Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,148,024 members, 7,799,499 topics. Date: Tuesday, 16 April 2024 at 10:43 PM

Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) - Literature (10) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) (61637 Views)

Water Strike- A Comedy (18+) / FRESH Toto(adventure Of Prick Master And Miss Young Toto? / Innocent Ilo Wins 2020 Commonwealth Short-story For African Region (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (7) (8) (9) (10) (11) (12) (13) ... (22) (Reply) (Go Down)

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Rosemary33: 4:39pm On Jan 23, 2019
okafor200:
See come all this ghost readers dem make do face like evangel F kennedy so,

na una type person make get pimples go see get hope,

una go read finish common to comment go hard una,

as una do yansh so like dry leaf,

abeg make una try dey comment for here na,
thats the only motivation i dey ever get to dey compose this stuffs for here so,

i need una comments not read and go like say e no consine you,

abeg na me dem dey call baba olowo,
all for the fun baba,

baba olowo
grin grin grin
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Tonyspecial(m): 10:48am On Jan 24, 2019
]good one baba
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 3:14pm On Jan 24, 2019
Episode 61
(a dedication to all my ghost readers dem)

hahahhaahahhahaa
oboy everybody burst laugh,
chaii so you mean say police people arrest Aikoriegie Solomon instead of you baba olowo abi?

Hahahahahahhahhahaha
naso i tell people,

imagine say dem carry Aikoriegie Solomon go prison go lock am there,

the next day surprise the police people their oga,

the oga confuse shout,
come o,
no be baba olowo we see arrest here yesterday?
Why i come dey see him new update episode 61 for online here na?

naso the oga say i know what to do,
but first make i first read this him new update first make i shine teeth laugh small abeg,

oboy the police their oga shout
hahahahahhahahahahahaha
i don die o,
chaiii baba olowo no go kill me with laugh ooooo,

i tell una say the oga laugh for 1 hour plus,

naso baba vex enter prison make dem lock Aikoriegie Solomon,

the oga shout,
see come you this guy,
upon say we lock you up for police cell here,

so you still get mind again to dey post all this your funny story dem online abi?

Oboy i tell una say the oga beat craze comot from Aikoriegie Solomon head,

chaiii see as dem use Aikoriegie Solomon take exchange am with baba olowo,
chaiii

oboy na later the police oga come find out say no be Aikoriegie Solomon nahim be the real baba olowo,

dem just use am take replace am there,
ahhhh the police oga shout,
am very happy say no be baba olowo this my people dem arrest carry come here so,

abeg who for dey make me dey catch fun dey laugh like madman online everyday as baba olowo?
Abeg make we leave that guy for cell there make him replace baba olowo abeg,

hahahahahahahahahahahahah
chaii Aikoriegie Solomon don suffer,

naso i tell people,
see come all this ghost readers dem, make dey come dey read my funny story,

to comment go dey hard una,
as all of una do face like road to biafra so,
na people like una dey go vote for the wrong president make go rule us for this our country here so,

hahaahahahahahahhahaha
everybody burst laugh,

naso one mad ghost reader make dem dey call Promise Christopher shout,

see come baba olowo is it by force to comment?
Naso i answer the fool,

see come as you take do face like dry garri so,
na your type dey go employ fresh graduates dem for brick layer work so make dem suffer,

as you do neck like charles barbage the father abi founder of computer so,
na thunder make wear swimming trunk nahim go fire your left yansh there,

hahahahhaahahhahaa
see as people dey laugh the guy,

naso one other ghost reader make dem dey call Johnson Anyanwu come shout,
abeg whats funny here?

I tell una say e remain small thing people make full rumours hotel here for beat craze comot for the idiot head,

naso i tell the fool,
see come as you take resemble estate agent make never see even one house sell for over 10 years now,

na your type dey go hang for back of person camry motor dey go work,

as you do eye like rat make dey see him period so,
with that your two left leg like devil walking stick,

hahahahhaahahhahhahaha
everybody burst laugh,

naso one of my fans stand up shout,
see come all this ghost readers dem make do yansh like short cut to hell fire so,

na thunder make dey rub bleaching cream nahim go fire all of una teeth comot for there,
as una do face like the forbiden fruit for garden of eden so,

hahahahahahahhhhahaha
everybody burst laugh,

naso one other ghost reader make dem dey call wadewaltz shout,

please whats going on here?
looks like you guys lack liturgicall reasoning and mentafollical calculations,

ahhh the thing pain guys dem,
naso one bros stand up yab am,

see come wadewaltz abi na wade witch be your name self,
as you take do face like toothbrush madman dey use so,

you better shut up that your wide mouth make be like that long zip make dey for back of women their dress so,

na your type dey go even prize condom, you go say abeg aboki you no sell am 30 naira for me?

hahahahahahhhaahahhaha
everybody burst laugh,
i don die o,

naso i stand up look the guy make dem dey call wadewaltz self,

naso i face am,
see come na me dem dey call baba olowo,
e been get one time you try provoke me but then i no just get your time,
you been try am self with youngzubi,

now i don remember you,
as you do face so like television remote make no dey gree work again so,
na people like you policeman go see arrest for no reason,

if dem later ask the policeman abeg wetin make you arrest wadewaltz?

The policeman go say abeg that guy be like thief,
you no see him face as e strong like back of kettle?

Abeg i just won arrest am for security reasons,

hahahahahahaha
everybody burst laugh

i tell una say even moderators dem dey find who go help dem yab this fool of a guy,

you dey form say you rich,
na thunder go fire that your ugly butthole there,

no ever try pick a fight with me baba olowo,
because for this life you no fit ever win me,

if you like blow english grammer like un-educated he goat,
just know say na your time you dey waist cow,

watch out for episode 62
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 6:13pm On Jan 24, 2019
Tonyspecial:
]good one baba

that is why i dey always tell people say i am not the best,

abeg more new updates for una here,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 6:36pm On Jan 24, 2019
As a token to one of my fans make just chat me up now say dem don steal him phone,

very bad to hear this,
i tell una say the thing dey do me like say na my own phone lose self,

because of this i go dedicate my next episode to the guy, so make i console baba,

baba name na Foremaster Flex Obizlove,

please lets be our brothers keeper,
abeg baba manage the little make i fit do for you at this time abeg,
after now all this ghost readers go say baba olowo no good,
i tell una say i fit compose funny stuffs from just any situation i find myself here in this life,

but abeg i am not the best,

episode 62 of baba olowo will be titled ( ahhh i don die,Foremaster Flex Obizlove don lost him phone)

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by WADEWALTZBACK(m): 10:36pm On Jan 24, 2019
Good job op but Please,no insults.
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 5:53am On Jan 25, 2019
WADEWALTZBACK:
Good job op but Please,no insults.

see come wadewaltz,
this one make you humble talk like human being for once so,

the first time i first know you i even think say you be all this nairaland their robot web bug so,
make go just go people thread dey talk all shits as you like,

chaii looks like dem don humble you,
anyways am not insulting you baba,
but the thing is that we got catch fun abeg,
na your turn be this because now baba olowo don remember you,

anyways just enjoy it and give me time to find another person make go replace you for my yabbing levels dem,

all for the fun baba no harm attached

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 5:55am On Jan 25, 2019
Episode 62
(ahhh i don die,Foremaster Flex Obizlove don lost him phone)

as everybody dey laugh for rumours hotel here so,

naso one guy shout,
abeg special anouncement,

abeg Foremaster Flex Obizlove don lost him phone ooo,
anywhere about of the phone please let us know,

oboy people con dey wonder wetin be this self?

