Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,283 members, 7,807,948 topics. Date: Wednesday, 24 April 2024 at 11:46 PM

10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) - Travel (4) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Travel / 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) (78864 Views)

Coldest States In Nigeria / 12 Beautiful Resorts In Nigeria Where You Can Enjoy Your Honeymoon / 10 Cities In Nigeria Where Pidgin English Is Most Spoken (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (13) (Reply) (Go Down)

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by erico2k2(m): 4:11pm On Jul 20, 2018
Lilimax:

My brother, I tire jare but who the language epp?
Edey epp us like dis ohh, wen u speak am for some area dem dey confuse dey look yu with one kine eye

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Karrisleo(m): 4:12pm On Jul 20, 2018
Area!!! High spirit for una ooo, e non get as e de be ehnnn, pidgen na d highest for 9ja. We go soon colonize those Africa countries dem

1 Like 1 Share

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Warripikin08(m): 4:13pm On Jul 20, 2018
And na because of pidgin na make dem won flog us die for school that year. We nor dey value our thing at all. I'm proud to be a deltan.

4 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Amberon11: 4:13pm On Jul 20, 2018
You no see say Delta State na number
1?
wink2015:


THIS YOUR BASKETMOUTH NOR GET RIVAL

YOU JUST DEY DROP AM AS HE DEY HOT!

You try Wella !

But Delta state for be number 1 for your list!

Why now?

You nor know say "DELTA STATE NO DEY CARRY LAST"

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Caseless: 4:13pm On Jul 20, 2018
ALKARULEZZ:
10. ABUJA
Based on based ehn, dis na d capital of Naija as all of ona know. The softness wey dey ooze for this coast na highest for the full country. The softness don real attract crowd from different holes come assemble for this arena.. The crowd nor get choice but to settle for pidgin make adagba nor for hang bulb-wire in the long-run.

9. ANAMBRA
Still on still ehn, this state still get small levo unto the pidgin spirit based on say na jur river share am from the capital of Delta state.. dat na wetin white men dey call "clash of culture"..

8. KOGI
O Bob! This state nor suppose sight road enter this list sha.. but still on the clash of culture things, most strong men here dey ball in Edo state steady unto one or two tiings based on say places like Auchi, Okpella etc nor too give Kogi state yard..

7. CROSS RIVER
Calabar people sha.. Their pidgin dey sound like Chinese dat year sha, but some kind Urhobo boys don hustle enter there come give their girls belleh finish.. this belleh-giving nai make new generation calabar children dey tear pidgin like Sapele agbero these days.. Pikin must resemble papa unto one or two tinz na.

6. LAGOS
Ma first hail some kind lost souls for this yard before I fire down.. Men like RMD, Basorge-Tariah, Ali Baba and other staunch wey abandon us go that way.. I jur like let ona know say nor be so o.. Cow wey smart go America go come back as cornbeef one day sha..
Still on still ehn, this state kari-get population from different parts of the country.. But we all know say dia pidgin melting pot dey Ajegunle where Area borku yakata.. Still on the hustle, AJ boys turn musicians o.. all we slangs for Area na dem pack full dia music.....and ona know say music dey kari-spread.. slangs spread so tey market women dey chew dem like gum based on say nor be everybody fit speak Yoruba na.. so d pidgin jur serve as dia lingua franca for dah way.... example of dose slangs wey dem thief na "Who You Help" wey Olamide thief from Shuun Bebe...

5. AKWA-IBOM
No doubt, militants don teach these people pidgin finish based on the oyel tinz.. dem try!


Down to the big four

4. RIVERS
This na one gallant South-South state wey jur gather people from different tribes like Tower of Babel.. Oil industries borku for this state and even omormor know say business must full anywhere oil industries gallant put. These people of different tribes based on say dem nor get unified language come dive pidgin make quarrel for nor too dey sup unto business tidings.

3. BAYELSA
Ijaw full this state nor be small.. Naturally their lingua franca suppose be Ijaw, but based on say d state near Delta anyhow, dem jur gat copy dia elder brother (Delta) main language make e for nor loss..

