Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,562 members, 7,809,054 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 09:57 PM

Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi - Literature (28) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi (315450 Views)

Life Of A Rugged Guy +21 / Naija Yahoo Life(get Rich And Die Young, Pidgin EDITION) By Youngzubi / I Fit Be Second Jesus(sex Na Food 2)the Return Of Spana By Youngzubi (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (25) (26) (27) (28) (29) (30) (31) ... (51) (Reply) (Go Down)

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Artzdanielsz(m): 1:58pm On Aug 18, 2018
Awesome, magnificent it is getting more interesting
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by princesavo(m): 3:04pm On Aug 18, 2018
youngzubi you sabi die.. like say i be Otedola, i for give u cuppy to marry.. abeg make una vote Youngzubi jareh
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by pradoic(m): 3:46pm On Aug 18, 2018
lie lie!;Stevo nor fit die,abeg zubi drop something sharp sharp
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Phenotech(m): 7:35pm On Aug 18, 2018
Stevo must not die oooooooo! YoungZubi please update sharpally
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Ann2012(f): 7:39pm On Aug 18, 2018
Stevo!!!! No die oooo embarassed
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Damibiz(m): 7:40pm On Aug 18, 2018
My hitman cant die,e no go happen
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by mohiozua(m): 7:48pm On Aug 18, 2018
Nice story so far.
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Dpleaser: 8:30pm On Aug 18, 2018
Nice piece, this looks like american-pidgin story cos all these action u guys dey pull no dey happen for Nigeria. Good n funny story we get here.
More ink to ur pen bro
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 8:53pm On Aug 18, 2018
..

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 8:55pm On Aug 18, 2018
.

2 Likes

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by rowdymind(m): 9:09pm On Aug 18, 2018
You Dun Remove Spana Teeth No Just Try Kill Stevo O, That Guy Na True Frnd And Im Death Go Jus Buss Ma Dada.
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by donaldphilipizu(m): 11:20pm On Aug 18, 2018
action film,spana weldon
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by stevodot22(m): 8:39am On Aug 19, 2018
I'm back fully now! Make I cum sama u my vote now for August writer.
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 4:27pm On Aug 19, 2018
Episode..........38



mission go wrong
---------------------------
Stevo Stevo Stevo how many times i call u?
------------------------------------------------------




like film,just like African magic,i stand dey watch as Stevo take close eyes,E just be like dream,only if e fit be dream i for don jab up tey! tey! begin fire prayer to cancel am and if nah film i for don go change over, asin i nor even want light talkless of watching the film again,but since nah reality i go do anything within my power to ensure dat Stevo the sniper king no die!!

-------------------------------



still inside the forest,i just confuse on watin i go do,i just confuse becos Stevo nor fit waka,him nor fit stand up so dat we go shake hand hug ourselves and yan "mission accomplished"just like we always do each time we complete our mission

i dey confuse becos oga frank wife nor fit stand,she no fit waka on her own to the main road,how i go take carry this two people,who i go carry and who i go leave,what if i leave one and go with one then come back only to find the one i left missing,all this thought just dey give me heavy headache as confusion begin build estate ontop my head,i still dey try reason the best option when i begin hear sound,e dey sound like say peson dey waka inside the bush so i quickly drop Stevo head for ground,bring out my pistol then dive inside the bush nah dia i bend down dey look make the peson com out,with my gun well positioned nahim one woman burst out from the bush,i recognized her instanta


i begin watch as the woman turn confuse,nobi about dead body wey dey ground but becos of the place wey she burst out,she think say nah main road be that not knowing dat she bin dey waka in circle inside the bush,nah wia she from begin run she still burst out again


"stop dia!!,i shout as the woman won begin run again


she freeze and jejely she begin turn her neck to see who get the voice,as she turn come sight me with the gun wey i dey point for her head,sharpaly she kneel down

"abeg nor kill me,she begin yan


"shebi nah me save u before,i yan

she look me well then begin recognise me


"wia the other lady dey?,she yan


"nah now you go ask abi,but you just tear race like made woman begin run wen i free you from that rope,you nor even look back to yan thank you,nah run u just dey run,i para for the woman