Naso one guy make get long mouth like pencil shout,
see come Foremaster Flex Obizlove abi wetin be your name self,

as you take do face so like banner make dem write bring back our girls from boko haram so,

na your type dey go snap picture near crocodile,
as you do eye like charcoal board so,

hahahahahahahaha
everybody burst laugh
chaiii wetin be this?

Oboy another guy make dem dey call rude king stand up shout,
see come Foremaster Flex Obizlove,
as you do teeth like radio station make dey give out wrong information to everybody so,

na people like you dey go catch lizard dey train as pet,
as you do neck like i pass my neighbour generator so,

i no blame you,
na only you go come here dey announce say you don lose your phone abi?

As you do face like plumber make never see work do for 2 months now,

hahahahahhahahaha
chaiii people laugh tire,
come o, rude king mouth no just good at all,

hahahahahahahahahaha
as we dey laugh dey catch fun,

naso one bros stand up yab rude king,
see come you this enstranged fool called rude king so,

shey be na you dey update us one sweet story before?
now you don stop abi?

See come na thunder make hold spoon won chop morning food, nahim go fire your one eye there comot,

as you do yansh so like plantain chips,
na people like you dey repeat common entrance exams 5 good times,

as you do belle like catapot make madman dey use pursue people fowl so,

hahahahahahahahahaha
everybody burst laugh,

naso one guy make dem dey call wadewaltz shout,
come o, wetin be all this here na?

Shey be we suppose to dey console Foremaster Flex Obizlove make don lost him phone,

not all this noises and arguments like fully grown fools,

ahhh the thing pain guys dem,
why be say everytime this madman of a guy wadewaltz go surely come here dey talk rubbish like rabbit make get belle?

Ahhhh naso different people stand up won yab the idiot,
i tell una say people make stand up dem reach 15 plus,

oboy like so one guy shout,
abeg make una leave am for baba olowo abeg,

see as everybody turn look me for where i been sidon dey sip milk and bread dey shine teeth,

naso i surprise look everybody,
come o, wetin happen?
This one make all of una dey look me so like people make dey find work so,
wetin happen na?

Naso people shout abeg baba olowo just help us yab this guy wadewaltz abeg,

we really dey beg you abeg baba olowo,

naso i look the wadewaltz,
baba dey shake dey sweat badly,

baba shout abeg baba olowo na beg i dey beg you ooo,
i go still dey beg you abeg no yab me abeg oo,

naso i laugh look the fool,
see come wadewaltz abi wetin be your strange name self,

as you take do face so like eletrician make never see work do for over 3 weeks so,

na people like you dey hang person goat for bush Bleep,
as you carry teeth so like palmwine tapper make no get hope,

i go still talk again say na you be the only strange fool i don ever meet,

as your carry hunch back so like gallon of red oil,
na your type dey go hang on top nepa pole dey shout say before you go come down na till when dem call off strike,

as you resemble arrow make madman no fire well,

you do yansh like burkina faso national antem,

hahahahahhahahhaha
see as people burst laugh dey shout,

abeg baba olowo no kill wadewaltz for us oooo,
abeg remain small for us abeg,

naso i continue,
see come wadewaltz,
i dey sure say e go be you make go thief Foremaster Flex Obizlove phone self,

because as this your eye take dey very sharp so like scorpion make never see food chop for days now,

as you be like person make go write suffer head jamb,
you copy sotey you copy the person name make you dey copy from self join am,

as your thin leg take dry like tootpick so,

you carry waist like teacher make tell dem him student please fill in the brackets,

hahahahahahahahaha
chaiii baba olowo you too bad abeg,

you no dey tire to yab people?
Everyday you dey always dey drop us new rhymes of yabbing make dey sweet,

now you don finish this wadewaltz for us here,

naso i tell people,
even moderators for here dey use style dey find who go help dem insult this fool of a guy make dey very arrogant and stupid,

i tell una say some writers don really stop because of this bitch ass,

you know say you no fit ever try am with me baba olowo,

as far dem this moderators fit leave me one on one with you,

i swear you go ask yourself abeg na me be this?

As you carry bears so like orphanage home,
you do teeth like cashew nut make don spoil,

with your thin belle like holy infant primary and secondary school for my side here so,

hahahahahahahahahhahaha
i tell una say everybody burst laugh,

chaii baba olowo don kill am ooo,

watch out for episode 63
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:17pm On Jan 25, 2019
Abeg na just now i dey come back ooo,
chaiii so una like all this my yab stuffs dem?
after dem go say baba olowo no good,

anyways will be droping episode 63 very soon titled ( na thunder go fire wadewaltz for me)

abeg this na revenge of baba olowo against that guy wadewaltz,
then next time if him hear my name baba olowo him go bow down pick race from there dey go house,

peace out,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 3:09pm On Jan 28, 2019
See come all my niggas dem,
we are back at it again,

abeg its been a long road but we are here now,
its been a while i droped my story baba olowo d long prick episodes here,

anyways will let you guys know when am ready,

i no know why eddie ola just dey send me all this strange messages self,
please share this with 50 people if you love your mother,
50 more years will be added to her life,

hmmm i just won ask you?
Abeg what if say person mama come dey 90 years?
And you know say the highest life span na 120 years person fit live for this world take die,

abeg where you don ever see for this our present generation you see person reach 140 years before?

Since you say 50 more years will be added to her age abi?

you know say na people like you eddie ola dey sweet wella to yab die,
e be like say e don tey i yab you last nahim make you won seduce me to yab you abi?,

e be like say some people dem dey like make baba olowo dey see dem yab ooo,

see come eddie ola,
as you take do face like,

hahahahhhahhahahahaah
i know say all of una go reason,
chaii why baba olowo no complete this yab him won yab eddie ola na?

