Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,143,348 members, 7,780,936 topics. Date: Friday, 29 March 2024 at 05:49 AM

Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. - Nairaland / General (2) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. (2180 Views)

Have You Ever Been Threatened Before? Share Your Experiences / What Broke Your Trust With Friends? Share Your Experience / Share Your Experience With Weird People You Have Encountered (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 7:35am On Aug 02, 2020
Majikman:
Lmao. .. my own nah play turn fight

For boarding school dat year
I dey jss2 ,I go dey use play slap my senior for ss1 run..
omo wen d guy catch me , e be like say him put all the slap together load me for face .
my eyes comot water ... other students con dey yarn am say why him go slap me like dat nah. I no know wetin enter me oh , from back I con go load am again ... cheiii d guy Chase me go front of hostel , nah Dere my own finish.
2seconds I dey floor dey chop premium beating ... Pple con carry d guy comot my body ... me sef still stand up dey tell am say him get luck (which luck? Nah me get luck oh )...
Since den I dey avoid fight like plague oh
Laugh wan kill me die here. E say na e get luck when dem don plaster your body.
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 7:37am On Aug 02, 2020
fobafos281:
cultists wire my coursemate slaps for UNIBEN final year cultural day but I was the one that caused the trouble and my innocent friend bore the brunt grin
Guess they were scared of me cos I'm physically huge with a menacing and stern looking face.
They thought I'm their rival
They weren't scared of you, bro. Your friend was just unfortunate.
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 7:39am On Aug 02, 2020
Dreyton36:
I don get many experience for beating na , make I just share one only

Base on the Edo boy wey i be ,one night cultists they fight and me I don sleep go because I don play ball tire

I just hear shouts , I come wake up say make I know wetin they happen outside because my house face road side

Sleep still they my eye sef , naso somebody just land me correct wood for head , my neck stiff straight up

I come try to look back , I see soldier uniform ,
Soldier : Kai move idiot

Me: oga wetin i do

Soldier: move , stupid cultist , na so slap just they enter my body from different angle

Las Las the soldier carry me go meet their oga for junction
And streetlight they there , many people they sell roasted corn there and E get this particular women wey dey always warn me to stay off her daughter

She just shout yes , beat him , he's one of them , mogbe
The rest na story
Lol. You mean the beating disconnect life wire wey dey head?
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by illicit(m): 7:42am On Aug 02, 2020
chatinent:

Lol. What did you do as retaliation?


my young bro and his friends saw him at a party, they knowingly quarrelled with him, they rough handled him and then they called me, I came with a can of grounded pepper.....

party scatter

We made him cry his eyes out Sha

cool
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 7:43am On Aug 02, 2020
illicit:



my young bro and his friends saw him at a party, they knowingly quarrelled with him, they rough handled him and then they called me, I came with a can of grounded pepper.....

party scatter

We made him cry his eyes out Sha

cool
Lol. Badt man.

1 Like

Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Nobody: 8:17am On Aug 02, 2020
chatinent:

What's this thing about being a real nigga? It's surprising how you attached bad definition to your gentlemanliness.
Lol cheesy
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by osuntokuntimmy(m): 8:20am On Aug 02, 2020
e no good to start wetin u no fit finish oooo .....loading.....
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Ejenavi18(f): 8:46am On Aug 02, 2020
chatinent:

You dey form gentle girl when we dey with you but you'll still go home and beat your siblings to stupor. Lol.
I nor dey form o, I'm always gentle as beta pikin wen I be. I nor dey beat my siblings na fight we dey fight and one person must cry.
wink
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 9:37am On Aug 02, 2020
Ejenavi18:

I nor dey form o, I'm always gentle as beta pikin wen I be. I nor dey beat my siblings na fight we dey fight and one person must cry.
wink
Smiles.
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by ThothHermes: 10:12am On Aug 02, 2020
Dew04:
You think all of us can read pidgin? I understood nothing you wrote! angry undecided
You attend DELSU you no come fit read pidgin undecided undecided
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Sparkyhayzee(m): 10:14am On Aug 02, 2020
let me write mine in pidgin too.

