Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,383 members, 7,808,361 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 10:50 AM

Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) - Literature (2) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) (61743 Views)

Water Strike- A Comedy (18+) / FRESH Toto(adventure Of Prick Master And Miss Young Toto? / Innocent Ilo Wins 2020 Commonwealth Short-story For African Region (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (22) (Reply) (Go Down)

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by pradoic(m): 7:10pm On Aug 11, 2018
bros u dey sleep for here ni this one dey mention anybody wey stumble enter,just calm down dey do ur tin since oga youngzubi don support u,all u need to do is follow his direction,like said try to put thing together,compose ur writting very well becos u'er mixing tinz up,but whichever way u still dey try so keep it up ne just reason the comments
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:12pm On Aug 11, 2018
No wahala me don hear wetin una dey talk
but any how sha me go still dey update una my tori for here no shaking one love
abeg o me just won ask one question to una
me no know if una go fit tell me the episode make been funny pass abeg?
The one make sweet u personally
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 11:17pm On Aug 11, 2018
Nairaland.com

chaiii wetin be this na why una dey do me like dis?
he get one day me i para vex with my guy half kilo
na so we enter bike dey go nairaland.com head office
ahhhhhh today na today o
oya we don reach make we fall in
as we enter the place one custormer care con attend to us
please sir how may i help u?
I first no answer am
she con ask me again how may i help u sir?
Na so i reply am i came to pay for ur nairaland weekly adverts fee
i want to start my advertisemet here in ur web forum
ok na so she tell me the least money u can start with is 20,000 naira
i con tell am no props
hello sir please tell us the name of ur adverts sir
na so i tell her i want u to help me advertise my story baba olowo the long prick

hmmmm the custormer care turn look me
please i dont get u sir?
what did u say again?
I said i want u to help me advertise my story lines baba olowo the long prick
just help me push the story or thread to the front page of nairaland

hmmm the custormer care con breath in
please sir wait here am coming

na so she con waka go inside go call seun come

baba bounce dey come
him con greet us hello sir good day to u
me con answer am yes good day
i came here for u to help push my story thread baba olowo the long prick to the front pages of nairaland

ahhhhh him shout
for wat na?

I say come o are u the owner of the thread abi story?

No no no him shout please we dont accept such bad names for a story to be pushed to front page

imagine the name u gave ur story baba olowo the long prick
please i dont condole madness here

if u are ready to advertise it please try and change the name to sometin else
then come back we will do business

ahhh my eye red
come o why na? Wetin be this
na u get the story?
Na so i ask am

please what am saying is this i dont like the name of ur story thats all

i say but thats just my nick name na?
I even have the 20,000 naira cash here with me if u want i will even add more to it

seun look me con say u know wat?
Just give me ur bank account details i know wat to do

na so sharp sharp i give am my bank account

before 2 minutes ehhh i receive alert for my phone!

Chaiiii i confuse wetin happen
na so i check the message wetin i see for there na
you have been credited 20,000 naira to ur account from nairaland.com thanks

i con dey look like mad man
come o wetin i dey see here so

seun con tell me say please manage it
and dont bother to come back here again

wait o i con dey wonder instead of me to dey pay in enter nairaland account na dem con dey credit my account wetin con happen?
Abi dem don high ?

the custormer care con tell me say please we dont accept topics or stories with such bad names and push dem to front page

ahhhh before i know ehh security excort us go outside
chaiiii wetin be this self i shout
me make e be say i need many comments and interactiveness from nairalanders

na so seun use take fall my hand so?
Chaii life don tire me o
abi dem use the 20k take bribe me say make i use take shot up my mouth?
Ahhhh which kind tin be this self
na so i para dey go back my house

imagine person make won go pay enter nairaland dem account
na so dem pursue me back with 20k say make i no even bother to advertise again chaiiiiiiiiiiii
make i still dey my level

ahhhhh no wahala me go still catch una

episode 14 coming soon
shey if i drop rabba shey u go turn up!!!
Amaka disapiont me!!!

1 Like

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Youngzubi(m): 11:47pm On Aug 11, 2018
lol!,my guy you'er really struggling hard,not bad shaar

*****
how to get people attention and maybe just maybe their comments too

read your writeup when u must av finished writting, then ask ur sef this questions please try answering them with all sincerity becos it would help u work more

"if this story was written by another person will i read it and still come back for more? Is the story interesting enough to captivate me,will i comment to encourage the writer", "If ur answer is YES then you'er good but if u couldnt provide any answer for those questions then brotherly u need to work harder


again stop using "he" instead us "e"

use "i" instead of "me" eg me won go wrong....i won go correct!