2. EDO
Oba a to pe'e.. Before 1991, this state dey conjoined with Delta state.. dem regard dem as one den (Bendel).. This state nor be number one for this list based on say some kind villages there near Yoruba states like Ondo and Ekiti.... This kari-near don weaken dia pigin anyhow.. na jur Benin come get level unto the lingua..

1. DELTA
Area!! 12 Kpokos for all the Nairaland Waffarians.. Any Effurun pesin here? Abeg signify make men observe ur kpai number..
Dem nor dey drag seat with Oba o..... The full state gallant for d pidgin level sha.. from Warri/Effurun to Sapele, Ughelli, Abraka, Oghara, Osubi, Asaba, Agbarho etc.. Area! ona too much abeg.. I throw backy give all of ona. Dem say overfamiliarity nai nor dey make man chop house rat..

Fly go gather any kporkpise wey like smart for this thread..

you're a comedian grin grin

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Mystiquefia: 4:14pm On Jul 20, 2018
SoapQueen:
Team PTI Road
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Rumobaba: 4:14pm On Jul 20, 2018
Na only warri/udu road and environs pigin de, all of una na Kpalasa.

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Caseless: 4:15pm On Jul 20, 2018
star:
you never hear ogoja people speak am before abi..
dem sef hol pidgin like that? grin

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by BrownRoofRep: 4:17pm On Jul 20, 2018
Pidgin English in Anambra? Op please quit smoking!

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by pinkguy(m): 4:17pm On Jul 20, 2018
Lol as correct waffi guy way base for abj anytime I enter area. Especially jakpa and enire junction I dey expect may road the call my name because I spent most of. My life the walker pass there
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by SUNDICOS(m): 4:17pm On Jul 20, 2018
HajimeSaito:
I thought only pigeons speak pidgin english...




[img]https://media1./images/75f1a082d67bcd34cc4960131e905bed/tenor.gif?itemid=5505046[/img]
hahahahahaha,mad man, I love this

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Rumobaba: 4:18pm On Jul 20, 2018
Koalas
ALKARULEZZ:


lol bros.. ur langua na highest o grin
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Rumobaba: 4:18pm On Jul 20, 2018
Koalas
Rumobaba:
Koalas
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Karrisleo(m): 4:19pm On Jul 20, 2018
High spirit for the Edo niggy for the trend O, unto eriga tongue! A trip to the south, sorry say e late, e go come out wait
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by SUNDICOS(m): 4:20pm On Jul 20, 2018
I wonder what pigeon go dey talk within themselves based on how men come borrow their language .

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by UNIBENDON: 4:22pm On Jul 20, 2018
No be by power dem take dey stand prick!

Pidgin na correct language(who no go no know)

Hausa,Ibo and Yoruba states na obote for Pidgin language.

Middle belt states like Plateau and Benue dey try for the Pidgin talk.

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Niyinficient(m): 4:22pm On Jul 20, 2018
OP..Which kain legbere top 10 list be this one na? wetin Kogi and Abuja dey find for that list? Even Jos and Benue still sabi yarn pidgin pass these places wey u mention so o, as you just kari-comot Ondo and Ekiti for the matter so, u no jst try at all. You bin forget say Ondo and Ekiti bin near that region weh weh, and plenty Delta N Edo pple been yapa wella for these states dem..dey sef dey show their own agbakara for the pidgin level so o! grin grin grin

Make dem do quick make pidgin our official yarning for Naija o, we go quick dey feel our self kia kia, no be all this serenren english wey pesin dey yarn upandan.

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by BrownRoofRep: 4:23pm On Jul 20, 2018
erico2k2:

Those people dey speak pidgin like say mopol dey thier front .
Certainly, you've not been to Anambra State.
Pidgin English is very minimal in every part, ie, including Onitsha.

