Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,148,403 members, 7,800,819 topics. Date: Thursday, 18 April 2024 at 07:22 AM

Chook Mouth For This Matter - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Chook Mouth For This Matter (1140 Views)

Guys Reason This Matter With Me / My Two Neighbors: Your Opinion On This Matter / Please Make Una Put Mouth For This My Girl Friend Mata Ooo (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Chook Mouth For This Matter by Offpoint1: 11:26am On Jun 22, 2019
Me no understand this o, you be man you no fit impregnate your wife... dokitor sey you get "Low sperm count" meaning you no dey produce enough sperm...
You ask am how many sperm dey fertilize egg e talk sey na 1... dockitor which wahala be this? so na half sperm I dey produce?

Another talk sey you get WATERY SPERM, but na same dokitor talk sey sometimes woman fit get belle without penetration... even if na only semen drop on her v in some cases she fit get belle... which kind wahala be this?

Lefulefu come explain this science for me o
Re: Chook Mouth For This Matter by blackpanthar: 11:52am On Jun 22, 2019
oga calm down, go and take herbal products that will help your sperm count.

you will be fertile.

Offpoint1:
Me no understand this o, you be man you no fit impregnate your wife... dokitor sey you get "Low sperm count" meaning you no dey produce enough sperm...
You ask am how many sperm dey fertilize egg e talk sey na 1... dockitor which wahala be this? so na half sperm I dey produce?

Another talk sey you get WATERY SPERM, but na same dokitor talk sey sometimes woman fit get belle without penetration... even if na only semen drop on her v in some cases she fit get belle... which kind wahala be this?

Lefulefu come explain this science for me o
Re: Chook Mouth For This Matter by kingxsamz(m): 11:54am On Jun 22, 2019
blackpanthar:
oga calm down, go and take herbal products that will help your sperm count.

you will be fertile.

You seem not to understand what the guy is saying.

2 Likes

Re: Chook Mouth For This Matter by Offpoint1: 12:04pm On Jun 22, 2019
blackpanthar:
oga calm down, go and take herbal products that will help your sperm count.

you will be fertile.

You understand dey matter bros... nothing do me. only my kiss dey give woman belle, even my greetings dey give woman belle.

1 Like

Re: Chook Mouth For This Matter by Offpoint1: 12:06pm On Jun 22, 2019
kingxsamz:

You seem not to understand what the guy is saying.
Thank you jare, him no understand me at all.

2 Likes

Re: Chook Mouth For This Matter by Nobody: 12:07pm On Jun 22, 2019
Offpoint1:
Me no understand this o, you be man you no fit impregnate your wife... dokitor sey you get "Low sperm count" meaning you no dey produce enough sperm...
You ask am how many sperm dey fertilize egg e talk sey na 1... dockitor which wahala be this? so na half sperm I dey produce?

Another talk sey you get WATERY SPERM, but na same dokitor talk sey sometimes woman fit get belle without penetration... even if na only semen drop on her v in some cases she fit get belle... which kind wahala be this?

Lefulefu come explain this science for me o
certain of our behaviour/unhealthy habits na im dey give some of we guys these watery/low sperm count. This is why dem dey always advice make a man cut down on im beer intake cos beer contain a lot of sugar wey fit give u watery sperm. Also untreated stds can affect ur quality of sperm or reduce d number or even make u outrightly impotent. As a man if u want to be very potent then eat healthy then exercise and i bet u dat ur seed will be very agile and potentcheesy. Na so ur sperm go dey strong and ur akamu will be thickcheesy. Too much beer na one of the culprits wey dey kill our seed.

2 Likes 1 Share

Re: Chook Mouth For This Matter by Offpoint1: 12:12pm On Jun 22, 2019
lefulefu:
certain of our behaviour/unhealthy habits na im dey give some of we guys these watery/low sperm count. This is why dem dey always advice make a man cut down on im beer intake cos beer contain a lot of sugar wey fit give u watery sperm. Also untreated stds can affect ur quality of sperm or reduce d number or even make u outrightly impotent. As a man if u want to be very potent then eat healthy then exercise and i bet u dat ur seed will be very agile and potentcheesy. Na so ur sperm go dey strong and ur akamu will be thickcheesy. Too much beer na one of the culprits wey dey kill our seed.
If na dey case be that, why a drop of semen fit give person belle but watery sperm no fit...

dem talk sey low sperm count no fit give woman belle... but na only one sperm dey fertilize egg.... so that mean Sey dey man no fit produce even one sperm?
Re: Chook Mouth For This Matter by Nobody: 12:19pm On Jun 22, 2019
Offpoint1:
Me no understand thi..

SPERM, but na same dokitor talk sey sometimes woman fit get belle without penetration... even if na only semen drop on her v in some cases she fit get belle... which kind wahala be this?

Lefulefu come explain this science for me o
lol this ur particular dey remind of one of our lecturer then who was a medical doctor.he tell us about a case wey im handle about a 15 yr old pregnant virgin. Im say d girl confess na d uncle violate her but wen im examin d pregnant girl im come found d girl na virgin. D girl confess dat wen d uncle wan violate am im go bring out im tin rub am for her hymen then release on top den give her toilet roll to wipe herself. D uncle never penetrated her but she carry belle. D lecturer explain to us how dat was possible was that some few sperms still swim inside to d womb and dat the man's sperm was very agile and strong to do dat and dat yes its possible to give a girl belle without penetration. Na wetin im tell us for class be dat o.