keep it up man,add more effort dont give up,if u think PIDGIN is not ur thing asin u find it hard to express ur characters well with it"stop the story and creat another title then start all over again with English becos i have seen ur posts on webmaster,you'er good please consider writting the story in English


still ur guy youngzubi
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Youngzubi(m): 11:49pm On Aug 11, 2018
you'er among the ghost readers in my thread,"remember u never say pkikim! after readinggrin
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 6:33am On Aug 12, 2018
Come o wetin happen?
Why e con be say na only likes i just dey get for here?
Abi here na facebook?
Me i don confuse o
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Sensitivity1254: 7:37am On Aug 12, 2018
The first episode (the incidence with the groundnut seller) and the second episode (wey the call girl come run after sighing your long prick)


okafor200:
No wahala me don hear wetin una dey talk
but any how sha me go still dey update una my tori for here no shaking one love
abeg o me just won ask one question to una
me no know if una go fit tell me the episode make been funny pass abeg?
The one make sweet u personally
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 12:57pm On Aug 12, 2018
Happy sunday to everybody,
me dey wish una the best for the week
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 2:37pm On Aug 12, 2018
Episode 14( this atm don mad o)

come o today na sunday o as e take be ehhhh me still dey rumours hotel dey flex with my paddy half kilo we dey spend for babes and drinks we no even send self

as e con take be for here ehh
every where dey bubble
dj dey give us better music gbedu
tins dey flow well

naso my guy half kilo con tell me say make i help am go atm go withdraw 100k cash come

say him won spend die today o
him con give me the atm card naso i rush comot dey go one bank make near there

as i reach there i surprise to see long line of people make won withdraw money

ahhh wetin be this
people just dey para say the atm no dey work fast as the tin suppose to dey work

na so i stand been dey watch wetin dey happen

na so one guy put him card
sharp sharp the atm pay am 50k
him waka comot

the next person enter the atm pay am 80k

ahhhh me con dey surprise but dem say the atm slow na
wetin con dey happen

before i know one guy enter con insert him card but the atm con tell am say unable to dispense cash

chaiiii wetin be this
as people con dey para for the atm and the bank dem

naso one other guy vex put him atm
the atm tell am say oga ur account balance na 100 naira
please step aside

chaiiiii wetin be this
another person put him card
the atm tell am oga u been borrow 200k from this bank before but u never pay the money
now i don deduct the money back from ur account

chaiiii me i won laugh die

one guy con bounce enter put him card
oboy the atm reject him card o
ah ah wetin happen na so the guy put am again o
e still do the same tin
the guy try am again like 5 more times before we know ehh the atm shoot him card trowey go express ahhhhh wetin be this everybody burst laugh chaiiiii

as we con still dey laugh
naso one girl con insert her own card enter the atm oboy naso the atm tell am u are very stupid
card make don expire since last 2 years
na him u carry put here say u won withdraw money?
Thunder fire u there

ahhhh me i won laugh die chaiiii
me con dey reason am this one make the atm dey talk any how so, u sure say me i go fit still withdraw anytin today so?

One small boy con enter
as him won insert him atm inside
naso the atm bring out 100k come outside gba!

Ahhh naso the boy claim am oo like say na him own waka dey go
chaiiiii thief

people con say e be like say the atm don they pay again o

one woman con rush insert her card con type say she won withdraw 150,000 naira
naso the atm bring out 1,500 naira

ahhhhh mogbe the woman shout how manage na
me make e be say my account balance na 200k

wetin con happen
naso she put the card try am again the atm tell am say ur account balance na 0.00 naira thank u for banking with us

ahhhh the woman mad
na so people still dey hold the woman o

one guy just rush put e own card for the atm
con type say him won withdraw only 1000 naira

naso the atm bring out 150,000 naira chaiiiii

baba confuse but as a sharp guy make him be naso him rush carry the money dey go

one guy just rush enter put him card naso atm tell am network unavailable abeg try elsewhere

ahhhh why na

me con dey reason which kind useless atm be this self

why the tin no dey give people the money dem request for
me con reason am say e be like say this atm don mad o

naso i bounce go insert my card enter as i reach there
i con been reason am say if i go say i won withdraw 100k cash na this atm fit give me 1000 naira
ahhh me no won risk am o
but me i wise surely i go catch this mad atm

naso i vex type say i won withdraw only 1000 naira
before i know ehh the atm pay me 100,000 naira cash
chaiiiiiii see sense make i use for am o
ahhhhh i thank God o

as i waka comot dey smile
naso one bros rush enter put him card oboy wetin we hear be say oga ur account balance na 0.00 thank u for banking with us
as for ur atm card abeg forget am me i don swallow am

chaiiiiii laugh won kill me wetin be this

baba surprise con dey shout why the atm go swallow him card just like that

one man con dey calm am down
chaiiiii this atm don really mad o
why this atm just dey do oposite tins for here