"abeg nor vex sir,see i no know who be who so as una free me nah road to the express i begin find only to waka all the waka wey i waka and still come back here,she yan


"see i nor just get time for rubbish talk,if u mess up i nor go delay at all!! nah to scatter ya head with bullet,so obey anything wey i talk without dulling you dey hear me so!!!!!,i shout


"ye! yes! yes!,she begin shake with fear


"good,oya enter that place go carry the other woman she dey inside the bush




i look as the woman drag oga frank wife comot from the bush,she begin struggle to carry her,so i drop Stevo with everything wey i don carry for ground waka go lift oga frank wife put for her back then waka come carry Stevo with other weapons as i begin find road go express



few minutes later,we finally burst out for express,we trek go wia i park golden dragon,immediately we reach the place i unlock the moto as we put Stevo for seat then drop oga frank wife beside him




"oya enter front make we dey go,i yan


but the woman kneel down sharpaly begin beg me say make i leave her to find her own way,nahim i reason am say since i nor get anything to do with her so i just kukuma enter moto shuk head enter express, reverse and enter speed wey be say steering just free for my hand like say nah hand fan



i begin reason watin go be my next move,nah hospital straight at least make dem begin receive treatment before i call others and reason dem watin dey ground,no! no! no! hospital nor go gree treat Stevo onto say nah bullets dey him body,Chai! watin i go do

iffa say make i go police station go collect em! Chai i don forget watin dem dey call dat tin,no need dat one nobi option at all!!


i grab my phone sharpaly as one better idea struck me,i quickly dial spata number



"hello!,you nor see my miss calls,we dey road dey fin una,spata yan as he pick for first ring


"guy Stevo


"watin do Stevo!,he yan as he nor even gree make i talk finish


"see guy Stevo dey quarter to hell as i dey follow u yan


"ah!! e better be lie spana,no nah lie!!, spata yan


"abeg no time for long tin,u know watin una go do now eh!, i yan still driving with high speed


"watin,wait which side una dey first,spata yan


"dat one no matter now,shebi una carry weapon?,i yan


"we complete nah,but dress,jazz and weapons dey with us,spata yan



"good,oya sharp sharp,make una go find any better hospital make sure una do am codedly, make nobody notice say nah kidnap una come do



"dat one nah chicken palava,spata yan

"good,so una go carry doctor and nurse,i yan



"how many, spata yan


"only one doctor and one nurse,tell dem say make dem carry tools and drugs wey dem go take treat person wey bullet hit,i yan


"ok till we meet for house,spata yan


"good till then;i yan then cut the phone onto say i need to focus




3hrs later i drive enter one junction like dat nahim i sight some people for front,dem dress in black with touch light for dia hand,as i near dem nahim i notice say nah police

i for just drive pass but dem use pkako with plenty other obstacle block road,i jam leg for brake immediately i reach there as all of dem cork their gun come position dem sef well,their oga waka come front with pistol for him hand

he jam knock twice for my moto window say make i come down,with vex onto say dem dey delay me i comot all my tops as my chest just stand gidigba!,with force i push the moto door and step outside


"Mr man watin you carry and why you nor wear clothe for body,the oga police yan


"make una comot dat rubbish for road make i pass!,i yan


"you dey craze!!,you dey mad!!,oya come open ya boot,you never see delay sef,i go teach you lesson today,the oga police yan with vex


"i shuk head enter moto as i drag one ak 47 come out

ta! to! tata! tuluu!! all this nah the toy noise wey their yeye gun just dey make as dem begin shoot me

"gigigim!!,i scatter one police head with my ak 47,like say nah curse all of dem tear race except for their oga wey i nor gree make him run,i grab him belt as i kick him leg comot for ground nahim the man fly up nack head for ground as him begin drop piss for body



"oya! waka go comot those rubbish make i pass,i shout as the police man stand up begin stagger go push the rubbish away, i shuk head enter moto fire dragon and zoom


1hr later i drive enter my street for festac as look time,5:14am i slow down till i reach gate,the gateman rush open gate sharpaly as i drive enter compound,i nor even wait to off the moto engine as i tear race go open door wia Stevo lay down
i begin drag him outside sharp sharp,naso the idiot begin laugh ,him stand up begin stagger dey laff

