Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,328 members, 7,808,103 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 07:17 AM

Coronavirus And 5g In The World-pidgin English (video) - Health - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Health / Coronavirus And 5g In The World-pidgin English (video) (176 Views)

Coronavirus And Fake News In Nigeria - BBC (Photos) / Coronavirus: Parents Abandon Kids At China Airport / Coronavirus: Snakes The Likely Cause Of Deadly Chinese Virus (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Coronavirus And 5g In The World-pidgin English (video) by Techcornerng(m): 1:55pm On Apr 06, 2020

https://www.youtube.com/watch?v=ZdZzWwp3c7k

5G network - wey be di big brother to 4G - fit get hand for di Covid-19 palava wey dey worry almost every kontri for di world now?

Dis na di kweshion wey some dey ask and wey odas believe say dem get answers to.

Wait o! Wetin be 5G? Dis na everytin you need to know
BCG vaccine fit work against Covid-19?
For UK, some pipo don burn telecom masts for Birmingham on Thursday and Merseyside on Friday.

Na dis make UK goment on Friday, 3 April tok comot reply say true-true di rumour don enta di kontri but say evidence no dey say 5G network fit cause Covid-19.

Even for Africa, di mata don make pipo worry well-well: From South Africa, to Kenya to Nigeria. Social media full for how dia goments need to stop 5G becos e dey bad for pipo health.


Some Nigerian politicians sef don ask di federal goment to block 5G not to enta di kontri.

And when one popular religious leader put mouth for di mata, di rumour come tie wrapper.

E say no be just for coronavirus, but say 5G na part of how some underground powers for di world want take control all human being.


No license to operate 5G inside Nigeria, di federal goment tok on Saturday 4 April.


5G Network dey Coronavirus?
While we no sabi anytin about underground powers, we know say di global joinbodi for health, WHO, don already tok if 5G dey cause coronavirus, and di answer na 'No'.


WHO - di World Health Organisation say dem don dey do research come tey tey - becos no be today dis kain rumour don comot, as pipo carry am during 4G introduction - and wetin dem see be say di radiation from 5G no reach to cause illness.

Di Nigeria Communications Commission don already tok, as far back as 2012 say telecom networks dem no fit cause human being to carry sickness, and say even base stations (mast) dey safe to live near if dem build am correctly .

E dey important to realise say no be today pipo don dey fear say mobile phone network fit cause health wahala, from di time wen 3G comot, to 4G and now 5G.

Find out di last place for dis world wia coronavirus go reach
Nigeria don get 210 cases of Covid-19 outbreak plus two new deaths
And until goments across di world tanda gidigba to put policy down wey go discourage spreading of di rumour - like di fine wey UK goment wan sama any station wey allow 5G coronavirus conspiracy theory - e be like say dis kain rumours go dey comot everytime.

Currently, no drugs dey wey fit cha cha prevent di coronavirus alias COVID-19, and even sef no vaccine. As di virus don waka across di world touch pass one million pipo, scientists dey work at breakneck speed to identify ways to slow or stop di disease.

Nigeria goment rubbish di 5G network vs Covid-19 tok
Nigeria minister of communication and digital economy Isa Ali Pantami don rubbish toks wey claim say 5G mobile technology fit cause coronavirus.

For statement wey di ministry release online Saturday evening, di minister confam say no license don dey issued to any operation for di use of di technology in Nigeria.

Oga Pantami say im department dey wait for report of one three-month study wey dem do for November ontop dis 5G mata.

Im say "our desire for technological progress no go dey at di expense of di health and welfare of our citizens".


https://www.youtube.com/watch?v=ZdZzWwp3c7k

(1) (Reply)

Covid-19 – Cross River State Governor Enforce Law: No Mask No Movement / Why Is It That Lockdown Always Take Effect From 11:59 / 7 Key Habits You Must Break If You Want To Last Longer In Bed With Woman

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.