one guy con say him go try him own
as him reach there the atm tell am oga abeg no just bother ur account balance na 200 naira only

ahhh baba shout
but him still vex put the card enter con type say him won withdraw 50k
money make e be say make no even dey for him account balance
baba dey hope say the atm go do magic pay am the money

before we know ehhh the atm scatter him card still reject am come outside

chaiiii the guy card con resemble paper person use clean yansh after toilet

ahhhhhh me i won laugh die
chaiiiiii this atm funny o

me con dey happy dey smile dey go rumours hotel with my 100k

chaiii this atm don really show people pepe today o

anyhow sha na so i fall in rumours go meet my guy half kilo
as we con dey flex dey buy more bottles
na so i sight that babe bibi294 make she been no gree wen i dey toast am before
chaiiii today go sweet o

abeg i need una comments o
episode 15 coming soon

1 Like

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 9:28pm On Aug 12, 2018
I been dey see say people dem dey come read my tori and dem like make i dey always drop new episodes for dem,
i suppose don drop episode 15 since
but u know say body no be firewood i just dey tired o today na sunday man need catch some fun for outside with friends
but anyhow e go be me go soon drop am make una laugh small
chaiiiiii
me i know still know wether na me get the highest record for nairaland here?
i been drop 11 episodes straight hand no stoping under 2 days
some fit say na because i dey find make i start to dey trend online
but to me na lie i just dey in a happy mood that is why
but as the comments no come dey flow in as expected na so my mood change to vex now i don dey drop episodes dem 1 a day thats very bad
but had it be say i dey see the comments from readers dem i swear i for don dey episode 50 by now and we for don laugh scatter our chair fall for ground still dey laugh
me i funny to dey compose jokes o but anyhow sha i need una encouragements

e get one ryhymes for one episode make i drop make been make me laugh die for here as i dey read am

that mental boucer tell me say no be u be okafor200 for nairaland here?
Na so i tell am na thunder go fire u okafor200 na person name?
My name na stanley okafor
chaiiii see as i take deny my lovely surname okafor200
me won laugh die for here

and he get another one self i drop too

i no know wether una don read am self
when my trouser tear into two for yansh
when i tell one bros abeg u fit borrow me ur trouser?

How person make wear only one trouser go take give me him trouser
which one him go con wear na?
Hahahahahahhahahaaa

if i start to dey remeber all make i don drop for all my episodes i go just dey laugh for here like mad man
abi dem tell una self say na only una go come read finish laugh as una want?
Me self dey come back after i post finish
read am start to dey laugh like mad man for here
had it been na another person compose am me i for don laugh kill myself chaiiiii na so i funny reach?

Una self get the one make una read self may make una laugh die and na him make una dey attracted to this my tori thread
dey come read more everyday

Anyways dis na life my only problem be say i need una comments if una don read finish
make everybody try make here lively abeg
baba olowo the long prick still long o and i get many episodes pass 500 self
but na encouragements i just want from una thats all

episode 15 coming soon ( buhari why nigerians get lazy youths? )
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 4:46am On Aug 13, 2018
Episode 15 go sweet o,
me i never see this kind useless interview before for my life chaiiii wetin be this
so we nigerians don turn lazy youths abi?
Make i never talk first
make that baba just come here just con talk nonsense ehhh wetin i go use him eye see ehh ok
no problem

make una dey expect my next episode of baba
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:48am On Aug 13, 2018
Episode 15 ( buhari why nigeria get lazy youths? )


as i sight that hard to get babe bibi294 make i been toast she no gree for me

my mind cut but i gather moral go meet her

hello dear,its been a while can i get to buy u drinks?

Hmmmm thanks
naso she smile look me

ahhh my mind sweet me die
i insist dear lets get to stay somewhere we can get to gist and have fun and take down some cold chiled drinks
all on me

na so i quickly apologies to her
am really sorry for the other day i hope u can get to forgive me?

She con reply me yea i have really forgotten all abt it
so its ok by me

me i con smile so are u chanced now? Lets talk

she con tell me u know wat am really free now so lets seat over there and discuss

chaiii this babe go sweet o
as we con dey yan abt ourselves and some other tins
we just dey laugh dey look each other eye to eye
ah the tin been just dey sweet me
naso i call bar man please bring us more drinks here

as him con dey go naso him rush change the dstv movie make people been dey watch before
con put one buhari interview chaiii wetin be this

dem dey interview baba about the economy of the nation
how tins go take better and how nigerians are complaining bitterly about the government

the man make dey interview baba con ask am say
how do u as a president move nigeria as a nation forward?

baba con say as u can see that the economy is been polluted by the very corrupt past goverments that have looted and stolen all nigeria natural reserves and money say him dey put all him effort to recover all and make nigeria a better place

naso one man make been dey follow us dey watch am there for rumours hotel con shout
e better say the past government dem dey thief our natural resourses as far say we dey see food chop
than say this useless government make no gree thief anyting then we no con still dey see food chop

which one better pass?
Naso people answer say na true the man talk o

Na so dem con ask baba
please we read in one of ur comments u said nigerians have lazy youths that are not ready to work?
Why do u say so sir?