Abeg i just won tell all my haters dem something first,

See come all my haters dem make do face like old stove so,
old stove make sekpe timothy dem dey use cook food for their house so,
na una type dem dey use take,

hahahhahahahhaahhahaha
i don die ooooo,
chaii i don catch una again,
i still know say una go dey reason now say wetin make this mad baba olowo of a guy no dey gree complete him yabbing dem for here self?

una mind go be,
see come baba olowo,
as you take carry chest like madman report card so,
which one be your own for here na?
Na people like you dey drive all this small pikin their play play keke dey run dey go work,
as you do face so like wheel barrow make don spoil,

hahahahahahahahahhaha
i don die o,
abeg all for the fun baba,

baba olowo is back again

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Tonyspecial(m): 10:39am On Jan 31, 2019
Good update Baba......
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Tonyspecial(m): 7:57am On Feb 04, 2019
Ababa hwfa
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:03am On Feb 10, 2019
Tonyspecial:
Ababa hwfa

i dey bro,
its been a while now,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:07am On Feb 10, 2019
Episode 63
(welcome back dude,come and join me drink beer)

ahhh i don die,
so baba olowo don continue this him mad story dem again chaiii?

Oboy like so guys dem just chill dey drink bottles of beer dey high dey talk all bulshits,

naso one guy make dem dey call john arigu shout,

abeg baba olowo now make you won continue to dey update us with this dem your funny stories again,

na me the thing sweet pass,
abeg welcome back dude,come and join me drink beer,

naso sharp sharp i switch table go sidon with john arigu baba,

oboy the next thing make we see na wadewaltz, devilmaycry, iambees,and sekpe timothy rush carry chair join sidon near me for the table,
see as their four dey shine teeth dey laugh,

chaiii today we die here,

ahhhh wetin be this?
my two greatest enemies na them come sidon near me here so,

wadewaltz and devilmaycry,

how manage and how come?

Naso drinks dey fall out,
guys dem dey high,

sekpe timothy don already down 3 bottles,
chaiii this guy na really drunkard,
abeg you no get future?

Oboy things dey flow wella for here,
but the thing be say anytime i down one bottle,

if i say make i just cool down look around collect another one na wadewaltz and devilmaycry their faces i just dey see for here self,

chaiii which kind thing be this one for here self?

Instead make i suppose to dey get joy as i dey high,
oboy na anger nahim full all my body die,

naso i bone face again still dey high dey go,

na when i don high 4 bottles of beer,
oboy i no just know the spirit make push me stand up with vex,

naso i shout,
see come devilmaycry abi na devilmaylive be your useless name self,

as you do face so like person make madman give back hand slap so,

which kind thing be this na?
Why be say anytime i just dey look your face na so so anger just dey full my body self?

as you do teeth so like person make dey sell pepper for bustop,

na your type EFCC dem dey catch carry go atm go withdraw all their life savings for there,

as you carry belle so like blanket make youngzubi dem dey use sleep for house,

hahahahahahhahahahahaha
everybody burst laugh,
naso Aikoriegie Solomon shout,
chaiii baba olowo so you don start again abi?

Naso i answer am,
see come Aikoriegie Solomon as you do face so like village masquerade make no know road so,

with your long hand like china people their swimming trunk so,

na your type dey go carry your voters card exchange am collect beans and bread chop dey go house go sleep,

as you carry yansh so like drawing board all this high way robbers dem dey use plan go thief,

hahahahahahahahahahahaha
everybody burst laugh,

one guy make dem dey call Akanbi Adedipupo laugh sotey baba ask me,

abeg baba olowo i no really hear you well abeg,

abeg you fit help me repeat wetin you just yab this guy Aikoriegie Solomon abeg?

Hahahahahhahhahahahaa
people burst laugh,
chaiii baba olowo don come again,

naso i answer the idiot Akanbi Adedipupo,

see come Akanbi Adedipupo,
as you do face so like wetin dem eat remain so,

na people like you dey help people grind okro for bustop.

As you do teeth so like old novel person go read finish no even understand anything,

as you carry long yansh so like time bomb,

hahhahahahahahahahhaha
everybody burst laugh,
chaiii baba olowo no go kill us today ooo,

naso people dey laugh dey look wadewaltz for face,

wadewaltz bone face dey sip him beer,

naso some people go look wadewaltz come look me too laugh troway face,

hahahahahahahahhahahaha
dem just want make i yab wadewaltz so make dem laugh die,

naso i vex look the ram wadewaltz,

see come wadewaltz,
as you do face so like electrick kettle make no dey work again so,

na your type dey go help small pikin dem go pick their ball inside swarmp,

as you do belle so like catapot make no dey fire well again,

hahahahhahahahahahahaha
everybody burst laugh,
ahhhh i don die o,

naso i still continue,
see come wadewaltz,
na only you be the guy i know say go nepa office dey prize light,
abeg how much for half current? and abeg how much una dey charge also for full current?

As you carry chest so like plate make dem dey use put food for small pikin so,

na people like you dey go stand inside rain dey smoke bad bad,

as you carry long neck so like ostrich make never pay house rent for two years,

hahahahahahahhahahaha
see as people laugh dey scatter chairs make dem use sidon,

hahaahhahahahaha
i don die o,
na yab be this?
Kikikiikkkikikiki

oboy no kind of laugh we no hear for this place make we dey so,

naso iambees laugh shout,
abeg baba olowo,
e don do na?
No kill us abeg ooooo,

naso i answer am,
see come iambees baba,

as you do face so like old stove make no dey gree cook fast again like before so,

na people like you dey go twerk inside oracle their shrine dey shout you cant touch me and you cant see me,

as you do neck so like new generator make no won gree work,

you carry thin leg like person make dey train cows dem,

hahahahahahahahhahaha
i don die ooooooo,

baba olowo is back

watch out for episode 64
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:39am On Feb 10, 2019
Abeg for my new niggas dem make just come here so,

this story name is baba olowo d long prick,
incase you dont know na my way of bringing out the fun in this group,

lets have fun and laugh to forget the days hustle and stress,

anyways my next funny episode will be tittled (sekpe timothy na thief)

i need your comments guys

peace out and one love
all for the fun baba

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Tonyspecial(m): 6:38pm On Feb 10, 2019
welcome back baba
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 10:34pm On Feb 10, 2019
Tonyspecial:
welcome back baba

thanks bro,
really appreciate

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 10:35pm On Feb 10, 2019
See come all this chelsea fans dem make do face so like peacock make never chop food for 2 days,

i don die oooooo,
na chelsea be this?

Mancity 6 chelsea 0
abeg na match be this abi na just training dem just do finish?

