arsenal no draw, Chelsea go lose...which kind betting boys no try...under 1.5, under 11.5, over? goal.goal..name it..

sowtee we enter virtual betting...losing back to back...Every game was a lost..
see graduates dey play virtual at least to get 1k take recharge phone...

na d kind life human being suppose dey llive?
seriously uv said it all... dis country need revolution buh i juz cant stop laughing...

1 Like

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:35am On Jul 08, 2016
agarawu23:
Ymodulus, hadura29 , Ayo7 should confirm the account numbers below haven't received money from them plz.



Pls do confirm there is no error. You Will be credited today. God bless our hustle.

Pls. If i no pick u, dnt be angry cos the mention are too much and i just have to do what i have in power. We can't satisfy everybody.

No error
God bless you abundantly

1 Like

Re: Nigeria has finished me!! by Teespice(f): 8:35am On Jul 08, 2016
Odunharry:

It's good you are thinking about life after Nysc one thing i have to tell you is, Don't despair..
For many people, jobs are already waiting for them.

You just said the sad truth.. Life after Nysc isn't too easy but i will advice u to start planning and preparing, get your cv done n give people who are experienced to help review your cv and trust me it's never too early to start applying for jobs..
All the best.

thanks a lot.

already done my CV and I am still looking up law firms to apply for jobs.
Re: Nigeria has finished me!! by Onuohasworld(m): 8:36am On Jul 08, 2016
Incase una blessing reach me ...,access bank 0044568236..I no get strength to complain again..feeding sef don turn world war 4
Re: Nigeria has finished me!! by Teespice(f): 8:36am On Jul 08, 2016
OluKayy:

Some financially fortunate dude would swing by and marry you nao.
no dey yarn this kain talk for my ear. it's irritating to say the least.
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:36am On Jul 08, 2016
auchomage:
Make I talk my own join. No be government dey do us alone, we hate each other like shit in this country. since I commot from service in 2014, I no get nothing meaningful to do, I took the bull by the horn and started going to Jamb coaching center to seek part time teaching position. d guy say him go pay me 150 per class, I think am, but a begger got no choice. if you think say na lie. Na ilorin dis one happened o. each class na 2hrs. my transport to and fro na 100 naira. in a day I go struggle teach Mathematics three times in a day. my guy talk say d student no dey pay yet, say make I just continue. After 3wks, d guy call me and give me 500 naira... I just sit down for ground say make I manage am..he said I should keep coming things will get better. 3wks hardwork 500 naira, didn't even cover my Tfare. every day ijmb students go come d idiot won't charge them anything less than 40,000 for training. in my mind I swear for am big time with out holding back tears.

After that I struggle enter one private school and the pay was 12k as. my first day, na only one teacher I see, I was told d others were unavoidably absent. After one week I realized only two of us was commissioned to teach 4 classes Jss1 to Ss1 plus one teacher who comes to teach physics and chemistry on part time basis. I taught basic science, technology, agric science, ,maths, English to 4 different classes. my other partner get him own evening job, so na only me go do lesson from 2-4pm. dem dey pay the guy only 8k.. At d end of the month the owner called me into her office and gave me half salary of 5650 naira instead of 6000 , said the 350 na for tax purposes. up till now I never get my balance.

Midway into the second month, my uncle saw how lean and fragile I was looking coupled with my partial disability. He said don't go to that school again, apply for a masters, I will sponsor you. I was so happy I got a admitted into U. I last year, things were going smoothly until this "change " rubbish started. From December last year my uncle has not received his salaries. after completing my course work, no money for third semester fees. on top of that project supervisor wey dem allocate to me wan make I come do project of 250,000 naira. I never even chop belle food or pay the 50k plus for third semester school fee. Since March I just commot my self from school go back home to take care of my mother who is a single mother.And thanks to Kwara state government dem never pay local government for a while now. I no go come fit kill myself, took up a few private coaching, now we dey chop.

But I just pray people who use others like slaves for their own selfish reasons go receive their punishments In folds.
So tell me, in Nigeria individual problems surmount what the government is doing to us. I go keep my up alive... one day me self go hammer and I will lead a better life.
it's well bro! Nigeria is a pity. We are born into predicaments in a third world country de-capacitated by corruption and excessive avarice for wealth at the expence of others. The rich keeps stealing but I know one day will be their turn. Graduates everywhere nothing meaningful to do. Poverty I know will surely make us unite one day to fight our common enemy (polithiefcians).
Re: Nigeria has finished me!! by nairaman66(m): 8:38am On Jul 08, 2016
agarawu23:
Ymodulus, hadura29 , Ayo7 should confirm the account numbers below haven't received money from them plz.



Pls do confirm there is no error. You Will be credited today. God bless our hustle.

Pls. If i no pick u, dnt be angry cos the mention are too much and i just have to do what i have in power. We can't satisfy everybody.

Na so your money long? this is totally not the solution! Soon another thread will rise again and people will come up with their problems. How long can you keep up with it?
Re: Nigeria has finished me!! by Opiletool(m): 8:39am On Jul 08, 2016
[quote author=spoton16 post=47320947][/quote]

Abi na.
Re: Nigeria has finished me!! by Theflint1(m): 8:40am On Jul 08, 2016
E clear say na Benin u dey
DDeliverer:


You dey always dey make me dey laugh..
I shock yesterday when them tell me say PURE WATER na 20naira...I just open my mouth...I just tell the pure water girl make she carry her wahala dey go...

