Stats: 3,009,973 members, 7,356,329 topics. Date: Monday, 20 March 2023 at 10:18 PM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Travel / Emirates Ban Nigeria Passenger Flights Indefinitely (201 Views)
Emirates Ban: FG Announces Possible Resumption Of Flights To UAE / US Embassy In Nigeria Closes Indefinitely / Visa Application; US Embassy Closes Consular Section In Abuja Indefinitely. (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Emirates Ban Nigeria Passenger Flights Indefinitely by mxhabib2001: 8:45am On Jun 25, 2021 |
Emirates flight ban on Nigeria dey come barely 48 hours afta UAE announce plans to resume flights connecting Nigeria to Dubai. "In line wit goment directives, passenger flights to and from Nigeria (Lagos and Abuja) dey suspended wit effect from 21 June 2021 until further notice." Na wetin Emirates tok inside statement BBC Pidgin cari eye see. "Customers travelling to and from Lagos and Abuja no go dey accepted for travel. "Customers wey don travel to or connect through Nigeria inside di last 14 days no dey permitted to board from any oda point to di UAE," Na so di airline further add put for di statement dem post for Emirates website. Dubai Supreme Committee of Crisis and Disaster Management release new travel protocol on 19 June to resume flights from Nigeria. Di eased travel rules wey suppose start Wednesday 23, June, 2021 also affect passengers arriving from India and South Africa. "We regret di inconvenience wey e cause, and affected customers gatz contact dia booking agent or Emirates call centre for rebooking. "Emirates remain committed to Nigeria, and we look forward to resuming passenger services wen conditions allow." Emirates add. Why Emirates ban flights to Nigeria? Since 4 February, 2021 Emirates Airlines stop to dey airlift Nigerians to Dubai from Abuja and Lagos airports. Di ban na sake of di refusal by di Presidential Taskforce on Covid-19 [PTF] to allow di airline conduct rapid test for coronavirus. Di airline make dis test compulsory for dia passengers, four hours before dem board dia flights. But di arrangement no go down well wit Nigerian Federal Goverment authorities. Presidential Task Force on COVID-19 [PTF], according tori wey dey ground, dey plan to provide di infrastructure for Emirates Airlines. Di plan na to conduct Rapid Antigens Test [RDT] on passengers wey wan fly from Nigeria in readiness for di resumption of flights. But wit dis latest travel update, Emirates flights from Nigeria fit no dey available for a longer time. |
(1) (Reply)
Loaded Tanker On Fire At Oremeji Ibadan (video) / For Returning N12 Million That Had Been Left In His Taxi, Abraham Airaodion Was / Waoh Discovered The National Beauty Of Nigeria
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2023 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 40 |