Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,149,733 members, 7,806,006 topics. Date: Tuesday, 23 April 2024 at 10:05 AM

The Beer Parlour - Dating And Meet-up Zone (6) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Dating And Meet-up Zone / The Beer Parlour (42560 Views)

Romantic Pub Section For London/UK Heads - Free Pint Of Beer For Everyone / Romantic Beer Parlour. Anything Fit Happen Here (PIDGIN ENGLISH ONLY) / Dave2's Mahjong Parlour with his Buddies! (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (35) (Reply) (Go Down)

Re: The Beer Parlour by daylae(m): 2:46pm On Feb 11, 2010
@milkan05 na gawd go save us from nepa o! Seven point agenda don go holiday as umaru still dey saudi. @meekas i no know say u be ultimate man ur sef o!
Re: The Beer Parlour by milkan05(m): 3:23pm On Feb 11, 2010
@daylae

on that umaru issue----u go fit allow ur vice, assistant or deputy bear the name goodluck from now on? *hic*


madam give me anoda bottle of UDEME
Re: The Beer Parlour by kpolli(m): 3:28pm On Feb 11, 2010
no but i fit let my immediate oga bear that name
Re: The Beer Parlour by delagasky(m): 3:30pm On Feb 11, 2010
On the our Goddluck matter, one guy wey i know just called off his church wedding!! why? his bestman is named Goddluck!! the rest is left to ur imagination!!
wat??!! Kpolli wetin be dis now, this ur pple wan spoil market for you o, this stout no cold now!!
Re: The Beer Parlour by milkan05(m): 3:44pm On Feb 11, 2010
@ Kpoli

I hear u.

@ dega

na so? wetin im for com do if im bestman name na john terry?
Re: The Beer Parlour by daylae(m): 3:46pm On Feb 11, 2010
@all i quickly run go house,den say nepa won cut our light. Madam i beg help me bring the bottle make i continue o! @milkan05 i no fit work togeda with som1 wey dey bear goodluck o! The guy name overthrow alameisiegha and now he don do the same for umaru,oga o!
Re: The Beer Parlour by nagoya2(m): 3:47pm On Feb 11, 2010
shocked
ol' boy eeeeeee! see men de high for aftanoon
abeg kpoli, gimme two chiiiiiiled bottles of harp
Re: The Beer Parlour by hatch: 3:55pm On Feb 11, 2010
Dora has asked me to inform all you fellow drunks that there will
be an emergency FEC meeting at her new Beer Palour along
Garki Area 11.

Free beer in the house ! In fact more than enough to go around
She is giving God the Glory for the downfall of her enemies like Aondoakaa.

Come one come all.
Re: The Beer Parlour by daylae(m): 4:17pm On Feb 11, 2010
Nothing do us, maybe she fit connect me with the MD of nigerian brewries sef,cos i won make some complain personally to am.
Re: The Beer Parlour by djcrucifix(m): 4:20pm On Feb 11, 2010
*hic * i think i just *staggers* peed *hic* in my bleeping pa pa pa paaaaants! *falls inside gutter* grin grin grin
Re: The Beer Parlour by delagasky(m): 4:22pm On Feb 11, 2010
Nothing do us, maybe she fit connect me with the MD of nigerian brewries sef,cos i won make some complain personally to am.

wetin u wan complain abt, i fit help u o
Re: The Beer Parlour by hatch: 4:32pm On Feb 11, 2010
delagasky:

wetin u wan complain abt, i fit help u o

He wants to complain the unfair advantage that has plagued the entire Beer Palours in his vicinity.
They have simply refused to compensate him for contribution to the drinking society.

It is not fair i repeat. We need free drinks and some compensation. After all Uzoma the girl
that the Navy and that rear admiral beat has be asked to pay 100 Million.
Re: The Beer Parlour by delagasky(m): 4:36pm On Feb 11, 2010
na so? wetin im for com do if im bestman name na john terry?

lwkmd!!! cheesy grin grin grin
Re: The Beer Parlour by daylae(m): 4:40pm On Feb 11, 2010
@delagasky abi u be the man assistant? Anyway sha,i won tell am say make them try reduce their prices so that all the people wey they take those local drink like sepe go afford buy beer.
Re: The Beer Parlour by delagasky(m): 4:40pm On Feb 11, 2010
He wants to complain the unfair advantage that has plagued the entire Beer Palours in his vicinity.
They have simply refused to compensate him for contribution to the drinking society.

