Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,149,914 members, 7,806,656 topics. Date: Tuesday, 23 April 2024 at 07:58 PM

Save Nigeria Democracy, Gov Wike Ginger Lawyers - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Save Nigeria Democracy, Gov Wike Ginger Lawyers (388 Views)

Nigerians Are Ready To Spill Their Last Blood To Defend Democracy - Gov Ortom / Amina Zakari: INEC Putting Nigeria’s Democracy Under Threat – Ohanaeze President / Hon. Independence Ogunewe: Incalculable Loss To Nigeria's Democracy And Imolites (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Save Nigeria Democracy, Gov Wike Ginger Lawyers by sluvy4tune(m): 5:50pm On Aug 08, 2017
Rivers state Governor , Nyesom Wike don ginger African Lawyers make dem works on how to revive democracy for Nigeria, Him yarn say the All Progressive Congress (APC) don use police scatter the foundation wey dem been take build democracy ontop.

Governor yarn say the APC don even start to dey make plans to rig 2019 General Elections as dem don promote police officers wey don get gbege already.

Governor Wike give dis ginger as him bee meet with members of African Bar Association for inside Government House Port Harcourt on Monday night, Governor Wike yarn say the Police High Command don promote Akin Fakorede, the Rivers State Special Anti-Robbery Squad (SARS) Commander wey dem been film when him been dey rig election , even beat up INEC officials for inside collation centre.

The Governor still talk say, the Police High Command still come promote Assistant Commissioner o Police, Steven Hasso for how him take rig rerun election on december 10 2016.

The Governor yarn say dem been pr0omise Nigerians Chnage , but we no dey see anything, the former President for Tanzania as him waka come see us don do plenty better for Nigeria, through him we go send message give the whole world.

Democracy for Nigeria no dey again, for 2019 nobody fit dey talk about democracy again. One Mr. Akin Fakorede wey dem catch for video dey rig election don get promotion, Stephen Hasso, wey follow rig election dem don promote am , Na 2 of dem , dem don position for inside Rivers State for 2019 make dem help APC rig elections.





Still dey yarn on the matter, Governor Wike talk say the APC don make am dia plan to put fear fear inside judiciary, so dem fit carryon without all the yeye things dem dey do, and dem no go send wetin rule of law talk.

Him regret say d matter don spoil go far, to the level wey be sey, the police people don carry over the work wey INEC suppose dey do, na police dey do election result give APC wey dem dey use for Tribunal.

Oga Wike still yarn say the police as dem dey now don turn to major thing wey dey block investment for the country as na police be the major insecurity wey we get.

Na Police people dey promote crime for Nigeria, Almost all the kidnapping wey dey happen for the country , na police people dey do am, we no fit continue like dis, e don do.

Before Before Presidoo for Nigerian Bar Association , Chief Onueze Okocha, yarn say Rivers State dey peaceful and e dey ready for investors.





Oga Attorney General for the State and Commissioner wey dey untop Justice matter, Emmanuel Aguma (SAN) don hail Governor Wike for Justice sector and how him take dey promote access to Justice

Rivers State Attorney General and Commissioner of Justice, Emmanuel Aguma (SAN) lauded Governor Wike for justice sector reforms and the promotion of access to justice.



Source:

Simeon Nwakaudu,
Special Assistant to the Rivers State Governor, Electronic Media.
8th August, 2017.

http://newsinpidgin.ng/save-nigeria-democracy-gov-wike-ginger-lawyers/
Re: Save Nigeria Democracy, Gov Wike Ginger Lawyers by Flexherbal(m): 5:58pm On Aug 08, 2017
Is there justice in Nigeria?

(1) (Reply)

Attempted Assassination Of Buhari In Kaduna Has To Do 40yrs Kaduna Crisis / Women Protesting At Shell Facility In Niger Delta(video) / I Go Like Enter Heaven – Obasanjo

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 16
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.