1 Like

Re: Chook Mouth For This Matter by Nobody: 12:24pm On Jun 22, 2019
Offpoint1:

If na dey case be that, why a drop of semen fit give person belle but watery sperm no fit...

dem talk sey low sperm count no fit give woman belle... but na only one sperm dey fertilize egg.... so that mean Sey dey man no fit produce even one sperm?
becos dat watery semen na malfunctioned sperm mostly dey inside but d one drop of healthy semen na strong sperm dey inside. U can imagine in a drop of watery semen wetin u go dey inside na bent looking sperms or sperms with weaks tails or weak heads while d healthy semen u go see strong agile sperms with strong flexible muscular tails and strong heads dat can penetrate easily.na wich one u think say go do d job more satisfactory?

1 Like

Re: Chook Mouth For This Matter by Nobody: 12:28pm On Jun 22, 2019
blackpanthar:
oga calm down, go and take herbal products that will help your sperm count.

you will be fertile.

my guy offpoint1 can never be impotentcheesy..not in dis life or in d next life to come. Im na spactacus igwe 1 of capua cheesy
Re: Chook Mouth For This Matter by Offpoint1: 12:46pm On Jun 22, 2019
lefulefu:
my guy offpoint1 can never be impotentcheesy..not in dis life or in d next life to come. Im na spactacus igwe 1 of capua cheesy
Tell am o, my smile sef dey impregnate womangrin

1 Like

Re: Chook Mouth For This Matter by Offpoint1: 12:48pm On Jun 22, 2019
lefulefu:
becos dat watery semen na malfunctioned sperm mostly dey inside but d one drop of healthy semen na strong sperm dey inside. U can imagine in a drop of watery semen wetin u go dey inside na bent looking sperms or sperms with weaks tails or weak heads while d healthy semen u go see strong agile sperms with strong flexible muscular tails and strong heads dat can penetrate easily.na wich one u think say go do d job more satisfactory?
Let sey dem be malfunction and weak... na all the millions of dem go be so? abi dem swear for them?
Re: Chook Mouth For This Matter by Nobody: 2:57pm On Jun 22, 2019

for a watery semen some sperms wey good fit dey but na d ones wey no good plenty pass.understand in a normal healthy semen with healthy sperms wen im enter a woman canal some of dem dey experience obstacles.there are some wey d acidity in d woman's canal dey kill while there are others wey go experience other obstacles .so lets say a man now release a million healthy sperms maybe like 200 reach d final destination and out of dat 200 na d strongest of dem all go fuse with d egg. but in a man wey get watery semen and weak sperm lets say out of d sperm na only fifty manage dey healthy out of dat fifty wey enter d woman canal lets say 40 no make am and b4 d last 10 fit come finaly reach dhier destination dem all come die from one weakness or d other na fertilization no come take place.so u see why its very important for a man to have healthy sperms.
Re: Chook Mouth For This Matter by Nobody: 2:57pm On Jun 22, 2019
Offpoint1:

Tell am o, my smile sef dey impregnate womangrin
grin

Re: Chook Mouth For This Matter by catwalq(f): 3:02pm On Jun 22, 2019
Offpoint1:

You understand dey matter bros... nothing do me. only my kiss dey give woman belle, even my greetings dey give woman belle.

Lolzz.. Afraid hold me to even mention you grin

1 Like

Re: Chook Mouth For This Matter by Offpoint1: 4:04pm On Jun 22, 2019
catwalq:

Lolzz.. Afraid hold me to even mention you grin
grin fear, I wear protection for hand when typing... you're safe.

2 Likes

Re: Chook Mouth For This Matter by Offpoint1: 4:12pm On Jun 22, 2019
lefulefu:
for a watery semen some sperms wey good fit dey but na d ones wey no good plenty pass.understand in a normal healthy semen with healthy sperms wen im enter a woman canal some of dem dey experience obstacles.there are some wey d acidity in d woman's canal dey kill while there are others wey go experience other obstacles .so lets say a man now release a million healthy sperms maybe like 200 reach d final destination and out of dat 200 na d strongest of dem all go fuse with d egg. but in a man wey get watery semen and weak sperm lets say out of d sperm na only fifty manage dey healthy out of dat fifty wey enter d woman canal lets say 40 no make am and b4 d last 10 fit come finaly reach dhier destination dem all come die from one weakness or d other na fertilization no come take place.so u see why its very important for a man to have healthy sperms.

Daddy! Daddy!!! you don tey for womenology... respect

1 Like

Re: Chook Mouth For This Matter by Nobody: 5:00pm On Jun 22, 2019
Take vit C,zinc, n folate supplement or fud dat is rich wit dat vitamin n mineral
Offpoint1:
Me no understand this o, you be man you no fit impregnate your wife... dokitor sey you get "Low sperm count" meaning you no dey produce enough sperm...
You ask am how many sperm dey fertilize egg e talk sey na 1... dockitor which wahala be this? so na half sperm I dey produce?

Another talk sey you get WATERY SPERM, but na same dokitor talk sey sometimes woman fit get belle without penetration... even if na only semen drop on her v in some cases she fit get belle... which kind wahala be this?

Lefulefu come explain this science for me o

1 Like

Re: Chook Mouth For This Matter by Offpoint1: 5:30pm On Jun 22, 2019
blissgregory:
Take vit C,zinc, n folate supplement or fud dat is rich wit dat vitamin n mineral
lol, I'm good... you don't understand the write up maybe because I wrote it in pidgin.

(1) (Reply)

Popular Pastor Thrown Away A Lady On Chair With Anger During Deliverance / Ladies:how Many Men Have You Chopped Their Money Without Them Seein Your Pant? / Check Out The Size 16 Instagram Model Who Is Blowing Up The Internet

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 45
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.