It is not fair i repeat. We need free drinks and some compensation. After all Uzoma the girl
that the Navy and that rear admiral beat has be asked to pay 100 Million.

make he go court like the chic na smiley
Re: The Beer Parlour by delagasky(m): 4:43pm On Feb 11, 2010
@delagasky abi u be the man assistant? Anyway sha,i won tell am say make them try reduce their prices so that all the people wey they take those local drink like sepe go afford buy beer.

if u no fit afford change ur brand as well grin grin
Re: The Beer Parlour by meekas(m): 4:47pm On Feb 11, 2010
People, I just changed my middle name to Goodluck. Pls bar tender, serve everybody wht they drink grin
Re: The Beer Parlour by delagasky(m): 4:51pm On Feb 11, 2010
^^^^aeg make una push this boy out of here b4 somtin begin happen to all of us!! angry angry
Re: The Beer Parlour by Nobody: 4:54pm On Feb 11, 2010
Guys how una dey?today work tough oo! My oga no gree me rest since mornin.kpolli,why u dey dull this evenin.abeg sharply give me one dead star make i start wit.my throat don dry.i hear say dem sack our AGF.d guy don twist our constitution tire.kpolli,wetin hold u now?giv me opener.i suggest u employ service girls for here.this place is gettin too big 4u to run alone
Re: The Beer Parlour by Nobody: 4:58pm On Feb 11, 2010
Guyz i get one small gist

if your babe's bestfriend na very fine girl and u like am and she self like u seriously

one day ur babe come catch two of una dey kiss and she no talk anything she jus waka comot

later as u dey explain things to am she jus give u one very dirty slap!
wetin u go do if na u?
Re: The Beer Parlour by delagasky(m): 5:09pm On Feb 11, 2010
@bennygee,
Service girls?? i hear u, o ni bara e ti nba ole bo!!!

@adolf,
i go collect the slap and go back to her friend sharp sharp!! cheesy cheesy
Re: The Beer Parlour by Nobody: 5:20pm On Feb 11, 2010
Hahaha
correct guy i like u jor


kpolli wetin u go do?
Re: The Beer Parlour by hatch: 6:00pm On Feb 11, 2010
kpolli no fit answer you now abeg, LASMA be wan tow him motor
So still dey beg them make them no carry him and the motor go Alausa.
Re: The Beer Parlour by Nobody: 7:07pm On Feb 11, 2010
@ adolf,as long as the new babe gel wit u,make u brush am wella then go beg ur babe later so that d slap no go be for nothin.e good as lastma don carry kpolli subaru go.that car don do plenty change of ownership.na who go giv me beer?dela,abi u go take over briefly.as kpolli dey wit goodluck yestday maybe dem go dash am motor from government house
Re: The Beer Parlour by daylae(m): 7:13pm On Feb 11, 2010
@delagasky na here u still dey? Saw ur wife looking for u all about.
Re: The Beer Parlour by Nobody: 9:40pm On Feb 11, 2010
Make una tell kpolli to put LCD screen for here so we can watch EPL and i need another beer for the road.i don try for today.after 7 bottles and two plates of pepsoup.make i go play wit chinenye
Re: The Beer Parlour by kpolli(m): 10:32pm On Feb 11, 2010
abeg my brodas no vex,
i sharply go unilag block delagbasky niece, but if u see the mad hold-up for there, chai, we no get time reach hotel again, as my car dey tinted, we used the back seat for sharp sharp one,
delagbasky worse part is i didnt collect her name n number, abeg help me tell her to txt it to me, i enjoyed it,
as for the new waitresses, i don hear mama-gee, THE AMAKA,platimunk,ujujoan,abekeade,thoniaslim,ebonyeyes,ayettymama,sexybabes,even aunty iice n lastly i paid pounds just to get gabry,
so by 2mao, u will have new sexy, skimpy clothed waitresses n for extra box, they can, u know
Re: The Beer Parlour by daylae(m): 10:36pm On Feb 11, 2010
U won turn this beer parlour to another thing be that o!
Re: The Beer Parlour by kpolli(m): 10:37pm On Feb 11, 2010
when all this clubs dey try still my customers
Re: The Beer Parlour by ToToChoper: 10:49pm On Feb 11, 2010
Mak i run comot hia b4 dis ya waitresses wey dey chop hard currency as oppose to HARD D*CK go wak me dry.
Re: The Beer Parlour by daylae(m): 11:13pm On Feb 11, 2010
I beg make i dey go house before that my ugly wife lock door and swallow key.@kpolli i beg go repair una generator before i come hear early 2moro morning o!
Re: The Beer Parlour by Nobody: 11:26pm On Feb 11, 2010
So make we dey expect waitresses hun?
Nice

but abeg no bring Michelin come o
becuz she go scatter hia

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (35) (Reply)

Whatsapp And Imo Sex Group / How To Toast A Girl You See Walking On The Street. / The Wooing Challenge Season Vii - Ladies Pick Your Men!!!

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 34
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.