Hahahahahahahahhahahahahaha
chaiii chelsea fans please take heart oooo,

i dey for ball house now i don laugh tire for here with my guys dem,

i tell una say some people make happy come here dem bone face go house today,

hahahhaahhahahahaha
one of my guy now eye don red oooo chaiii,

see the tragedy of defeat,
abeg this one no be ordinary defeat this one na really heavy defeat,

a whole chelsea up blues,
chaiii wonders shall never end,

anyways my consolation to all chelsea fans dem,
please take heart,

as una dey cry dey mourn for the loss,
people like us dey happy dey catch fun here,

after all me too don get my loosing days also,

abeg to cut this story short,
the loosing too much abeg,

na mancity play westham abi na cardiff city dem win this kind heavy scores?

Na amarture team dem play?
At least dem suppose score one goal na atleast,

Abeg this world don end,
my mind dey tell me say sekpe timothy na chelsea fan him be,

please cry no more,
peace out

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 2:12pm On Feb 11, 2019
Episode 64
(sekpe timothy na thief)

hahahahhahahahaha
see as everybody here dey laugh like mad people,

i don die oooo,
wetin be this?

Before we know we see one bros make dem dey call rude king stand up shout say sekpe timothy na thief oooo,

ahhhh people shout,
you say wetin?
How manage na?

Naso rude king continue,

me and sekpe timothy na the same area we been dey live together,

every time for area we go dey hear noise for outside say dem don catch sekpe timothy,
say baba go thief,

why be say sekpe timothy operation no dey ever dey successfull for this him life self?

I tell una say the thing make sekpe timothy sabi thief pass na people pot of soup,

baba go enter people compoud carry person pot of soup with the stove join pick race run,

hahahahahahhahaha
everybody burst laugh,
chaiii so this idiot na big thief him be?

I tell una say,
everybody now for the area don dey chain their pot of soup with chain and better padlock all because of this sekpe timothy,

hahahhahahahhhahaha
people burst laugh

as rude king still dey talk,
naso sekpe timothy phone ring,
baba pick the call sharp sharp,

wetin we hear for the phone speaker we no believe,

naso the caller shout,
see come sekpe timothy,
as you take do face like one bag of cement make dem smuggle from cotonou so,

you better come return my boxers make you thief comot from my backyard ooo,

if not wetin you go use your eye see i swear you no go believe am idiot,

oboy the caller shout tire for like 5 minutes,

the next thing make we see na sekpe timothy hiss troway face cut the call,

hahahahhahahhahahahaa
everybody burst laugh,
chaiii wetin be this?

Naso the phone ring again,
sekpe timothy no gree pick,
the next thing make we see na the guy send text message,

see come sekpe timothy na thunder go help me fire your yansh for there,
as you wear that my boxers so like kidnapper make never see anybody kidnap since him start kidnapping job for 2 years now so,

inshort na crocodile make just Bleep finish nahim go help me bite that your useless yansh for there idiot,

hahahahahahahahahahahaha
i don die oooo,
the guy dey vex ooooo,

naso the guy vex call again,
as i look say sekpe timothy no gree pick naso i help am pick the call because as i dey here so me don high,

oboy the first thing make i hear for the call na,

see come sekpe timothy,
na thunder make just go write exam dey come back nahim go fire your one eye there comot idiot,

shey be you don go thief my boxers i hang for my backyard abi?

Naso i answer the guy,

see come as you take do face so like anointing oil make don spoil,

na person like you dey go thief people pig carry go market go sell,

as you do hunch back so like father christmas make no carry one single gift give small children dem,

na your type dey go people party or wedding with big spoon,
as you hussle for food no need to collect spoon again be that,

hahahahahahahahahahhaa
everybody burst laugh

naso the guy reply,
see come sekpe timothy na kick and start motor nahim go jam you there fool,

you dey very stupid and cowardish,
just pray make i no catch you one on one i swear all your teeths dem go loss,

hahahahahahaaahhahahhahaa
everybody burst laugh,
chaii wetin be this?

Naso i answer the guy,
see come as you take resemble dangote driver make dem never pay salary for 6 months so,

as you dey shout for this phone so like person make dey play lotto for people,

na your type dey sell newspaper for bustop like person make dey go dig grave for people make don die,

as you do face so like bitter kola madman chop remain,

hahahahahhahahahahahaha
everybody burst laugh,
i don die o,

oboy the next thing make we hear for the phone na,

one woman make dem dey call mama ngozi shout,

see come sekpe timothy,
you better come return my handkerchief make you thief oooo,
or else na thunder go fire you there,

ahhhh the thing confuse me,
naso i answer the woman,

see come this woman,
as you take do face so like person morning wood so,

na people like you dey go stand for road dey beg passers by please help the poor abeg,

as you resemble antelop make go nationalize for togo so,

hahahahahahahahahahahah
see as people burst laugh,
chaiii i don die ooooo,

as people dey laugh,
naso rude king shout,

see come sekpe timothy i swear one day your cup go soon full and na that dey nahim you go die,

naso i answer rude king,
see come as you take do neck like prison window make don spoil so,

as you carry chest so like small pikin pant,

na your type dey help nepa people dey carry ladder dem go cut people light,

as you do face so like person babe make just enter sweet sixteen,

hahhahhhahahahha
everybody burst laugh,
chaiii baba olowo you too bad abeg,

come o baba olowo, wetin make you dey support sekpe timothy self?

Oboy we no believe one guy stand up yab sekpe timothy,

see come you this great thief of our time,
as you do yansh so like all this village masquerade make don high dey pursue only old women dem,

hahahahahahahhahaha

Watch out for episode 65
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 11:55am On Feb 12, 2019
Episode 65 of baba olowo
(THE GHOST)

hahahahahahahahhaa
i don die oooo,
so una mean say sekpe timothy na big thief him be?

Hahahahahahahahhahaa
see as everybody for rumours hotel here for festac town dey laugh,

chaiii wonders shall never end oooo,

oboy we no believe one guy stand up shout,

see come sekpe timothy,
as you do head so like rejected mad he-goat,

na people like you dem dey use exchange collect one kiss from ashawo dem for olden days so,

as you do eye so like blind fowl make go find work,

hahahahahahhahahahhahaha
everybody burst laugh,

chaiiii wetin be this?
Sekpe timothy don suffer,

oboy i tell una say people laugh sotey some start to dey vomit,

hahahahahahahahhahaha
stanley okafor baba olowo story episodes don make us mad o,

as everybody just dey laugh dey catch fun for here,

the next thing make people see we no believe,

oboy na one guy just climb ontop stage start to dey sing one strange song oooo,

i don die wetin be this?
Naso the guy dey sing,

akunamatata,
dance for the rest of your days,
please dont worry, for loving things akunamatata

naso one guy make get long mouth so like chewing stick shout,

see come who be that idiot make climb ontop stage so dey sing this useless song akunamatata,

see come if life no won better for you there you better comot from that stage before i use bottle stone all your teeths there comot for you,

hahahahhahahahahahaha
everybody burst laugh,
chaiii which kind strange music be this one self?