1 Like

Re: Nigeria has finished me!! by omoluka: 8:40am On Jul 08, 2016
AntiWailer:
This is very heart breaking.

I am in tears right now.

This is how far they have pushed the youths to.

It is very sad. Very very sad. I feel very down.

God bless you Ymodulus, i am encouraged, can u please help me share 50k this night ?

5k to 10 students . If u can PM me ur account no I will send 51k to cover for charges per transfer.

Please keep me anonymous but let me know the nairalanders that are beneficiaries.

Please take d decision 100%.


Bros help me with 5k, stanbic ibtc 0017466944
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:41am On Jul 08, 2016

1 Like

Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:42am On Jul 08, 2016
auchomage:
Make I talk my own join. No be government dey do us alone, we hate each other like shit in this country. since I commot from service in 2014, I no get nothing meaningful to do, I took the bull by the horn and started going to Jamb coaching center to seek part time teaching position. d guy say him go pay me 150 per class, I think am, but a begger got no choice. if you think say na lie. Na ilorin dis one happened o. each class na 2hrs. my transport to and fro na 100 naira. in a day I go struggle teach Mathematics three times in a day. my guy talk say d student no dey pay yet, say make I just continue. After 3wks, d guy call me and give me 500 naira... I just sit down for ground say make I manage am..he said I should keep coming things will get better. 3wks hardwork 500 naira, didn't even cover my Tfare. every day ijmb students go come d idiot won't charge them anything less than 40,000 for training. in my mind I swear for am big time with out holding back tears.

After that I struggle enter one private school and the pay was 12k as. my first day, na only one teacher I see, I was told d others were unavoidably absent. After one week I realized only two of us was commissioned to teach 4 classes Jss1 to Ss1 plus one teacher who comes to teach physics and chemistry on part time basis. I taught basic science, technology, agric science, ,maths, English to 4 different classes. my other partner get him own evening job, so na only me go do lesson from 2-4pm. dem dey pay the guy only 8k.. At d end of the month the owner called me into her office and gave me half salary of 5650 naira instead of 6000 , said the 350 na for tax purposes. up till now I never get my balance.

Midway into the second month, my uncle saw how lean and fragile I was looking coupled with my partial disability. He said don't go to that school again, apply for a masters, I will sponsor you. I was so happy I got a admitted into U. I last year, things were going smoothly until this "change " rubbish started. From December last year my uncle has not received his salaries. after completing my course work, no money for third semester fees. on top of that project supervisor wey dem allocate to me wan make I come do project of 250,000 naira. I never even chop belle food or pay the 50k plus for third semester school fee. Since March I just commot my self from school go back home to take care of my mother who is a single mother.And thanks to Kwara state government dem never pay local government for a while now. I no go come fit kill myself, took up a few private coaching, now we dey chop.

But I just pray people who use others like slaves for their own selfish reasons go receive their punishments In folds.
So tell me, in Nigeria individual problems surmount what the government is doing to us. I go keep my up alive... one day me self go hammer and I will lead a better life.

wow..

e go better shey?

1 Like

Re: Nigeria has finished me!! by theresaese(f): 8:42am On Jul 08, 2016
.
Re: Nigeria has finished me!! by Seungid1(f): 8:43am On Jul 08, 2016
Teespice:


no dey yarn this kain talk for my ear. it's irritating to say the least.
I think na only me. That kain talk makes one's struggles look like a joke
Re: Nigeria has finished me!! by Fynestboi: 8:43am On Jul 08, 2016
sad sad
Re: Nigeria has finished me!! by anonym0us: 8:43am On Jul 08, 2016
Ymodulus:

You welcome brother.

And you funny. Am actually Atheist, so I don't believe in God.

However if i was to choose a god, i will pick ORISA, i find his story more fascinating.

Bye
I know I'm late but DIAMOND BANK account number:
0064816404
Re: Nigeria has finished me!! by Austyno90(m): 8:44am On Jul 08, 2016
Young modulus, help ur boi as u help others. 3056902281 first bank. Thanks
Re: Nigeria has finished me!! by Nobody: 8:45am On Jul 08, 2016
franciskaine:
it's well bro! Nigeria is a pity. We are born into predicaments in a third world country de-capacitated by corruption and excessive avarice for wealth at the expence of others. The rich keeps stealing but I know one day will be their turn. Graduates everywhere nothing meaningful to do. Poverty I know will surely make us unite one day to fight our common enemy (polithiefcians).
I still insist that it's among us that this polithiefcians are emerging from. It's true we can't be the same, but why do we keep allowing this wicked people to lead us? Youth especially, we dey jounce big time, selling our future for a pot of porridge. Let's speak out against the in human treatment... No more suffering and smiling

4 Likes

(1) (2) (3) ... (51) (52) (53) (54) (55) (56) (57) ... (118) (Reply)

Abba Kyari Is Dead! / Nigeria: The Good, The Bad, The Beautiful, The Ugly. / 2019 Presidential Election Results Announcement By Mahmood Yakubu, INEC Chairman

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 85
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.