Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,149,934 members, 7,806,705 topics. Date: Tuesday, 23 April 2024 at 09:19 PM

That Crazy Little Chicken! - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / That Crazy Little Chicken! (202 Views)

Guys With Big Joysticks Share Your Crazy Experience With A Lady (pics) / "I'm Going Crazy" - Fans Scream Over Oyinyechi Hair Extensions Studio / Black Model, “black Gabby Doll” Show Off Crazy Photos To Fans (ADULT ONLY) (2) (3) (4)

(1) (Reply)

That Crazy Little Chicken! by okafor200(m): 4:55pm On Jun 30, 2020
(That crazy little chicken)
hahahahaha
abeg wetin be this?
I tell una say me and my guy half kilo bounce enter one restuarant make dem dey call that crazy little chicken.
I tell una say here fine die and very quiet.
Naso we bounce go order for some drinks and snacks,
i tell una say we no believe one niggar make dem dey call eskelenje carry beans and bread from house enter the restuarant go sidon dey chop.
Chaiii the thing really vex the owner of the restaurant die,
which kind useless person be this one self?
This guy no get home trainning abi wetin self?
Before we know naso the owner go meet the guy,
please sir we dont condole this madness here,
please find else where and eat this your local man food not in this place please.
Naso eskelenje tell the owner of the restuarant,
na mallam you dey tell,
i dey come
hahahahaha
laugh won kill people
which kind eskelenje be this one self?
I tell una say eskelenje no even answer the owner of the restuarant again,
baba bone face dey chop the food like who don first craze before.
Chaiii the thing vex halfkilo die,
naso halfkilo tell eskelenje.
See come eskelenje as you carry face so like wolfsburg football club dey chop for here like madman cousin so,
inshort you dey very stupid and hopeless,
this one you dey answer eskelenje like person make dey suffer from sickle cell so,
i dey very sure say na for under bridge you dey live fool.
Hahahaha
laugh won kill everybody
chaiii my belle ooo.
Oboy we no believe eskelenje answer halfkilo.
See come halfkilo,
as you keep neck like cripple he goat order for drinks and snacks like say na you rich pass,
i dey very sure say if you and this useless baba olowo make keep head like traffic light chop this snacks finish na to find the nearest window fly run dey go house.
Hahahahaha
everybody burst laugh
chaiii wetin be this?
I tell una say the thing really vex me baba olowo die.
Naso i tell eskelenje.
See come as you do face like indian mad cow make just go do surgery so.
Na you and your family members dem nahim go chop finish fly window run dey go house.
As you carry yansh so like portiphers wife make won nearly seduce joseph for bible so.
Hahahahaha
everybody burst laugh,
kikikiki
we no believe one guy laugh sotey the guy shout.
I don die ooo,
abeg how eskelenje make be man go get yansh like portipher wife make be woman?
Hahahahaha
the guy laugh sotey people tire am rope troway go outside for streets.
Kikikikikiki
my belle ooo.
As people still dey laugh dey catch fun naso two people bone face serious die enter the restuarant,
oboy i tell una say na small thing everybody make dey inside the restuarant for pick race run dey go house,
chaiii we even think say na sars men be that,
we no even know say na the newest crazy couples in town,
centino and the new bride,
i tell una say their two bone face no even greet anybody waka go order for food.
Naso centino tell the waiter,
We need fried rice and chicken missed with pepper sauce and salads,
then top it up with cold fanta juice,
please make it two plates thanks
naso dem bone face again go sidon for near window dey discuss.
Chaiii the thing pain halfkilo die,
naso halfkilo shout,
see come centino and this new bride make keep chest like dry plastic plate so,
so for una two village dem no dey teach una how to greet una elders abi?
As the two of una keep face like youngzubi strong morning wood so.
Na una type suppose dey farm dey suffer dey plant ugu leafs.
As una carry teeths like pest control.
Hahahahaha
everybody burst laugh
i don die ooo.
We no believe centino answer half kilo.
Am really sorry for not greeting you sir,
but you never told me you are way older than me and you are not yet married.
My apologies sir,
hahahahaha
laugh won kill everybody
so halfkilo don really old self?
chaii this halfkilo make do face so like evil old vessel never even marry self.
halfkilo no be small pikin again ooo,
baba don old die.
Hahahahaha
my belle ooo.
I tell una say the thing really pain halfkilo enter soul,
Baba won cry
we no believe eskelenje shout,
nice one there centino thats why i really love you.
You are the best when it comes to simple fools like this.
Hahahahaha
laugh won kill people
chaiii na halfkilo be this?
Naso centino talk again,
as for you baba olowo d bend prick,
dont go and marry,
be there shifting girls waist with that your expired long thing like someone who was brought up from a polygamous crazy home.
Hahahahaha
everybody burst laugh
i don die ooo,
people shout,
baba olowo na today be your turn to chop better yab to think about your useless life there fool.
Hahahahaha
chaiii wetin be this?
I tell una say the owner of the restaurant laugh sotey him give dem centino free food no gree collect money.
I tell una say the owner of the restaurant laugh shout,
i have been waiting for ages for someone to stand up and challenge you this stupid baba olowo and this halfkilo of chicken.
Hahahahaha
i don die ooo
my belle ooo!

(1) (Reply)

Please I Need Help With My School Project / ���� Help / Please,we Should Stop Seeing Negativities In Everything People Do

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 24
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.