3 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by warriking(m): 4:23pm On Jul 20, 2018
ALKARULEZZ:
10. ABUJA
Based on based ehn, dis na d capital of Naija as all of ona know. The softness wey dey ooze for this coast na highest for the full country. The softness don real attract crowd from different holes come assemble for this arena.. The crowd nor get choice but to settle for pidgin make adagba nor for hang bulb-wire in the long-run.

9. ANAMBRA
Still on still ehn, this state still get small levo unto the pidgin spirit based on say na jur river share am from the capital of Delta state.. dat na wetin white men dey call "clash of culture"..

8. KOGI
O Bob! This state nor suppose sight road enter this list sha.. but still on the clash of culture things, most strong men here dey ball in Edo state steady unto one or two tiings based on say places like Auchi, Okpella etc nor too give Kogi state yard..

7. CROSS RIVER
Calabar people sha.. Their pidgin dey sound like Chinese dat year sha, but some kind Urhobo boys don hustle enter there come give their girls belleh finish.. this belleh-giving nai make new generation calabar children dey tear pidgin like Sapele agbero these days.. Pikin must resemble papa unto one or two tinz na.

6. LAGOS
Ma first hail some kind lost souls for this yard before I fire down.. Men like RMD, Basorge-Tariah, Ali Baba and other staunch wey abandon us go that way.. I jur like let ona know say nor be so o.. Cow wey smart go America go come back as cornbeef one day sha..
Still on still ehn, this state kari-get population from different parts of the country.. But we all know say dia pidgin melting pot dey Ajegunle where Area borku yakata.. Still on the hustle, AJ boys turn musicians o.. all we slangs for Area na dem pack full dia music.....and ona know say music dey kari-spread.. slangs spread so tey market women dey chew dem like gum based on say nor be everybody fit speak Yoruba na.. so d pidgin jur serve as dia lingua franca for dah way.... example of dose slangs wey dem thief na "Who You Help" wey Olamide thief from Shuun Bebe...

5. AKWA-IBOM
No doubt, militants don teach these people pidgin finish based on the oyel tinz.. dem try!


Down to the big four

4. RIVERS
This na one gallant South-South state wey jur gather people from different tribes like Tower of Babel.. Oil industries borku for this state and even omormor know say business must full anywhere oil industries gallant put. These people of different tribes based on say dem nor get unified language come dive pidgin make quarrel for nor too dey sup unto business tidings.

3. BAYELSA
Ijaw full this state nor be small.. Naturally their lingua franca suppose be Ijaw, but based on say d state near Delta anyhow, dem jur gat copy dia elder brother (Delta) main language make e for nor loss..

2. EDO
Oba a to pe'e.. Before 1991, this state dey conjoined with Delta state.. dem regard dem as one den (Bendel).. This state nor be number one for this list based on say some kind villages there near Yoruba states like Ondo and Ekiti.... This kari-near don weaken dia pigin anyhow.. na jur Benin come get level unto the lingua..

1. DELTA
Area!! 12 Kpokos for all the Nairaland Waffarians.. Any Effurun pesin here? Abeg signify make men observe ur kpai number..
Dem nor dey drag seat with Oba o..... The full state gallant for d pidgin level sha.. from Warri/Effurun to Sapele, Ughelli, Abraka, Oghara, Osubi, Asaba, Agbarho etc.. Area! ona too much abeg.. I throw backy give all of ona. Dem say overfamiliarity nai nor dey make man chop house rat..

Fly go gather any kporkpise wey like smart for this thread..

ONIOVO UR TEETH CLEAN
DEM NO REACH!
DEM LEFT EYE WELL WELL

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by ClintonNzedimma(m): 4:24pm On Jul 20, 2018
mimimile93:

if Warri no top this ur list u for serve ban for straight 3months.
I am a mod. U know?

I no from Delta but I be Warri boy.
I rep Ekpan I rep Jakpa I rep PTI I rep Warri South I rep Uvwie.