Baba con reply as for the youths let dem stay there and be waiting for me to come and help dem shape a better nigeria
dont dey know they are the once that will work hardlessly for it than for them to sit down there and cross their legs doing absolutely noting

and they are expecting a change in this country
chaiiii people para
which kind mad man be this?
This man well so?
Wetin be this?

So we don turn lazy youths abi
where this man dey wen i dey trek go oshodi go find work i no still see?

If work dey youths dem no go dey work?
Which country for the whole world work pass nigerian youths?

We make e be say we ready work like jackie?
Guys dem strong na? but work no dey

naso the man make dey interview baba con ask am
but u said nigerian youths are lazy?
How come your son yusuf got involved in a motor bike accident recently?

Was he not having enough time to have fun and forgot all about working?
Or is he not also a youth like others?
Why then was he not working but rather choose to be flexing around?

Or is he a youth citizen of ghana and not of nigeria?
Why was his own different from others?

Naso baba reply am as for my son yusuf
he is really a good and a hardworking nigerian

ahhh one man make sidon near me shout chaiii
na thunder go fire yusuf

people won laugh kill theirself chaiiiiii which kind useless interview be this one self

naso baba continue
yusuf is a proud nigerian
and for the records u would see how endlessly working he has been over the years
adding meaningfull tins to this country in general

naso the man make dey interview am con ask please help us to mention just only one tin ur son has meaningfully added to us as a nigerian?

ahhh baba confuse
but him con say my son has been useful enough but u wont see what he has added to this country
but he is really a hard working boy onlike our nigerian youths

baba no even get wetin he won use do excuse no be him dem ask make him just tell us one tin make that him son yusuf don add for anybody life for this country?
Just one single tin yusuf never even add
na wetin we dey hear na only yusuf is a hard working boy
so nigerian youths dem no be hardworking youths abi?

One man con shout am say the thunder make go fire yusuf ehhh still dey gym

chaiiii laugh won kill me
ahhh i don see sometin

so we dey wait for change naso all this useless people dey here dey call us lazy youths

chaiiii it is well

the man make dey interview baba con ask am say
please sir to my own self and other fellow nigerians we have not seen ur son yusuf add any meaningfull tin to anyones life here
but he is been said he is a really hard working boy

before the man go even finish naso baba sound craze comot for the man eye gbosa! Chaiii wetin be this
baba para is it only my son u will always be talking about?
Are u mad?
Or na nigerian lazy youths na dem send u?
U must be a stupid man?

Chaiiii interview don turn fight

episode 16 coming soon!!

2 Likes

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 8:01am On Aug 13, 2018
Watch out for episode 16

the continuation of the useless interview
see as interview don turn fight
baba dey mad?
Wetin make am slap person make dey interview am?
Chaiiii me i won laugh die wetin be this
All this u go find out for episode 16 coming soon

1 Like

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 11:13am On Aug 13, 2018
Episode 16 (the continuation of the useless interview)



ahhh people para chaiii wetin be this
why baba go give the man slap for tv broadcast make e be say the whole meaningful nigerians dey watch live

wahala dey o
upon the slap make baba give the man na con still the man dey beg am

please sir am sorry for asking u all this foolish questions sir am really sorry please pardon me and lets go on with the interview

naso baba mind con calm down tell am please ask me more reasonable questions before i will design ur face with new latest slaps

chaiii see threaten for the guy own show o

before we know ehh
my guy half kilo para wetin be this self
him vex collect rumours hotel personal custormercare line carry am come for where we been dey watch the live interview

naso half kilo shout
abeg anybody make won voice him anger for this interview through phone calling make dem qeue for line

before we know ehhh 300 people line up

chaiii everybody dey para for here o

wetin be this self why him go fall the guy hand for national tv

naso time for viewers to con start to dey call the interview their hotline make dem have their own say consining the matter make dem dey discuss

as the man pick the first caller gba!
Na one guy make dey rumours na him call first connect

naso the man ask please what is ur name and where are u calling from?
The guy para abeg my name no dey important here but my location na rumours hotel live and direct

me won add my opinion for this una show abi interview

naso the guy start
come o wetin be this i see here so
make i first comment on this idiot son before i go vex na ehhh scatter this phone make i dey call una with

as for yusuf shey be dem say na motor bike accident him get naso dem rush am go outside country for treatment because dem see say nigerian hospitals dem no good

