Stats: 3,248,325 members, 8,137,678 topics. Date: Friday, 18 April 2025 at 09:11 AM |
Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Plateau State Governor Aka Pl001 Don Share Machine Okada And Raincoat For Sekuri (119 Views)
Soludo's Full Statement: Bans Okada And Tricycle. Curfew From 6am To 6pm / Enugu: Keke, Okada And Tiper Union Leaders Say Hoodlums Responsible For Crimes / Horses Seen Serving As Okada And Keke On Lagos Streets (photos) (2) (3) (4)
(1) (Reply)
Plateau State Governor Aka Pl001 Don Share Machine Okada And Raincoat For Sekuri by dashpee: 9:00am On Aug 09, 2024 |
PL001 DON SHARE MACHINE FOR WAKA WAKA AND CLOTHES WEY DEY BLOCK.RAIN TO SEKURITI PIPUL MAKE DEM USE AM SAFE PIPUL. We all know wetin hapun for our State how dis bad pipul scatter farmers crops, ba him our ogbonge governor sidon think well well come buy machine for waka waka together with raincoat, una sabi raincoat ba? Dis sense na to make sure say our village pipul slip well and fear fear no go dey like bifo, and una know say some villages no get road at all, I no no weda dem no get local government chairman. The time wey our governor dey give dem dis tins on Thursday for old government house wey dey Rayfield, Barr Mutfwang say wetin him do dey among the promise wey him give to arrest kasala make him pipul sleep wella, we get luck for our State ooo... He even say dis one wey him do na genesis him never enter Leviticus, e go do plenty tins to make sure say sekuriti pipul no give excuse, and all the place wey moto no fit enter him sure say machine for waka waka go enter. He come say wetin him do na wetin him suppose do so dat make dis pipul wey like to kpai pipul go another place. He don reach 2 months now wey we neva hear say dem attack pipul kill dem, na some if the tins wey the governor don do, for our villages the governor say na him work to make sure say him pipul dey safe and make dem do their farm kuleh without troble or killing, make we get boku boku chop chop na wetin the governor tok. Oga PL001 as una no, say the state dey try him best to make sure dem put head togeda settle dis kasala wey the state dey face. He still draw eye for some of dis sekuriti pipul wey dey plan to use dis machine do going or okada, say him no go happy at all, say dey go dey put eye wella. Early mo mo the Mr. Samuel Jatau Secretary to the Government of State wey some pipul dey call SGS him say dis machine and raincoat dem go share am for pipul wey dey do sekuriti, as una know, na Police, Soja, Civil Defence, Immigration, operation rainbow. The pesin wey tok for the sekuriti pipul, Mista Alexander Barunde, na him be commander of Civil Defence for Plateau State really thank oga PL001 Bros Mutfwang for dis tin wey him do, he say the tin sweet dem for belle well well, he say dey go use am wella sekuriti go improve well well for our ogbonge state. Gyang Bere DOPPA to our Governor Bar Mutfwang the executive governor of Plateau State Na me Dach Pee SSA on Media to Oga PL001 His Excellency Bar Mutfwang.
|
(1) (Reply)
Press Release / Exemplary Leadership: Orji Uzor Kalu, The Life Wire Of Sports In Africa. / SDP Denies Alleged Defection Plot Of Gov Soludo. As APGA Dismisses Internal Cris
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2025 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13 |