Naso my guy half kilo shout,
see come you this ghost singer make no get name so,

na thunder go help us fire you and that your akunamatata there fool,

as you do belle so like old bendel road,

na your type dey go plan thief person dog carry go sell,

hahahahahahahahahahhaha
everybody burst laugh,

chaiii i don die ooo,

naso we surprise the guy make dey ontop stage change the song start to dey sing,

a coat of many colours my mama made for me,
she saw me when i was dieing,
and she gave me a helping hand,
a coat of many colours my mama made for me,

hahhahahahahahahahaha
everybody burst laugh,
chaiii abeg which one be a coat of many colours my mama made for me?

Hahahahahahahaha
see as people dey fall for ground still dey laugh join,

naso one guy make dem dey call eddie ola make do mouth so like small pikin shit come shout,

see come you this ghost singer,
as you do face so like mallam make hungry won kill so,

na your type dey go thief people coat go exchange am collect one stick of cigar smoke,

as you carry neck so like bulldozer make no dey fit carry load,

hahahahahahahahahaha
everybody burst laugh,
i don die ooooo,
wetin be this?

Naso one guy make dem dey call iambees stand up shout,

abeg na england we dey abi na nigeria?
Which one be a coat of many colours my mama made for me?

abeg i won know where dem dey sell this a coat of many colours so make i fit see am buy abeg?

Because since when i dey this place,
i don dey look the kind coat sekpe timothy even wear come here self,

i no know wether na madman dash am the coat abi na the one him go thief from their headmaster so?

As the coat even resemble wetin kidnappers dem dey use sleep for night,

hahahahahahahahahahahaa
we no believe person stand up shout,
i don die ooooooooo,
laugh won tear my pant ooooo,

hahahahahahahahahhaha
everybody burst laugh,
chaiii baba olowo you too much abeg,

abeg make everybody here laugh out the days stress abeg,

oboy we no believe the ghost singer shout,

see come all of una make dey here make do face so like unbrella make don spoil,

na people like una dey go tap una neighbour light from their small generator,

as all of una do yansh so like panadol extra make don expire so,

hahahahahahahahahaha
everybody burst laugh,
come o na this mad ghost singer nahim dey yab us so?

Hahahahahahaha
we no believe say we dey even laugh ourselfs for here,

naso the ghost singer continue,
as all of una do face so like person backyard fence make don fall so,

na motor make dey always fail break nahim go jam una there,

as all of una do teeth so like parashoot make don tear,

hahahahahahahahahahhaa
everybody burst laugh again,
i don die ooooo,

why this ghost singer dey yab us and we still dey laugh ourselfs like fools for here?

I don die
wetin be this?

Naso i stand up look the ghost singer,

everybody burst laugh,
hahahahahahahahhahahahahaha
i don die ooooo,

people shout,
baba olowo now don stand up for you,
your own now don finish,

i tell una say i still stand dey look the ghost singer,

one bros stand up shout,
abeg baba olowo,
never start to dey yab this guy now abeg,

just give us some few minutes so make we laugh in advance the yabbing make you won yab this guy now abeg,

hahahahahahahahahaha
everybody burst laugh,

chaiii wetin be this?
Here be like where dem dey train mad people?

I tell una say everybody still dey laugh dey scatter everywhere here for like 30 more minutes,

hahahahahaahahaha
baba olowo we just know say your own no dey end!

watch out for episode 66
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 4:31pm On Feb 12, 2019
All my niggas dem,
i go tell una say me stanley okafor i am not the best,

but niggas dem dey say i too much,
abeg all thanks to God oooo,

some people go dey wonder how this nigga take dey fit compose things like this?

Una know say i dey always drop funny episodes here for una back to back,

some dey call me the most funniest guy on facebook,

abeg make pride no go enter my head ooo,

any suggestions of the tittle i go name my next episode 66,

na from the title name i dey use get inspirations to know wetin i go use compose follow the full episode,

please laugh responsibly,
no go ever try read this my story for midnight ooo,

abeg because of security reasons,
make your father no go run fly window run comot thinking say na thiefs dem fall in,

hahahhahahahaahha
i don die ooooo

dont try this at home,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 1:00pm On Feb 13, 2019
Abeg all my niggas dem,
i no really get chance now to compose my next episode of baba olowo episode 66 titled (dont try this at home)

anyways but i go try update una anytime am free or maybe 2moro,
abeg keep the hope alive,

i know say some of una go even think say na my episode 66 be this so make dem come read am laugh small,

please bear with me baba olowo,
its been a long road but we are here now,

one love peace out

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Tonyspecial(m): 12:39pm On Feb 22, 2019
Baba Olowo We Don Wait Taya Na
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 1:14pm On Feb 22, 2019
Tonyspecial:
Baba Olowo We Don Wait Taya Na

no vex iambees baba,
na my manager wakekeeping/burial nahim just dey hold me here,
i know say all my fans dem here go dey pray abeg which time baba olowo go drop him next episode so make we laugh small,

chaiiii i don die oooo,
i no believe my eyes oooo,
a whole me baba olowo this fool of a guy wadewaltz dey yab so,

since the last time i yab you thinking say you no want wahala,

not knowing say you go carry my name okafor200 go another threads go yab,

if to say you be man why you no yab me on facebook where i fit dey see you online,
i swear life go tire,

all becuase of you wadewaltz me baba olowo go come back again to dey drop episodes them here,

shey be you won yab abi?
Abeg go check my record wether nairaland here abi na facebook,
me baba olowo never for once loose any yab battle before,
100% clean sheet,

sotey i yab go meet one funny mc abi na comedian for facebook,
the comedian tell me abeg guy you too much,
i troway cap for you,
i tell una say baba no believe say him laugh himself,

talkless of you wadewaltz make do eye like kidnapper make never see anybody kidnap since when him start kidnapping job,

now i don draw yab war with you,
i go also fallen that thread you yab me go revenge for there,

had it been na facebook this war for sweet o,

baba olowo vs wadewaltz coming soon live on Hd

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 3:43pm On Mar 08, 2019
Baba olowo is back
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 5:05pm On Mar 08, 2019
Its been a long road but we are here now,
baba olowo is back and better,
really got phone problems thats why am yet to update you guys,

thanks to those that wished me happy birthday,
we all will laugh together once again because baba olowo don show face here again,

please mind you for my english just feel like typing here like a cool headed gentleman,

some people here dey miss baba olowo d long prick funny episodes,
even me self come here today to come read baba olowo latest episode forgetting say na me be even the baba olowo self,

abeg all my fans dem sorry for the delay and all shits,
na my phone spoil thats why,
abeg laugh responsibly because baba olowo is back,

baba olowo
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 3:57pm On Mar 09, 2019
Episode 66
(dont try this at home)

hahhahahhahahhahaha
chaiii so finally me baba olowo don start to dey update una again as i dey do before,

sorry guys for the late posting here,

naso one guy shout,
see come why this ghost singer make do neck like plumber make go rape person dey yab all of us here ontop stage so?