ok since that idiot don excape am now him dey waka freely ehh

the next one make go happen to am na thunder from heaven direct go fire am down

den we go see which oversea country fit treat am from that one

before the guy go finish him talk
naso dem cut him call

chaiii omo people dey para o

and the man make get the interview say him go only receive 5 calls

chaiii 1 call don go e remain 4

na so the man pick another caller again
chaiii wetin we hear we no believe

all fellow nigerians make una no believe wetin this baba dey talk o
na big mad man him be

chaii na so dem run cut him call
ahhhh people won laugh kill their self wetin be this

naso dem pick the third caller
but na woman dey talk
she con say sorry sir wen was the last time u gave free educations and scholarships to even small children that are still growing up?
When?

Naso dem cut her call
but baba con reply as for the free education and scholarship come to my own town in duara
u will see children that i have given free education and scholarships

chaiiii people vex the more
this man na really mad man
so na only him people for north him dey carry free eduction and scholarships dey give abi?

See who we don go vote for chaiiii
we don die for this country

so we make no dey for north so no free eduction for us abi?
Chaii after dem go dey shout one nigeria ok no problem

the fourth caller con call
my advice is that we should all plan and stone this man to death
we no fit wait make him complete this him useless tenure o
lets beat him out of his seat
and replace him with a secondary school boy than to leave him there in power

chaiiiiii people shout
na true talk o
e better make secondary school boy dey rule this nation than make baba dey there doing notin

naso the fith caller con call
as u can see we are in a mad state of government just look at the foolish tins my own president,oh sorry ur own president because this man no fit be my president,
just look at wat he is truely saying here live in national tv
as for me and my household we go soon relocate go ghana

as for baba and him government na hot slap from heaven go soon visit una

before we know ehhh!
We see the man make dey interview baba
stand up run give baba hot slap Gbosa!

Chaiiiiii every where scatter see fight
ahhhhh mogbe wetin be this

before we know the live camera make been dey view dem off
ah ah wetin happen maybe dem don cut to dey view the interview

as we dey 2 minutes the channel come back again live

wetin we see ehhh we no believe
baba and the man make dey interview am don pull cloths
e remain only boxers their two wear dey fight live for national tv
chaiiiiii i won laugh tire
wetin be this oooooo make una saperate dem na

oboy the camera man dem
just stand dey look

ahhh everybody for rumours hotel con dey support the man make him beat craze comot for baba head

ahhhh see fight
chaiiiii baba no gree o

before we know ehhh
na so the man give baba spear like say we dey watch WWE restlemania live

chaiiiii baba faint
ahhhhh the studio scatter everybody bob

see race oooo
dem dey run dem still dey camera their run

chaiii na wetin go happen next

watch out for episode 17
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 11:24am On Aug 13, 2018
Oboy after the interview ehh
na later we con dey hear say all the 5 callers make call na from rumours hotel na him dem take make the call
chaiiii we don enter one chance o

watch out for episode 17
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 1:00pm On Aug 13, 2018
Abeg let us share the grace of the lord together church don close

since no comments me i won rest make me self go enjoy other people tori since he be like say i come here con waist my precious time no wahala

as me i dey complain why some people open their story since 2014 but dem no even finish am
just abandone the story just like that
na so me i won do now
as i dey so i don hang boot
incase una need me again me dey whatsapp 09060680788
take care
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Nobody: 3:42pm On Aug 13, 2018
Baba de try clarify ur point so dat make we (ur readers) de get d mssg wey u de try pas along... Ur write up too de confusing nd e de give us (ur readers) to undastand

1 Like

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 4:22pm On Aug 14, 2018
Asemark:
Baba de try clarify ur point so dat make we (ur readers) de get d mssg wey u de try pas along... Ur write up too de confusing nd e de give us (ur readers) to undastand

end of the story my nigga me i no do again
me go drop una the song make inspire me to stop this my tori since no comments
na davido ada o lyrics
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 4:30pm On Aug 14, 2018
[Intro]
Heyo Ecool, drop the jam, na na, Ecool
OBO, fresh on the beat
[Verse 1]
And I publish the matter for your sake, you make a man misbehave
And if na fire for fire indicate o, cos me I no no again
[Pre-Chorus]
Filomina, I know me now, you know say that was a fucking mistake
What of Carolina, that one na gold digger, chai, so me I no do again
[Chorus]
Ada o, baby you are always on my mind, I think about you all the time
Ye o, ye o, Ada o, baby true love is hard to find, makes me wanna pay the fine
Ye o, ye o, Ada o, baby you are always on my mind, I think about you all the time
Ye o, ye o, Ada o, baby true love is hard to find, makes me wanna pay the fine
[Verse 2]
Me I go fire bazuka for you sake, as me I no come to play
As Ecool dey spin am for your waist, (Ecool, dey spin am) oh baby do you feel the bass
[Pre-Chorus]
Filomina, I know me now, you know say that was a fucking mistake
What of Carolina, that one na gold digger, chai, so me I no do again
[Chorus]
Ada o, baby you are always on my mind, I think about you all the time
Ye o, ye o, Ada o, baby true love is hard to find, makes me wanna pay the fine
Ye o, ye o, Ada o, baby you are always on my mind, I think about you all the time
Ye o, ye o, Ada o, baby true love is hard to find, makes me wanna pay the fine
[Outro]
Dmw, fresh on the beat
Lika this, lika dat
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 4:41pm On Aug 14, 2018
Make una see the pre chorus verse make do me i no write again

