Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,184 members, 7,807,611 topics. Date: Wednesday, 24 April 2024 at 04:10 PM

Agony Of A School Boy - Jobs/Vacancies - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Jobs/Vacancies / Agony Of A School Boy (462 Views)

Female Admin Urgently Needed In A School / Agony Of A Frustrated Graduate / Agony Of An Emotionally Disturbed Jobless Graduate. Advice Needed. (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Agony Of A School Boy by professorchuks(m): 8:54pm On Jul 02, 2017
This my neighbours in my compound have been intimidating me with their yeye I beta pass my neighbour gen... Dem even make me understand say na because of me dem buy d gen; dis people scrape d YAMAHA wen dey d gen comot cum go write "EHYA CHUKS" put. Atimes if dem on d gen eh, e go be like say na my window dem drop am... Gen wey dey sound like say na dog dey bark... At times e go sound like say dem dey grind cassava ontop my bed.. Shey because i dnt av gen abi? Ok nepa go bring light but dis pple go dey form NNPC chairmen... I can't continue like dis na, i'm gradually going deaf o.. I no dey even here wen i dey talk to myself again sef... My landlord na goat, instead of am to try pursue dis Kwale boys, d guy dey busy dey quarrel dey ask who use washing water flush toilet... So i made up my mind to take my revenge on dis Kwale pple..... Dis mumu pple knw say dem no fit hear visitors shout once dem don on dat mumu gen enter inside lock door... So dey mounted a doorbell.. Smart me, i started peppering deir life by presin d doorbell foolishly and running away to hide b4 dem go cum out... I toment dem tire eh, even me cum dey feel bad for dem... Dis morning i saw one of dem fixing d doorbell.. I didn't recall wen it spoilt but e no concern me afterall... Bros has finished and gone inside to meet his compatriot, d spirit has come upon me to go press d doorbell as usual.. I went and beeeeep!! Bros no be small shock d tin shock me o.. I landed in front of my landlord's pavement.. His useless 22yrs old son wey me and am dey follow peep people wey dey baf cum carry him short-short yam legs cum dey ask me weda show dey for us to watch today ? U knw d kind of show na... I hurriedly said yes, buh he must help me press Odume dem doorbell b4 i go give am viewing space... See as d goat take speed dey locate Odume dem doorbell... Call me wicked, buh i can't suffer alone.. Ah ah, wat is keeping him from getting his own shock ? Ohhh... D idiot is a bloody dwarf.. I must make sure he get his own shock o.. See d idiot jumping so he go fit press d doorbell.. Ewu, wait make i help u jor.. Oya climb my shoulder make ur hand reach am... He pushed d button and datz all i could remember.. Wat exactly am i doing in U.B.T.H with my two legs hanging up Nd drip in all my body is still a mystery to me.. D doctor only said "he'll come bak to normal wit tym, he's lucky it wasn't him dat pressed d doorbell" and im like Omg!! Wat has happened to Iweanya

(1) (Reply)

Need A Job Am Experienced In Customer Service Pls Help / Apply Now For The Country Coordinating Mechanism Recruitment 2017 / Legal Intern At Discovery Cycle Professionals (DCP)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 19
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.