Na we get pigin

Areaaaaa!!!!!
Warri!!! Their Daddy. Omo boy, your head get small grease

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by 1Sharon(f): 4:24pm On Jul 20, 2018
Let me further add and rock the boat even more:

Certain ethnic groups in Nigeria are noticing and worrying that their language is going extinct. Why won't this happen when you shun ur language and favour pidgin English?
You want to laugh at Yorubas but they are having the last laugh. Because at the end of the day their language is intact

That list up there is shameful!
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by justtoodark: 4:25pm On Jul 20, 2018
Olukat:
Any other state in Nigeria speaks native dialects shocked

we are too diverse to concentrate on our tribal tongues...we wouldnt understand each other....disaster....

i dont speak urhobo that well sef no more...i only remember curse sentencies....

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Amberon11: 4:25pm On Jul 20, 2018
They write their language in English alphabets. Or do they have their own lettering system? The only Africans I give props to whenever such issue is raised are Ethiopians because they have their alphabet.
1Sharon:


Write their language in English? ..what

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Orodje(m): 4:25pm On Jul 20, 2018
Acidosis:





Lol, you can't drag that number 1 spot with Delta (especially Warri, Abraka and Sapele). grin

na the koko yarn be that cool

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by 1Sharon(f): 4:27pm On Jul 20, 2018
Amberon11:
They write their language in English alphabets. Or do they have their own lettering system? The only Africans I give props to whenever such issue is raised are Ethiopians because they have their alphabet.

Ok you right about that. But those letters are not English they come from latin

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by saintruky(m): 4:27pm On Jul 20, 2018
Bobby na real matter u lopside so oo.. Op anambra no follow for local..

fratermathy:
Akwa Ibom nor follow at all for this matter. Na only Ibibio and good English dem dey yarn here. Dey nor sabi catapult pidgin at all. Even the small ones wey open eye for the matter sef nor sabi am wella. Their pidgin dey sound like good English mixed with Ibibio.

As for Anambra, na Igbo dey reign for there. Pidgin nor too follow. Na only for Onitsha dem dey speak small pidgin based on Asaba influence and based on say strangers boku for there. So Onitsha nor too follow up. Even Asaba sef, na Waffarians dey spoil that town. Normally, na Igbo dem dey yarn but Waffi boys don change am follow them. Some Asaba people don even get Warri tongue now sef.

For Bayelsa matter ehn, Yenagoa na correct pidgin area. The people wey get the town na Epie/Atissa dem dey speak normally but Izon people and Ogbia people plenty for the cabal so na pidgin naim dem take dey control their matters for there.

Lalasticlala and Seun, how una see this thread na? E nor suppose to loss like that. Make dem reason the matter na.
Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by mattyrukee(m): 4:28pm On Jul 20, 2018
Correct brah..mk dem clear road for u

We dey wee yu base on say we no dey carry last

Warri pikin na we b dis

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Sinistami(m): 4:28pm On Jul 20, 2018
Es weh Yu fratermathy Omo guy see am ai jus reason say make ai jus comment before ai go come back thread Don gallant. Today na I believe seh miracle De hapun this thread weh bin cast before.

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by gonkin(m): 4:32pm On Jul 20, 2018
Yes ooo na we we. Big heart

From WARRI to SAPELE, TO JESSE na we be pidgin. Na we dey load am.
A land when there are so many natural comedians not trying to be funny. Sia gware!

1 Like 1 Share

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by bestview: 4:32pm On Jul 20, 2018
These are actually the top 10 most cosmopolitan states. The rest of Nigeria are predominantly indigenes.

2 Likes

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by BossKingRex(m): 4:32pm On Jul 20, 2018
ALKARULEZZ:
10. ABUJA
Based on based ehn, dis na d capital of Naija as all of ona know. The softness wey dey ooze for this coast na highest for the full country. The softness don real attract crowd from different holes come assemble for this arena.. The crowd nor get choice but to settle for pidgin make adagba nor for hang bulb-wire in the long-run.

9. ANAMBRA
Still on still ehn, this state still get small levo unto the pidgin spirit based on say na jur river share am from the capital of Delta state.. dat na wetin white men dey call "clash of culture"..