[Pre-Chorus]
Filomina, I know me now, you know say that was a fucking mistake
What of Carolina, that one na gold digger, chai, so me I no do again

if u read the last verse for the chorus
(so me i no do again)
na that one i dey now so enjoy the old episodes i been don try drop for una i fit vex self delete this thread after all i no need am again

i still dey wonder upon say i don stop to dey drop new tori still yet i still dey see more people dey come view here
una no understand say it is over
tori me i no do again
its officialy to me over
try elsewhere thanks
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 4:59pm On Aug 14, 2018
Wat a sad way to end this
sorry to all of una make been like this my tori
but since i no get encouragement from much people here
i decided to end this all
please try and look for a better thread or story where people dey comment much and laugh away ur time there
rather than checking if i don update another episodes for here

well to me i don try enough
but me go still say am again
i never see anybody make go fit stand straight drop 11 episodes under 2 days
no be say i been compose all this tori since come save am somewhere,
but all na inspirations
as i dey type more just dey come
i no even believe say me go reach even 5 episodes self
but na quick thinking make me reach 11 in 2 days without reading or copying from anywhere
so as i still dey for my decision
abeg make una take heart o
me i don retire
but if u reason am me for don reach episode 50 by now i swear down but as bad luck take want am
i have to stop here bye and God bless thanks
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Nobody: 5:20pm On Aug 14, 2018
What a cowardly way of ending the story? are you writing the story because of encouragement? or are you writing the story because you want to improve your writing acumen and acuity? it had better you know the reason you write. have you ever asked yourself why people do not comment on your post while other contemporary threads have proliferation of scintillating comments?
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Youngzubi(m): 5:36pm On Aug 14, 2018
okafor200:
Wat a sad way to end this
sorry to all of una make been like this my tori
but since i no get encouragement from much people here
i decided to end this all
please try and look for a better thread or story where people dey comment much and laugh away ur time there
rather than checking if i don update another episodes for here

well to me i don try enough
but me go still say am again
i never see anybody make go fit stand straight drop 11 episodes under 2 days
no be say i been compose all this tori since come save am somewhere,
but all na inspirations
as i dey type more just dey come
i no even believe say me go reach even 5 episodes self
but na quick thinking make me reach 11 in 2 days without reading or copying from anywhere
so as i still dey for my decision
abeg make una take heart o
me i don retire
but if u reason am me for don reach episode 50 by now i swear down but as bad luck take want am
i have to stop here bye and God bless thanks



i can't believe this

how can you just give up on yourself,i understand how u
you'er feeling but never give up!!

now let me make it clear to you Mr akarfor200 a failure is he who fall and refuse to stand,but when u fall and stand, you'll stand with caution in other to avoid what made u fall earlier


Wat i mean is that you should try English story,forget about PIDGIN,i know what am saying just try converting the story to English or write another story entirely but it should be written in English


i wrote my first story adventure of Sam tee,bros i no blow then i wrote saint blessing which i have new plan for now,but i wasnt recognized in nairaland.com after trying my hand on two stories which didnt yield result as i expected i didnt give up,i continued cracking my brain till i came up with sex na food on 7th July


see where the story is going now

see bro nobi over night!

still your guy youngzubi

1 Like

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 5:38pm On Aug 14, 2018
Atayis:
What a cowardly way of ending the story? are you writing the story because of encouragement? or are you writing the story because you want to improve your writing acumen and acuity? it had better you know the reason you write. have you ever asked yourself why people do not comment on your post while other contemporary threads have proliferation of scintillating comments?

oga please notin like that
whether i ask my self or not
am i been paid here?
After all i just created this thread for the fun and the comments,
but since i am not gettin any i rather choose to drop it all,
and as for the stori me i no do again
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 5:45pm On Aug 14, 2018
Youngzubi:




i can't believe this

how can you just give up on yourself,i understand how u
you'er feeling but never give up!!

