Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,148,663 members, 7,801,919 topics. Date: Friday, 19 April 2024 at 05:50 AM

Nigeria Police No Get Joy O. - Phones - Nairaland

Nairaland Forum / Science/Technology / Phones / Nigeria Police No Get Joy O. (2122 Views)

Oh Joy! MTN Giving Away The Christmas Bonanza / What Joy Do Android Users Derive From Badmouthing Iphone And Ios Users?? / Modern Technology: Supply Of Joy Or Distress (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Nigeria Police No Get Joy O. by Sunepal13(m): 11:05am On Sep 16, 2020
Naso dem dey take arrest anybody wey dey use smartphone.
Today,two police car chase two of my neighbor friends because they saw them with big phone o their way to work.
One of them jumped into a river and swam away,while the other took another route.
Anybody wey carry big phone na yahoo to our Police.
The thing that shock me most is that they using it to dry their account.
#SayNoToCorruption.

4 Likes 2 Shares

Re: Nigeria Police No Get Joy O. by Pussymender: 11:19am On Sep 16, 2020
Aboi PH own worst o
once you hand bag for shoulder dey waka before you know police don burst out, them go search u,search your phone join, if you just get any oyinbo man or woman picture,my brother your phone don go.



naija no dey safe for youth,no dreads,no tattoo,no crazy jeans. inshort dressing well and too clean dey attract police and sars.

3 Likes 3 Shares

Re: Nigeria Police No Get Joy O. by Sunepal13(m): 11:30am On Sep 16, 2020
Pussymender:
Aboi PH own worst o
once you hand bag for shoulder dey waka before you know police don burst out, them go search u,search your phone join, if you just get any oyinbo man or woman picture,my brother your phone don go.



naija no dey safe for youth,no dreads,no tattoo,no crazy jeans. inshort dressing well and too clean dey attract police and sars.

Chai
Re: Nigeria Police No Get Joy O. by Spy360(m): 1:54pm On Sep 16, 2020
Sunepal13:
Naso dem dey take arrest anybody wey dey use smartphone.
Today,two police car chase two of my neighbor friends because they saw them with big phone o their way to work.
One of them jumped into a river and swam away,while the other took another route.
Anybody wey carry big phone na yahoo to our Police.
The thing that shock me most is that they using it to dry their account.
#SayNoToCorruption.
But aren't they yahoo guys?
Re: Nigeria Police No Get Joy O. by Sunepal13(m): 1:58pm On Sep 16, 2020
Spy360:
But aren't they yahoo guys?
Is it everybody that carry big phone that do yahoo? If not,then no.
Re: Nigeria Police No Get Joy O. by Coldie(m): 3:32pm On Sep 16, 2020
Pussymender:
Aboi PH own worst o
once you hand bag for shoulder dey waka before you know police don burst out, them go search u,search your phone join, if you just get any oyinbo man or woman picture,my brother your phone don go.



naija no dey safe for youth,no dreads,no tattoo,no crazy jeans. inshort dressing well and too clean dey attract police and sars.

Y Dem no go arrest people way hang bag, abi u no know say for pH hanging of bag na modus operandi of cultists
Re: Nigeria Police No Get Joy O. by Pussymender: 4:12pm On Sep 16, 2020
Coldie:

Y Dem no go arrest people way hang bag, abi u no know say for pH hanging of bag na modus operandi of cultists
aboi no bi everybody wey hang bag bi cultist.

so y Dem go dey arrest people wey dey hang bag?
Re: Nigeria Police No Get Joy O. by Coldie(m): 4:28pm On Sep 16, 2020
Pussymender:
aboi no bi everybody wey hang bag bi cultist.

so y Dem go dey arrest people wey dey hang bag?
If u want hang bag, hang bag dress well Waka like normal human being, no be where u go hang bag dae Waka like person way want beat person dae ask y police arrest u
Re: Nigeria Police No Get Joy O. by Nickshrapnel: 5:28pm On Sep 16, 2020
I don’t understand something here, why did they run?
Re: Nigeria Police No Get Joy O. by Nobody: 6:19pm On Sep 16, 2020
Nickshrapnel:
I don’t understand something here, why did they run?
Why I no go run. Do you know what it means to sleep inside cell.

