Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,297 members, 7,808,011 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 03:03 AM

Former NDDC Oga Joy Nunieh Don Reveal How Senator Akpabio Dey Loot Us. - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Former NDDC Oga Joy Nunieh Don Reveal How Senator Akpabio Dey Loot Us. (200 Views)

Governor Wike Rescues Joy Nunieh From House Arrest (Video) / Akpabio: Nothing Must Happen To Joy Nunieh - Wike / Akpabio To Joy Nunieh: 'You Married 4 Husbands' (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Former NDDC Oga Joy Nunieh Don Reveal How Senator Akpabio Dey Loot Us. by Prinbabie(f): 12:42am On Jul 12, 2020
Former NDDC Oga Joy Nunieh don reveal how senator Akpabio dey loot us.

By Princess Eigbokhan Orih


The Oga before before for Interim Management Committee ontop Niger Delta Development Commission, madam Joy Nunieh don blow breeze foul yansh come open.

Madam Joy don yan strong thing against our Minister of Niger Delta Affairs, Senator Godswill Akpabio.



The NDDC oga before before yan this stories to pressmen dem after she show face for the Senate ad hoc Committee wey dey investigate NDDC.



Madam Joy Nunieh tell pressmen dem all the kurukere things wey her eye see for the hand of Akpabio before dem comot her as the NDDC MD.



Una remembered say we President Muhammadu Buhari for February 2020 rearrange di interim Management Committee (IMC) for Niger Delta Development Commission (NDDC) na so dem take comot Barrister Joy Nunieh com put Professor Kemebradikumo Pondei, as the new Acting oga for NDDC.



Madam Joy yan say “Nobody fit pay any money for NDDC wey Godswill Akpabio no approve.

She say When she first show for the day of the inauguration, Senator Godswill Akpabio tell her for inside car say, ‘Madam, madam madam, how many times i call you? if you no do as I tell you, na the same pen wey I take sign your paper na him i go still use to comot you for office.



As the stori dey hot madam Joy talk say Senator Apkabio tell her say once she migrate reach Port Harcourt, make she sharp sharp go change all the dollars wey dey NDDC account.

Madam Joy Nunieh come yan say fear catch am to do the thing we the minister send am.

Na him senator akpabio come tell her say na poverty mentality dey worry her. Say of say she too dey fear.



Madam joy come remind everybody say no be for una koro koro eye Godswill akpabio accuse her say she no gree spend money. Abi that one no shock una today? Anyway na money matta.



According to madam Joy, na so senator Godswill akpabio show for Port Harcourt two days after the inauguration he come repeat the matter wey him yan before say make i say change the dollars.



The oga before before for NDDC still yan say Akpabio come dey disturbed her make she swear oath of loyalty, but she no gree.Though oga Akpabio don deny that one.

She talk say as the gbege continu, na him she carry the matta reach presidential Villa for the office of Mr. Abba who be the S.A. to oga Presido ontop domestic matter.

Madam joy talk say for the meeting, wey oga akpabio plus Alhaji Maikano dey, oga Godswill talk say na only wen madam Joy take oath of loyalty things go settle between dem. But she no gree take any oath.

Na that time senator godswill akpabio yan say, as e be so, say him go commot madam Joy for her position as MD.



Na that time oga Godswill begin campaign against madam Joy. She yan say she no even answer ram because she know say him ticket go cut and her hand clean.



According to madam Joy “she no gree follow Akpabio go FEC meeting unto say she no wan deceive Mr. President and her reason be say the law talk say any person wey disobey one section for the procurement Act, na five years imprisonment without any option of fine.



Madam Joy yan say if to say she go with Akpabio to deceive Mr. President she for enter inside hot soup because they talk say na 2020 budget, but Akpabio go and collect approval when the budget never ready.


Madam Joy yan so many matter wey heavy for mouth among the things wey she accused Apkabio say oga Godwin tell her to draft a letter ontop her letterhead to implicate Senator Peter Nwaoboshi say him collect contracts from NDDC. Madam Joy say she tell Akpabio she no fit do that kind thing unto say she na lawyer because anybody wey allege must to prove the matter. Madam Joy yan say Akpabio talk say Senator Nwaoboshi dey give them trouble and besides him no recognize the IMC. Madam Joy say she still stand her ground say she no go do that letter. Then Akpabio tell her say she is very ungrateful and she refused to do that letter.

Madam Joy also talk say Dr. Cairo come yan say him go do the letter. Dr. Cairo tell her say if Akpabio tell him to kill, him go kill and madam Joy say as for her, she no go do sure a thing. Madam Joy yan say for that place, one Mr. Etiebet who be the only NDDC staff wey present for that meeting asked Dr. Cairo to go and bring letterheads from the office.

Na so Dr, Cairo take do the letter and she say if she signed any document and Mr. President see ham him go believe. So she go only write say the EDP knows about the matter.

Madam Joy blow hot as she tell pressmen say Before she come back from the meeting bros Festus Keyamo for their first meeting, don award 30 contracts of water hyacinths.”

See video:


Copyright © Eagle Hedge Online News

Re: Former NDDC Oga Joy Nunieh Don Reveal How Senator Akpabio Dey Loot Us. by realstars: 12:44am On Jul 12, 2020
LL
Re: Former NDDC Oga Joy Nunieh Don Reveal How Senator Akpabio Dey Loot Us. by Chimezirim121: 12:44am On Jul 12, 2020

(1) (Reply)

How 4 Anti-graft Chiefs Ended Up In Corruption Charges / PDP May Postpone Primary In Ondo / Shippers Council Set To Pen N43.24bn Ibadan Dry Port Project

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.