now let me make it clear to you Mr akarfor200 a failure is he who fall and refuse to stand,but when u fall and stand, you'll stand with caution in other to avoid what made u fall earlier


Wat i mean is that you should try English story,forget about PIDGIN,i know what am saying just try converting the story to English or write another story entirely but it should be written in English


i wrote my first story adventure of Sam tee,bros i no blow then i wrote saint blessing which i have new plan for now,but i wasnt recognized in nairaland.com after trying my hand on two stories which didnt yield result as i expected i didnt give up,i continued cracking my brain till i came up with sex na food on 7th July


see where the story is going now

see bro nobi over night!

still your guy youngzubi

so u mean say make i continue abi wat
hmmmmm me fit still reconsider sha
but as of now me i go need break
since i dey disappointed in all this guest make go con read run comot
una make do head like frog so
anyways if i still get enough encouragement me go fit still bouce back
because i still been dey wonder upon say i talk say i no do again
people still dey come con read my tori
anyhow sha na yabbing tins i dey now
make i use my eye see or catch any guest here say him won con peep abi read

u go see me run light fire for ur yansh
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Nobody: 6:12pm On Aug 14, 2018
okafor200:


oga please notin like that
whether i ask my self or not
am i been paid here?
After all i just created this thread for the fun and the comments,
but since i am not gettin any i rather choose to drop it all,
and as for the stori me i no do again
bro, don't be too aggressive. you can be writing it on a book not neccessarily on the internet. however, i will implore you not to give up. i always write in note books, hoping that one day, i will get the write-ups published.
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 6:12pm On Aug 14, 2018
Come o wetin dey happen self
why e be say everytime i enter nairaland i must dey see this thred story

fuel scarcity and the missing prick
a short story

which one be fuel scarcity and which one be missing prick?

Come o
which kind story be this one self?
Anyways e be like say the tori na wen fuel scarce well well for this our country

naso the writer take get the inspiration

hmmm me won go rest sha
anyhow e go be take care
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 6:22pm On Aug 14, 2018
Atayis:
bro, don't be too aggressive. you can be writing it on a book not neccessarily on the internet. however, i will implore you not to give up. i always write in note books, hoping that one day, i will get the write-ups published.

as for the composing and writing in a book
bros abeg me i no be writer
i just started this all for the fun of it
make everybody dey always laugh dey drop comments
so make more inspirations dey come for me

me i no be smoker or drunkard
how me i want take dey get the inspirations i need?
No be wen i come online i see people comments
the tin go dey motivate me to dey drop more episodes and jokes

i go still repeat am me i no be smoker make go fit go take sk or igbo now so i go dey get inspirations like mad

no me na my normal brain i dey use and all the inspirations dey come from as wen i dey happy
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Nobody: 6:52pm On Aug 14, 2018
okafor200:


as for the composing and writing in a book
bros abeg me i no be writer
i just started this all for the fun of it
make everybody dey always laugh dey drop comments
so make more inspirations dey come for me

me i no be smoker or drunkard
how me i want take dey get the inspirations i need?
No be wen i come online i see people comments
the tin go dey motivate me to dey drop more episodes and jokes

i go still repeat am me i no be smoker make go fit go take sk or igbo now so i go dey get inspirations like mad

no me na my normal brain i dey use and all the inspirations dey come from as wen i dey happy


I have never seen a writer that smokes to get inspiration. And I think those that fall largely on smoking-to -get-inspirations are musician but, that is based on postulation. anyways, the ball is in your and i hope to see you writing interesting stories in the future.
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by Youngzubi(m): 6:55pm On Aug 14, 2018
okafor200:


as for the composing and writing in a book
bros abeg me i no be writer
i just started this all for the fun of it
make everybody dey always laugh dey drop comments
so make more inspirations dey come for me

me i no be smoker or drunkard
how me i want take dey get the inspirations i need?
No be wen i come online i see people comments
the tin go dey motivate me to dey drop more episodes and jokes

i go still repeat am me i no be smoker make go fit go take sk or igbo now so i go dey get inspirations like mad

no me na my normal brain i dey use and all the inspirations dey come from as wen i dey happy






lol! who come dey use abnormal brain dey write

see brotherly follow ur heart nobody fit force u to write after all na man u be








goodbye!