Naso i look the ghost singer,

see come as you do teeth like portiphers wife so,
na people like you dey drive all this small pikin keke with speed dey run dey go work,
as you do back so like grasshoper make dey go do thanksgiving for church,

hahahahahahhaha
everybody burst laugh,

abeg who even give this ghost singer the mic self?

Naso i continue,

as you do face like all this antelop make go do chieftaincy tittle for village so,

you better shot up that your wide mouth make be like madman pant make don slack come down from that stage,

before thunder make dem just deny visa go fire your butthole there idiot,

hahahahahahahaha
everybody burst laugh,

abeg baba olowo leave this ghost singer of a guy abeg oooo,

as things come take be for rumours hotel here for festac town,

naso everybody dey flex dey catch fun dey happy,
guys dem dey pop bottles dey high,

naso we surprise we see one guy make dem dey call optimis prime enter rumours hotel dey beg people,

baba dey shout please help a brother,

the next thing make we see we no believe,

naso wadewaltz call optimis prime come,

baba say,
hello dude the only thing i can offer you here is my slacked pant,
and i hope you will be ok with that?

Hahahahahahahaha
everybody burst laugh

hahahahahahahahaha
i don die oooo,

as everybody just dey laugh,
naso the thing vex rude king baba,

see come wadewaltz as you take resemble wetin dem use clean yansh so,

na people like you dey run comot from ophanage home say you no stay again because dem won use rape finish your life for there,

as you carry bears so like buffalo make won go write junuior WAEC so,

na divine inspirational thunder nahim go fire all your teeths there comot,

hahahahahahahahhha
everybody burst laugh,
hahahahhahahahahahhahahaha

i tell una say na optimis prime nahim laugh pass for here

hahahahaahahahhahahahahhaha
chaiii abeg na this cow be this?

Naso wadewaltz confuse,
please am only trying to lend him a hand here,
i dont mean any harm please,

hahahhahahahahahaha
naso sekpe timothy laugh shout,

see come wadewaltz,
as you take do neck like umbrella make don spoil so,
na suffer head work nahim for fit you and your sibblings for there idiot,
as you carry yansh so like tape rule make dem use dey measure to sell dem youngzubi their last piece of land for village so,

hahahahhahahahahahaha
everybody burst laugh
i don die ooooo,

naso one guy stand up shout,

abeg where baba olowo dey since all this time since abeg?

You just suddenly disappear like wadewaltz their uncle make go thief person cow carry go sell,

wetin happen na?
Abi you don go give woman belle?

Hahahahahahahhaaha
people shout abeg all thanks to baba olowo we fit dey catch fun for here again as like before abeg,

naso me baba olowo shout,
please dont try this at home.

Some people here go dey wonder who be this baba olowo of a guy self?

Why you too funny like this please are you a comedian or just a story teller?

I tell una say anything make wadewaltz see na the oposite him go like to do,

baba dey house for midnight dey read baba olowo funny stories,

the next thing make we hear na,
ahhhh i don die oooo,

hahahahahahahahhahaa
oh my gosh you just got my balls there,

baba laugh dey scatter bed ooo,

the thing surprise all him neighbours dem make dey sleep tight,

baba shout again,
oh my ghosh this guy is so funny,
oh you got me on my balls again,
hahahahahahahahahahahaha

come o wadewaltz don mad?
The next thing make we see na wadewaltz their pastor run come outside fly fence with speed,

people shout,
thief!! thief!! theif!!

Naso crowd pursue baba for night,
but the thing be say dem no see am catch,

baba excape enter the next street,

naso people dey ask come o,
no be wadewaltz their pastor be that?

Hahhahahahahahahaha
everybody burst laugh,

the worst thing be say the pastor even sag him trousers dey run self,

but nobody still see am catch,
na later we come dey hear rumours say the pastor been don already break enter person house for the compoud self,
before wadewaltz start to dey shout like mad dog oh my gosh you got my balls,

hahhahaahahahahahahhaa
everybody burst laugh
so you mean say na wadewaltz laugh for midnight nahim save dem?

Hahahhahahahahhaa
the thing surprise everybody as we still see wadewaltz their pastor still climp for alter still dey preach on sunday,

the pastor shout,
my operation this week was nearly successfull but all thanks to this fool wadewaltz that spoilt it for me,

ahhhh the thing surprise everybody,
naso the pastor quickly cover the talk,

baba shout,
you shall rise and fly the fence that your enemies have put for you,

hahahahahhahaa
everybody burst laugh

watch out for episode 67
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 5:21pm On Mar 09, 2019
Episode 67
(why have you forsaken us youngzubi)

hahhahhahahahahaa
everybody burst laugh,

come o,
wetin dey happen here self?

Naso one guy shout,
ahhh youngzubi why have you forsaken us here?

The thing surprise everybody,
abeg wetin youngzubi do again na?

Naso the guy continue,
abeg when was the last time baba youngzubi even update us anything for here self?

As people confuse dey ask wetin happen?

Naso sekpe timothy stand up shout,

no be youngzubi i see make dey negotiate to sell this our group here so to wadewaltz,

youngzubi tell wadewaltz abeg even if you give me #50 naira for there i swear to dash you the group as an admin,

hahahhahahahaahaa
everybody burst laugh

naso youngzubi stand up shout,

see come sekpe timothy,
as you take keep face like 2 sure number for lotto so,

na fire go catch una house there by mistake idiot,

wetin consine you with wether i won sell this group or not?

You better mind yourself there cow,

hahahhaahhahahahahaa
everybody burst laugh,

naso young wyzad shout,

so youngzubi na sell you won even sell this our lovely sweet group here so abi?

See come na cameroun pepper nahim go enter that your yansh for there,

as you do face so like plank wadewaltz go thief to use complete their house for village,

no wonder we no dey see you online again as before,

as you keep head like okrika bend down select,

hahahahahahahahahahaa
i don die oooo,
abeg na youngzubi be this?