"Chai naso you like me reach bro,Stevo yan as my guys rush outside

"so nah pretending u just dey do since,i yan


"nobi so guy,dem hit me jazz bullet but i recover 15mins later i for stand up but my body just weak,so i say make i just relax after all you be boss,Stevo yan


spana you sure say u well,nobi Stevo be this?,simple yan

"guy you nor do well,ah ah! see as i just dey sweat since,o boy nah Bleep up o!, i yan as i go carry oga frank wife outside begin enter house


as i enter parlour,i sight one doctor with nurse,dem sidon for chair with one big box wey dey floor




after we don threaten and negotiate with the doctor dem,they begin treat oga frank wife and Stevo


"after removing all the bullets wey enter Stevo body,the doctor come yan say oga frank wife go follow dem go hospital for proper treatment onto say she don lose plenty blood,naso i transfer some money enter the hospital account as spata take him moto drive both the doctor,nurse and oga frank wife go hospital,omo nobi small thing o!



to be continued

7 Likes 2 Shares

Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by rowdymind(m): 4:44pm On Aug 19, 2018
Thank God Sey Stevo Nor Delete. Nice One Boss, More Ink!!!
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by emperorblog(m): 4:47pm On Aug 19, 2018
waw great story bro more ink to yoyr pen

more wisdom to ya brain



goan post d story on okadabook atleas


www.emperorblog.com.ng
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by JOGICE(m): 5:06pm On Aug 19, 2018
👍🏽
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Nobody: 6:10pm On Aug 19, 2018
em Be like sey u mixed this story with weed em the high me
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Damibiz(m): 6:53pm On Aug 19, 2018
Stevo no well oh...,....that man no fit die,he is unkilleable
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Nobody: 8:21pm On Aug 19, 2018
Youngzubi just dey fire dey go like gold dragon, officer mufu no fit stop una badoo
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 8:59pm On Aug 19, 2018
emperorblog:
waw great story bro more ink to yoyr pen

more wisdom to ya brain



goan post d story on okadabook atleas


www.emperorblog.com.ng
i will do daht buh lemme complete it first..
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by emperorblog(m): 9:24pm On Aug 19, 2018
Youngzubi:

i will do daht buh lemme complete it first..


dhat gud
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by pradoic(m): 9:55pm On Aug 19, 2018
wow!,tank gawd Stevo no die,good job @youngzubi,more ink to ur pen brosmiley
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Ann2012(f): 10:26pm On Aug 19, 2018
Stevo no die oooo!!!
Thanks Youngzubi
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by swiz123(m): 10:48pm On Aug 19, 2018
You didn't mention if the doctor and nurse were blindfolded oh
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 10:58pm On Aug 19, 2018
swiz123


o!,i thought that the threaten and negotiation would cover that area,i couldnt cool down to give much details on that part due to work so i just tried to summarize things up,....but"noted bro"
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Youngzubi(m): 11:03pm On Aug 19, 2018
Ann2012:
Stevo no die oooo!!! Thanks Youngzubi

grin am gonna shoot you -------------»»»»»
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by Ann2012(f): 11:08pm On Aug 19, 2018
Me sef get Odeshi cool

Youngzubi:



grin am gonna shoot you -------------»»»»»
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by tomgab(m): 5:37am On Aug 20, 2018
How stevo go die? The guy na mission brain box na.

Keep it up jare youngzubi. I be get interview this morning but I no fit focus until I read the update
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by stevodot22(m): 7:54am On Aug 20, 2018
Stevo the sniper... I cut cap for you unto say u be gallant soldier. Well-done YoungZubi.
Re: Sex Na Food (Pidgin Comedy Edition) Story Of A Rugged Guy By Youngzubi by astute28: 11:51am On Aug 20, 2018
nice one zubi i dey follow u bumper to bumper

(1) (2) (3) ... (25) (26) (27) (28) (29) (30) (31) ... (51) (Reply)

1985.... 1987.... 2014--[a Crime Story] / "Ocean Of Secrets" A Story By Millieademi / An Evening With Eva (2013 Triple Award Winner in Crime. Thriller. Action.)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 45
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.