8. KOGI
O Bob! This state nor suppose sight road enter this list sha.. but still on the clash of culture things, most strong men here dey ball in Edo state steady unto one or two tiings based on say places like Auchi, Okpella etc nor too give Kogi state yard..

7. CROSS RIVER
Calabar people sha.. Their pidgin dey sound like Chinese dat year sha, but some kind Urhobo boys don hustle enter there come give their girls belleh finish.. this belleh-giving nai make new generation calabar children dey tear pidgin like Sapele agbero these days.. Pikin must resemble papa unto one or two tinz na.

6. LAGOS
Ma first hail some kind lost souls for this yard before I fire down.. Men like RMD, Basorge-Tariah, Ali Baba and other staunch wey abandon us go that way.. I jur like let ona know say nor be so o.. Cow wey smart go America go come back as cornbeef one day sha..
Still on still ehn, this state kari-get population from different parts of the country.. But we all know say dia pidgin melting pot dey Ajegunle where Area borku yakata.. Still on the hustle, AJ boys turn musicians o.. all we slangs for Area na dem pack full dia music.....and ona know say music dey kari-spread.. slangs spread so tey market women dey chew dem like gum based on say nor be everybody fit speak Yoruba na.. so d pidgin jur serve as dia lingua franca for dah way.... example of dose slangs wey dem thief na "Who You Help" wey Olamide thief from Shuun Bebe...

5. AKWA-IBOM
No doubt, militants don teach these people pidgin finish based on the oyel tinz.. dem try!


Down to the big four

4. RIVERS
This na one gallant South-South state wey jur gather people from different tribes like Tower of Babel.. Oil industries borku for this state and even omormor know say business must full anywhere oil industries gallant put. These people of different tribes based on say dem nor get unified language come dive pidgin make quarrel for nor too dey sup unto business tidings.

3. BAYELSA
Ijaw full this state nor be small.. Naturally their lingua franca suppose be Ijaw, but based on say d state near Delta anyhow, dem jur gat copy dia elder brother (Delta) main language make e for nor loss..

2. EDO
Oba a to pe'e.. Before 1991, this state dey conjoined with Delta state.. dem regard dem as one den (Bendel).. This state nor be number one for this list based on say some kind villages there near Yoruba states like Ondo and Ekiti.... This kari-near don weaken dia pigin anyhow.. na jur Benin come get level unto the lingua..

1. DELTA
Area!! 12 Kpokos for all the Nairaland Waffarians.. Any Effurun pesin here? Abeg signify make men observe ur kpai number..
Dem nor dey drag seat with Oba o..... The full state gallant for d pidgin level sha.. from Warri/Effurun to Sapele, Ughelli, Abraka, Oghara, Osubi, Asaba, Agbarho etc.. Area! ona too much abeg.. I throw backy give all of ona. Dem say overfamiliarity nai nor dey make man chop house rat..

Fly go gather any kporkpise wey like smart for this thread..


Areaaaaaaaaa!!! U na koreect bros! Me na piur wafi!! Dia fada!! grin grin

1 Like

Re: 10 States In Nigeria Where Pidgin-English Is Most Spoken (written In Pidgin) by Sinistami(m): 4:34pm On Jul 20, 2018
1Sharon:
Let me further add and rock the boat even more:

Certain ethnic groups in Nigeria are noticing and worrying that their language is going exist. Why won't this happen when you shun ur language and favour pidgin English?


You want to laugh at Yorubas but they are having the last laugh. Because at the end of the day their language is intact

That list up there is shameful!


Weh Yu Wu e epp. Well come if you are Yoruba You and I should exchange life come and experience the south were every mile is a different language if you do not loose your language then I'll eat my head up. Shey you de hear me so!?

2 Likes 1 Share

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (13) (Reply)

Professor Pius Adesanmi Dies In Ethiopia Airlines Plane Crash - John O. Oba / Akwa Ibom And Europe Standard Of Road Na 5&6 .. Photos / Living In The USA - Life Of An Immigrant Part 1

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 67
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.