Naso one guy stand up shout,

see come youngzubi,
na your type dem dey do usher for church so dem fit see thief offering money after church,

as you carry teeth so like further maths equation make hard die,

as you do belle like the book of my bible stories,

hahhahahhahahaaaaha
everybody burst laugh
so una mean say youngzubi don forsake us?

Naso people shout abeg whats the course of all this self?

Why youngzubi won sell the group for our back self?

Naso me baba olowo shout,

see come sekpe timothy and co,
as all of una take do face like cockk and bull story wadewaltz go dey tell him grandchildren dem when him won die so,

na people like una go dey soak garri morning afternoon and night,

as una carry dry chest like madman love letter make dem no put for envelop so,

hahahahahahahahaha
everybody burst laugh,
see come baba olowo wetin be your own self for this matter?

Naso one guy stand up shout,
see come baba olowo

as you take resemble wetin dem use cast vote so for bauchi state,

na your type dem dey hang for tree rape,

with your long mouth like the road to hellfire,

hahahahahhahahahahaa
everybody burst laugh
chaiiii i don die oooo,

abeg na baba olowo be this?

Naso i look the guy,
the guy even resemble all those fools make dey go thief ballot box pick race run,

see come you this strange fool of our time,

as you take resemble wetin dem use go bail wadewaltz for prison when dem accuse am for rape case,

na your type dem dey thief people pant go sell,

as you do neck so like rude king grandfather make sell almost half of their village to wadewaltz grandfather make we latter hear say mad,

hahahahahahahahahahhaaa
everybody burst laugh
chaiiii i don die oooo,

baba olowo you too good,

naso i tell people,
abeg youngzubi no really forsake us here,
na just say baba dey busy thats why,

before we know iambees stand up shout,

see come baba olowo na you we suppose to even talk say na you even forsake us self,

as you keep head so like back of kettle,

small time now you go leave us run go offline go rape person fowl

to update us new episodes go be problem to you,

as you do teeth so like madman make go stand vote for nassarawa state presidential election,

hahahahahahhaahahaa
everybody burst laugh
yes na true self na this stupid mad baba olowo nahim forsake us self not youngzubi,

hahahahahahhahahahaa

naso i laugh look dem,
see come,

as all of una take do face like demon make go rape person only goat so,

na thunder make go do suffer head labour work for benin so nahim go fire all of una yansh there comot,

na people like una dem dey use exchange for olden days take collect handshake from whitemen dem,

as una carry hunch back so like cripple man make dey dream to break usain bolt 100 meters record of nine point something seconds,

hahahahahahahahhaaaa
everybody burst laugh,

chaiii baba olowo don start again now,
which kind strange human beign be this guy self?

Naso one guy shout,
can we all just keep quiet and sit down,

una don forget say today na baba olowo birthday?

Ahhhhh people shout,
i don die oooo,

so na today be even this fool birthday and him no even tell us self?

Chaiiii naso i shout,
i don die today oooo,

naso i dey look people faces,
some dey smile some dey bone face,

i know say my own don done today,

the next thing make i see na wadewaltz and sekpe timothy carry bucket of water come,

naso i pick race,
oboy the whole crowd pursue me ooo,

i tell una say na hot water nahim dey inside the bucket ooo
i don suffer chaii

watch out for episode 68
(happy birthday to baba olowo)
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:07am On Mar 10, 2019
Episode 68
(happy birthday to you baba olowo)

hahahahahahahhahahaha
everybody dey pursue me baba olowo and dem still dey laugh

hahhahhahahahahaha
we must pour this hot water for baba olowo yansh,

chaiii oboy my speed increase ooo,
i tell una say none of dem see my back,

hahahahahhahahaha
people won laugh kill theirselfs.

Naso Bamidele Edreez Olumide shout,
Baba olowo that your long prick go burn today!!,

hahahahahahhahaha
everybody burst laugh still dey pursue me,

as i still dey run with full speed naso i yab Bamidele Edreez Olumide,

see come you this guy make do yansh so like expired mango make no ripe well so,

na your type dem small pikin go call abeg uncle come and help us and climb ladder so you can turn our antenna so our TV can be clear,

as you do eye so like catfish,

hahahahahahaa
everybody burst laugh
chaiii baba olowo mouth no just good,


people dey shout
catch am, catch am

abeg catch that fool for us make carry long leg dey run like person make go thief person fowl dey excape,

oboy the thing surprise me say na wadewaltz nahim pursue me with full speed pass ooo,

see as the idiot serious dey pursue me to catch with all him life,
like say him life depend on am,

baba dey shout,
i need to catch this fool baba olowo so i go fit beat craze comot from him teeth come still pour am this hot water join,

oboy before we know like so Aikoriegie Solomon shout,

abeg make una leave baba olowo for me ooo,

na my man be that ooo,

i tell una say dem pursue me for like 5 minutes dem no still see me catch,

na when i don tire nahim John Oyeniyi run dive give me spear for my back like say na WWE royal rumble fight gbosa!

Chaiii see as i fly enter swimming pool break teeth,

naso Aikoriegie Solomon shout,

see come John Oyeniyi,
as you take do face so like christmas goat make dem wear ninja cloth so,

na people like you dey hawk for go slow heavy traffic dem,

as you resemble cassava make dem forget to harvest last year so,

hahahahahhaha
everybody burst laugh
chaiii John Oyeniyi na you be this?

Naso i vex run come outside from the swimming pool shout,

see come John Oyeniyi,
as you take do neck so like old soldier make go rape bricklayer pikin so,

na your type dem dey stand for bustop every morning dey direct people road,
abeg madam follow here na here be road to abule-ado bustop,

as you carry teeth so like madwoman bra,

hahahahahahahahhaha
everybody burst laugh,
chaiii wetin be this?

Naso one guy make dem dey call Etz Engr Josh laugh shout,

please lets wish baba olowo d long prick happy birthday, long life and prosperity!!

Naso one guy make dem dey call Oyedare Timilehin shout,

abeg baba olowo,
how old are you now abeg?
How many years you dey self?

Naso i troway face no even answer the idiot,

him still continue to dey ask me,
i say baba olowo how many years you even dey self?

Naso i look am,
see come Oyedare Timilehin,

as you take resemble back of pot so,
which one be your own for here again na?
Wetin consine you with my age for here self?

See come no make me yab you ooo,

as you carry eye so like aligator pepper make dem no grind well,

you do face like wadewaltz their mad gateman make retire when him celebrate him 39th year birthday,

hahahahahahhahhahaa
i tell una say na only two months the gateman work retire because of the way this fool wadewaltz dey talk to am anyhow so,

na your type dem dey export fake banana dem go canada,

as you carry nose so like hipopotamus make go bankrupt dey find work,

hahahahahahahahaha
everybody burst laugh

ahhhhh baba olowo you no go kill us here ooo,

baba olowo you too funny,

naso people ask me abeg baba olowo why your yab dey always dey give us joy anyhow for here self?