1 Like

Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 11:57pm On Aug 14, 2018
No props i don hear una,
i don decide to come out of retirement and i go still dey update more new tori episodes for here
since e be say i just start newly so am still a learner for this game

kokoko
who be that make dey knock for my door so

na me ur guy pradioc and centino with youngzubi we con see u o
open the door na

na like so i take open door dey shine teeth

naso pradioc con tell me say make i comeout side person won talk to me

me con reason am who go con be that person make won see me this night by this time
naso i rush comeout side

before i know ehh i receive hot slap for my nech gbosa!
Chaiiiii wetin i do na
ahhhh me i shout

pradioc con say oya okafor200 kneel down there

for wetin na
wetin me i do una make una say make i kneel down so

see pradioc abi wetin be ur name self if i give u better slap ehh ur name go change to precious abi padlock


as i still dey talk
seun for nairaland con show face

centino con say see person make won see u here

chaiiii wetin consine me consine seun again na

this one make baba para con see me so for my house i hope all is well

before i know seun para
so na u be that okafor200 make
been won give me heart attack abi?

i say ahhh which kind heart attack be that one?

Naso youngzubi land me better slap for neck gbosa! Shot up there
baba dey talk u dey talk
u don craze?

Hmmmm seun con silent
so na wen i don start to dey enjoy ur tori for nairaland na that time u no say u no won do again abi?

I say ahhh so seun u self dey come read my latest episodes abi?

Naso him shout
why not?
Why i no go read am?
I no be human beign like others?
Abi i be firewood?
Me self dey try look for fun na

ahhhhh seun but why u no come push my tori baba olowo the long prick to front page na?

Seun con say as u can see u just start and u never reach a week talkless of a month
so u just won enter front page overnight ab?
U no go work hard for am?

Na later that one go happen but as of now u go need to learn big lesson for my hand with better beating

chaiiii as seun won sound craze comot for my eye naso him phone ring!

Seun pick am hello sir
wetin we here na u don see that okafor200?

Seun con say yes sir
naso the person make dey call am con say put the call for loudspeaker make i talk to that bastard

chaiiiii i don die today o who be this one again na

seun con put the call for loudspeaker

wetin i hear na okafor200?
Naso i rush say yes sir na me u dey talk to sir

him con clear throat
my name is buhari
the president of federal republic of nigeria

ahhhhh me i shout

but why buhari con dey interested for why i stop this my tori thread so?

Him continue
i been dey enjoy this ur episodes well well till wen i con dey read say u won resign abi retire

ahhhh the tin pain me no be small
that is why i con ask seun make him try locate that okafor200 make we beat craze comot for him head

because why
na wen me buhari i don dey enjoy ur tori so
na that time u no say u won con stop am
even though i been dey see how u dey yab me for ur tori
but me i still dey enjoy am
even my son yusuf been won con meet u personally make una go out for dinner
because my son is crazily in love with ur tori

now we con dey hear one of the saddest tins ever
say u won resign from posting anytin
u don craze?
Abi are u mentally ok?
Even though i am outside of the country that one no mean say my slap no go reach ur face so

ahhh naso i start to dey beg am baba abeg no vex o
na just little misunderstanding i been get with my readers and guest dem
nahim make i just won resign
but since i don hear ur voice i promise to go back abeg

baba con say u know what?
U will need to apologies to all nairalanders that have been reading and enjoying ur tori before and tell dem u are sorry

ahhhh me con tell am
i dey craze for wetin na?

Before i know ehhh centino give me better slap gbosa!
U know say me no know u and we never see before
by the time i finish with u ehhh
u go turn to filomina and bibi294

as him won give me another one
naso i shout oya i don hear me i go surely apologies
abeg make una no beat craze comot for my head o

that is good
buhari con talk

and i want it with immediate effect or else
u go smell fowl yansh

naso baba con tell seun and him boys make dem leave me
but if i disobey to post
na better beating i go chop

ahhh i thank God say dem leave me o


abeg nairalanders make una no vex o
little did i know say i just dey start and am still a learner
we all na still learners no body go tell me say him don learn finish
na big lie

abeg make una forgive ur boy okafor200 me go still dey update una more of my funny episodes

and also u make be guest i go free una
anybody now fit come read as him like wether him comment or not that one now no go be my business

me go dey focus on updating more episodes for una starting from now

abeg make una forgive baba olowo the long prick

even that mental bouncer for rumours hotel self dey vex for me

but abeg make una forgive me
i don really learn one lesson thanks
Re: Baba Olowo d Long Prick (a comedy Story For All My Niggars) by okafor200(m): 7:12am On Aug 15, 2018
Abeg una been don hear the latest news now make dey trend online?

Say osinbanjo don ban sars from operating for this our country

ahhhhhh the tin sweet me no be lie
chaiiiiii wetin those sars people
don do many guys ehhhh

u go pity for dem
now we fit waka in peace and we no go dey fear again
thank God for osibanjo

abeg make una tell buhari make travel out of the country
abeg tell am make him no bother to come back again
we no need am
we dey ok with osinbanjo
if the news been sweet u ehh
abeg drop ur comments

chaiiii bye bye for sars men

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (22) (Reply)

Rhoda / African Nerd / Out Of The Blue

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 172
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.