Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,083,307 members, 7,594,397 topics. Date: Friday, 29 September 2023 at 05:46 AM

See Why Nigeria Fit Stop To Dey Give Vaccines To Pipo - Health - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Health / See Why Nigeria Fit Stop To Dey Give Vaccines To Pipo (184 Views)

Why Nigeria Cannot Produce COVID-19 Vaccines – Faisal Shuaib / "Why Nigeria Should Avoid Madagascar’s COVID-19 Drug" - JOHESU, PSN / French Doctors Say 'Test Coronavirus Vaccines In Africa", Eto’o, Drogba React (2) (3) (4)

(1) (Reply)

See Why Nigeria Fit Stop To Dey Give Vaccines To Pipo by Terrancal: 8:55am On Apr 09, 2021
Authorities for Nigeria say dem go stop to dey give di Oxford-AstraZeneca COVID-19 vaccine after dem don use half of di dose wey dey di kontri.
Di health minister tell tori pipo say since di kontri no sure when di second batch of di vaccine go land, dem need to keep di remaining half for those wey don already collect di first dose.4
AstraZeneca vaccine need two dose to dey effective for pesin body.
Dis Nigerian goment decision no be like say e relate to di tension wey don arise from di big announcement wey European Medicines Agency (EMA) go make on 7 April about di vaccine and im connection to cases of blood clot.
Olurunnimbe Mamora, wey di Junior Health Minister for di West African kontri tell tori pipo today say di goment dey worry well-well say if dem no stop di vaccination program (after dem don use half) di pipo wey don collect already no go fit complete dia dose.
Informate wey Primary Healthcare officials release show say nearly one million Nigerians na im don collect di first dose.
Di goment don already say di vaccination program go first favour frontline health workers and those wey dey vulnerable, like old pipo.
As part of di COVAX programme, Nigeria bin collect four million doses of di Oxford-AstraZeneca vaccine for February.
All dis dey come as di kontri don begin do clinical trials for two covid-19 vaccines wey dia own scientists don create.
As at di time of dis report, di kontri don record 162,000 cases of COVID-19 and more than 2,031 people don die from di virus.

(1) (Reply)

What's The Remedy To A Sensitive Scar Located In The Hand? / How To Cure Erectile Dysfunction And Be Powerful In Bed / Tinubu: Nigeria Must Remain United To Tackle National Challenges

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2023 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 34
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.