Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,143,336 members, 7,780,879 topics. Date: Friday, 29 March 2024 at 01:59 AM

WAR And LOVE ( Story Of Ex Soldier Contain War, Love And Commedy. - Literature (2) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / WAR And LOVE ( Story Of Ex Soldier Contain War, Love And Commedy. (3751 Views)

A Soldier That Loves Me- A Fat Girl's Story / Ezeudo (A Story Of War And Peace) / LOVESTRUCK - A Campus Love Story. By Demsid (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

Re: WAR And LOVE ( Story Of Ex Soldier Contain War, Love And Commedy. by skubido(m): 9:33pm On Aug 25, 2018
chai, nawa oooo

OP Tanks for the update, u too much

1 Like

Re: WAR And LOVE ( Story Of Ex Soldier Contain War, Love And Commedy. by adefajosekayo(m): 7:37am On Sep 14, 2018
am sorry for not updating since. it was due to some issues including no phone please accept my apologies
Re: WAR And LOVE ( Story Of Ex Soldier Contain War, Love And Commedy. by adefajosekayo(m): 7:39am On Sep 14, 2018
War and Love episode 14
As we carry bushmeat reach camp the medical team come attend to him. Them talk say them go carry am comot go city. Oga o wetin come dey happen now. Major Hugo don set up some intelligence team untop the matter. Na later we come see say that knife resemble one nupe guy own(soldier). We imidiately we don carry the guy dey beat. But my mind dey tell me say he no know anything
I swear no be me......nupe guy
But na your knife.......one soldier talk
I don't know anything about it,(he come dey cry) ........nupe soldier
Na him one soldier come dey run come tell us say he see when one hausa soldier (kuje) come carry the knife from him bag.
Quickly we go carry kuje dey question am when we receive call say bushmeat don come back from coma he don dey talk small small. Dem say bushmeat talk say na kuje stab am because he see him dey do meeting with the bokoharam inside bush , no be only him o 4 other soldiers dey among. Sharpaly we don't arrest all of Dem . Them talk say bushmeat dey cry say him want come back war.
.........._______________?&________
I will miss War king
One evening Dem call War king say him get visitors, and if we want go see visitor na one town wey we go spend 2 hours journey we dey go for safety of our visitor. War king come go meet him visitors. As he come back for night he tell me say he don finally quit war. I ask am why although am happy and at the same time sad, because he go go meet him family and I go miss him. He tell him say na him brother and soon be the visitors say they come beg him make him come home, and him don gree
Am so happy to see them....Warming
I will miss you.....me
I go miss you too. Fight well and defeat the enemies......warming.

--------------------;;;;;;---------
END of Hugo ( a brave warrior)
One night the enemy come attack us, we no even expect but as a gallant army we fight them. That day bullet just dey sing deadly songs. One bokoharam point gun to my guy stray bullet head from behind, my guy no shake he calm down raise him ham like he surrender, the next thing I saw be say he just turn collect the gun and shot the guy. But we have been feeling war king is like this people know he has left. I almost got killed when one bokoharam started shooting at my direction, I started running to dodge the bullet I come realize say I get knife for pocket fiaaannn as I trow the knife na the bokoharam head the thing land. The fight is getting thougher they don kill 9 soldiers already na him we come dey guide Major Hugo. We tell Major Hugo say make him escape with 4 soldiers but he talk say "We are all fighting for our country" as no one fit change him mind we just make sure say we guide him.
Straybullet pocket diary come fall down na him he come dey run go pick am one bokoharam just grab am and point gun at his head
Surrender abi I kill your commander( in hausa language).... The bokoharam talk he think say straybullet na the commander
Major Hugo no fit hold am so he just come out and said na me be the commander.
One bokoharam come shout na Major Hugo be that, the next thing we hear na tako! They don't shoot Hugo. Everybody eyes red we begin dey shoot like mad. Straybullet just use skill collect gun from the bokoharam we hold him shoot am like mad he go shoot am up to 20 times.
We come turn mad dey shoot anyhow. If you dey angry nothing you no fit do, we no care for them bullet, bullet go meet some people for right hand Dem go change their gun to left hand. We finish all the bokoharam non of them escape.
We come rush go Major Hugo side. Omo kasala don burst Major sing national anthem na him he pass out. Everybody cry
Some politicians dey chop contry money while we dey die for our country