4 Likes

Re: Nigeria Police No Get Joy O. by Nickshrapnel: 6:25pm On Sep 16, 2020
SegFault:

Why I no go run. Do you know what it means to sleep inside cell.
No, I don’t.
Re: Nigeria Police No Get Joy O. by punisha: 8:33pm On Sep 16, 2020
I remember travelling one time from uyo to aba to buy stuff in 2018 and had so much pity for this boy who had this dread and an iPhone 6....every checkpoint had him coming down and fished out to settle.
That was the last I travelled via that road anyways and I dunno what it will be like now for such boys...
Re: Nigeria Police No Get Joy O. by seanwilliam(m): 9:29pm On Sep 16, 2020
the kook be say.. live your phone behind when going interstate
Re: Nigeria Police No Get Joy O. by Starboytwo(m): 12:33am On Sep 17, 2020
SegFault:

Why I no go run. Do you know what it means to sleep inside cell.
he dont know... Me and police after every every for ibadan....popo- which site you dey bomb? Me- bomb? Oga me i nor sabi dah one ooo, na skul my mama send me.... Popo- mtchew, see this one, oga, better learn better work, go ijebu meet better baba make he give you better something make u collect better money... Me- listen attentively.... Popo- but if you don collect money, no go dey pop for club upandan, find better investment, shaybi u still get mama, open shop for am, this that, blah blah....long story short, popo share me hotspot, check my aza balance for my bank app... Still collect 5 bay cuz of hang out....
Re: Nigeria Police No Get Joy O. by Purplekush(m): 1:28am On Sep 17, 2020
Me i de carry better dreads and like to look fresh. So dem go de disturb esp if you de use leg walka. But na before i de run from police. Now i use my hand tell u say "i'm not a yahoo boy. I de in a hurry. So i go use because of am open my phone make u search" "because normal una oga pata pata the IG done talk say make una no dey search people phone randomly".

i no get time to shout. And i no go follow you enter any moto shaa..
Re: Nigeria Police No Get Joy O. by Nobody: 2:16am On Sep 17, 2020
Starboytwo:
he dont know... Me and police after every every for ibadan....popo- which site you dey bomb? Me- bomb? Oga me i nor sabi dah one ooo, na skul my mama send me.... Popo- mtchew, see this one, oga, better learn better work, go ijebu meet better baba make he give you better something make u collect better money... Me- listen attentively.... Popo- but if you don collect money, no go dey pop for club upandan, find better investment, shaybi u still get mama, open shop for am, this that, blah blah....long story short, popo share me hotspot, check my aza balance for my bank app... Still collect 5 bay cuz of hang out....
Luckily I've never experienced it, but the stories wey I don hear ehn.
Re: Nigeria Police No Get Joy O. by ruggedtimi(m): 6:14am On Sep 17, 2020
Pussymender:
Aboi PH own worst o
once you hand bag for shoulder dey waka before you know police don burst out, them go search u,search your phone join, if you just get any oyinbo man or woman picture,my brother your phone don go.



naija no dey safe for youth,no dreads,no tattoo,no crazy jeans. inshort dressing well and too clean dey attract police and sars.

the matter tire me, last week along emohua road towards uniport. Na so SARS for check point just to tell me park " my friend park ur car we go fire you oh shocked!" About three of Dem strt to ask me question. Na accident wey I get that night safe me from the hands of those criminals.

(1) (Reply)

Wap Site Directory / How To Get Your Glo 4gb Trick.. / ########## FOR SALE ..NOKIA 5810 Xpressmusic......price 8,500 naira only

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 26
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.