Baba olowo you dey always dey make us dey happy dey laugh,

abeg happy birthday to you baba olowo d long prick nigga,

i no believe people jack me up dey shout,
baba olowo you too much!
Who fit dey drop us funny episodes dem back to back like baba olowo?

Before we know we see bottles dem dey pop up and down,
guys dem start to dey shout dey high,

babes dem start to dey wine their big bakassi,

naso one babe dey shine teeth dey wine yansh like say kwashoko dey worry am,

see come you this babe make thin so like cover of bottle,
no go wine break waist oooo,

as you take resemble wadewaltz elder sister make write jamb almost 15 times before she finnally pass,

hahahahahahahahahahaha
everybody burst laugh
chaiii baba olowo your mouth no just good,
you too dey yab people,

naso Aikoriegie Solomon stand up shout,
abeg i want to make a toast to baba olowo d long prick,

our one and only funny online nigga,
you make my day feel brand new,
thank you my brother one love,

chaiii everybody stand up start to dey clap,
baba olowo you be boss unlike sekpe timothy make be thief,

hahahahhhahahaa
chaiii wetin be this?

Abeg sekpe timothy na international thief him be abi na local thief?

Hahahahahaha

Oboy naso everybody here dey shine teeth dey catch fun,

Watch out for episode 69
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 6:59am On Mar 11, 2019
Episode 69 of baba olowo
(see come na thunder go fire you there)

hahahahahaahaha
chaiii abeg wetin be this?

As everywhere dey bubble dey noise for rumours hotel here,

naso one strange fool make dem dey call Johnson Anyanwu shout,

see come,
as everybody make dey this place do eye so like people make dey train cow so,

why una dey even celebrate this mad baba olowo birthday self?

We suppose carry this fool baba olowo go troway comot from fence go outside,

ahhhh people shout,
you say wetin?

Naso i look the fool,
see come Johnson Anyanwu

as you take do belle so like person make dey suffer stroke so,
na your type dem dey go thief person boxers wear dey go work,

as you do face so like all this yoruba baale dem make no dey see food chop,

na thunder go fire you there idiot

hahahahahahahahahahaa
everybody burst laugh

which kind mad hater be this Johnson Anyanwu self?

Naso i tell people,
me baba olowo and my guy half kilo dress go one church,

as we reach there wetin our eye see we no believe,

na one big banner make dem hang for the entrance of the church,

dem write for the banner,
see come,
anybody here make do teeth so like arabian goat make no carry any offering money come here abeg try front you go see another church for the next street,
no just think for your life to enter this church,

hahahahahahhahahahaha
everybody burst laugh

which kind church be this one self?

I tell una say the pastor make get the church na John Oyeniyi,

baba serious bone face dey count how many members dem come the church today,
before him ushers dem go deceive am carry offering money run,
even youngzubi self na the church him dey worship.

naso church service start ooo,

we never even reach 10 minute self people don dey dance dey go do offering,

which kind church be this?
Naso John Oyeniyi the pastor shout,
abeg if you dey come here come do offering so, abeg arrange your face well ooo,

before person go carry face come alter here like person make dey go dig grave for people make don die,

hahahahahahahaha
laugh won tear my pant,
chaiii which kind yoruba church be this one self?

Oboy we no believe Oyedare Timilehin stand up shout,

see come you this wrong voted pastor so make dem dey call John Oyeniyi,

as you do face so like juju pot,
na your type dem dey use take cleanse the evil of the land for olden days so,

you do eye like blind bat make go thief,
as you carry chest like small pikin singlet,
you do belle so like ostrich make dey sing for show,
with your thin neck like person make dey sell insecticide,
you carry back like pharmacy make dey sell fake drugs,
with your long yansh like rat medicine,

you carry big mouth like cahew nut make don spoil,
you dress like future rapist make carry file dey waka up and down dey find work,
as you resemble old time plumber make dey beg to see work,

hahahahahhahahahhahaha
everybody burst laugh
chaiii this church worst abeg,

naso we dance go do offering finish go sidon,

before we know the pastor shout,
abeg if you dey look for work and you need a miracle job please come outside for prayers,

naso Pedro Ola Wale, AY Lambo, Lavish Jay, with wadewaltz rush come outside,

hahahahahahahahhaha
laugh won kill me,
so this fool wadewaltz no get work?

Hahahahahahahahaha
so na miracle jobs all this fools dey wait for?

Chaiii wetin we here we no believe,

naso the pastor shout abeg you this buffalo make come outside here dey shine eye like witch so,
abeg go back go sit down for your seat this prayer no be for you idiot,

hahhahahahaahahhhaha
i tell una say na Pedro Ola Wale the pastor dey talk to so,

Pedro Ola Wale shout please pastor i want to be succesfull in my business,

i tell una say Pedro Ola Wale na coffin the guy dey sell,
baba never even see one coffin sell for two years now nahim make am join people make dey find work come outside,

person make never sell market for two years no be still the same level him and people make no get work go dey?

Hahahahahahahahhahaha
chaiii wetin be this?

Naso the pastor start to dey fire prayer,

before we know wadewaltz fall for ground faint,

naso the pastor shout i tell you the fault of your joblessness is from your wife's side,

you are too stupid thats why you married the wrong wife,

hahahhahhahahahahaha
everybody for the church burst laugh,
i don die oooo,

which kind mad pastor be this one self?

Naso the pastor shout,
see come Lavish Jay,
why have you lavished your life this much,

now you no get work?
Your life as a former yahoo boy has spoiled your life,

anyways your next work go be pick pocket thief,

the pastor shout,
i see you progressing as a pick pocket thief this year,

hahahahhahahahahaha
everybody burst laugh,

people laugh sotey person chair one leg break,

ahhh nothing we no go see for this place,

the pastor shout again,
AY Lambo i see you hawking groundnut this year,

hahahhahahahaha
everybody burst laugh,

i tell una say AY Lambo reject am,
see come you this pastor na thunder go fire you.

watch out for episode 70
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Tonyspecial(m): 8:11pm On Mar 11, 2019
Hahahaha
Hohohohoho
Kikikikoki
Baba na u be ko
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 10:57am On Mar 12, 2019
Tonyspecial:
Hahahaha
Hohohohoho
Kikikikoki
Baba na u be ko

all for the fun baba
thanks you

(1) (2) (3) ... (7) (8) (9) (10) (11) (12) (13) ... (22) (Reply)

Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him / Rhoda / African Nerd

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 215
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.