1 Like

Re: WAR And LOVE ( Story Of Ex Soldier Contain War, Love And Commedy. by adefajosekayo(m): 12:54am On Dec 29, 2018
War and Love episode fifteen
Major Hugo death pain all the soldiers, some loose hope while some dey vex para. We all come plan to go bombard those idiots . We draw all our plans ready to go meet those bastards inside sambisa.
We don load our weapons ,come see as every soldier carry AK guns and bullets, we ready to die we must Sha make sure we take revenge. Na straybullet go lead the fight.
From our spy we dey among the bokoharam we don receive Intel of where the leader of the bokoharams dey.
As we set to go fight, we don load ourselves inside vehicles, na him them radio us from headquarter say make we no go fight.
Omo everybody para we no understand why Dem go stop us from taking revenge. We no wan gree but as some coward among us come kill our morale we go back to base.
As we dey go we dey para na him we come notice one of us wet dey make call secretly, na one of our oga him dey follow talk say we don't dey go back say nothing go happen make the oga tell the Boko Haram to calm down. Gbam all soldiers wet dey para don grab am arrest am and interrogate am, na him we come know say some of our oga sef dey help politicians work for Boko Haram.
Mad reach everybody head, we begin mutinying, all those bad oga with pot belly dey office dey enjoy we dey suffer risk life, dem just wan dey waste our life like say we be chicken. We wipe most of the curruption top officers and some currupt ones among us.

------_'!-;+:::::_-:::::::::;::::::::::::::::::::::::::::::::::::::::---------
Almos lost my life

We come re plan to go take revenge of our boss Hugo, we don't prepare and everybody don set.
As we wan dey go na him straybullet call me, come tell me say Afija tell am ' if nothing happens to me that claim my life na me she go still marry' straybullet come jokingly ask me about you go die so I go fit marry Adija. We both laughed and I couldn't say anything till we left for war.
We come reach where we packed our vehicle very far from the Boko Haram base, we trek, swim and disguised until we are able to enter their base. After the commander wet lead us order to start attack, na him we start to dey shoot and we dey kill those Boko Haram like bushmeat . I remember my bullet finish one small Boko Haram come dey carry Cutlass come wan butcher me , thank God say them teach us how to dudge something like that, I dudge am carry punch give am for head, him brain enter reset once I come collect that Cutlass dey pity the guy because him small, na him I hear tako! The boy fall I no even know where bullet come from, I reload my riffle continue battle, we dey kill those Boko Haram with blood eye .
Suddenly I heard q gun shot and that was all a know.
----------------:::-::::::::-::;-:;;;;:;;;;;;;;;;;;;;;;;;;;;!;!;;
No friend is reliable

It took me a year and four months to recover, I was shot at my chest and right leg at the war that I almost loosed my life, my leg almost damaged and I started using wheel chair.
I heard that straybullet will be getting married so I dicided to show up and surprise him because everyone thought I am dead, I was taken away to a safe place after the incident for treatment.
It was a new cell 500seater hall I could see beautiful faces I was pushing my wheelchair my self as I reach the entrance of the hall it was the time I heard I Adija take.......as my. I was surprised to see Adija as the bride , I was happy for straybullet and also thinking I should be the one to marry this girl o. Immediately Adija sight me I could see on her face surprise and she immediately said she's not interested in the wedding anymore, I quickly push my wheelchair to move away from the hall, I don't want to spoil good day for my friend.
Adija said John I know it's you, why did you lie to me why is everyone lying to me , she started crying, I couldn't move I turned back and briefed the story, then she said ' we should be joined together not me and your friend' . Straybullet came out and was shocked to see me, he was starring at me and a minute later some of our officer came to arrest straybullet, they claim the he was the one who shot me at the battle. He confessed and said he did it because of Adija.
Straybullet was sentenced to death, I finally walk again and start a new life.
The end. Oh! I and Adija got married and we have 3 children

THE END
UGLY STORY
Please drop comments
Watch out for next story.
Re: WAR And LOVE ( Story Of Ex Soldier Contain War, Love And Commedy. by skubido(m): 9:14am On Dec 29, 2018
OP whr have u been...


Nice Ending... Jah bless ya hand work
Re: WAR And LOVE ( Story Of Ex Soldier Contain War, Love And Commedy. by Nobody: 12:56pm On Dec 29, 2018
nice one bro
Re: WAR And LOVE ( Story Of Ex Soldier Contain War, Love And Commedy. by okparea(m): 3:20pm On Jan 05, 2019
Nice one bro you got me wow over and over again
Re: WAR And LOVE ( Story Of Ex Soldier Contain War, Love And Commedy. by yungbanks(m): 2:59pm On Jan 06, 2019
nice write up nigga

(1) (2) (Reply)

WARLORDS (battle Of The Gods) / Red Is The Colour Of Love / I Need Someone To Pitch My Idea For A Reality Tv Show Into Writing(professional)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 32
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.