I remember that year for isawo comprehensive senior high school, e get one fat gal then the gal dey curse pple like mad. long story cut, na hin the gal curse me one day as per say I no even offend her, na hin my niggas push me say make I beat he'll commot her body, but me Sabi say na weight the gal go take finish me as per say the gal fat die.

Las Las, we close na hin my niggas tell me to go attack her for road me self cun mumu go. low-key the gal and her paddies self don plan how Dem go give me the beating of my lovely life.

I finally attacked the gal but she too fat, na one hand she take lock my school uniform she cun use the second hand spoil my fine boy face, she burst my lips, even tear my eyes self. I cry dat day no be small.

But I trust the really niggas wey I get, we later set the gal up I best the hell out of her life, I tore her school uniform too remain small make I even tear her bra. since then she dey fear me like mad.
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by UDUJ(m): 10:21am On Aug 02, 2020
cheesy grin cheesy Mine was in primary school in Benin City. You know when we were in primary school the girls were always bigger than the boys cheesy

There is this girl that made my primary school days a living hell. I don't know why she kept bullying me ( maybe she secretly admired me and wanted me to come closer to her and be nice to her). She kept snatching my lunch money and lunch box. I even reported to the class teacher, she was reprimanded then I had peace for sometime then she started it all over again some weeks later. There was a day I gained some courage and challenged her in class, she now said she will beat me up when school closes. Heheee if you see the slap she gave me that day hen, there was nothing I could do. She was big and a known terror in our class cheesy. We became friends later on sha cool

I saw her some years back at the airport, she was with her family ( her husband and 2 year old daughter), she was the one that called out to me and introduced me to her husband. She looked smaller now ( guyman don big na cheesy). When I remember those days I just laugh cheesy

2 Likes 1 Share

Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Nobody: 10:22am On Aug 02, 2020
ThothHermes:
You attend DELSU you no come fit read pidgin undecided undecided
about to attend...
I can understand it a little. What the op wrote is beyond me. angry
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by StephenBB(m): 11:08am On Aug 02, 2020
Dew04:
about to attend...
I can understand it a little. What the op wrote is beyond me. angry
It's like you didn't grew up in Nigeria?
Just thinking....
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Nobody: 11:14am On Aug 02, 2020
StephenBB:
It's like you didn't grew up in Nigeria? Just thinking....
I wish.. Nope! grin Pidgin was strictly forbidden while growing up.
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by StephenBB(m): 11:30am On Aug 02, 2020
Dew04:
I wish.. Nope! grin
Pidgin was strictly forbidden while growing up.
Argh!...why na?
There's no language thats more enjoyable to speak than Pidgin
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Nobody: 11:44am On Aug 02, 2020
StephenBB:

Argh!...why na?
There's no language thats more enjoyable to speak than Pidgin
Back in school, some students would unconsciously reply a teacher's question with Pidgin. smiley
I grew up with a foster family. The father was a principal; very nice but strict. wink
Soon, I would start writing like the op. grin
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Pweetyccee(f): 12:03pm On Aug 02, 2020
Fight z 4 people dat have strength ooo No be person like me were dem go beat black and blue
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by StephenBB(m): 12:16pm On Aug 02, 2020
Dew04:
Back in school, some students would unconsciously reply a teacher's question with Pidgin. smiley
I grew up with a foster family. The father was a principal; very nice but strict. wink
Soon, I would start writing like the op. grin
Chai...
You need to
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by ubcandid(m): 2:07pm On Aug 02, 2020
Palema007:
Well I never chop beating but make I share this story on behalf of an ex.

So he get this particular guy I dey do lovey dovey with that time, dude been dey do anyhow but a Belle wey dey in love I dey overlook him error., Naso one day like that sha, I visit am, guy come say make we do the do. As person wey never do am before, I bone face guy come dey yarn trash like say Na him mama give me pussy. Long story short, baba give me ultimatum, sex before next week or no relationship. Omo I vex that day ooo. I come dey ask myself wetin I dey do with this otondo, to add salt on injury, him come vex leave me for room go dey gist with him friends. Chai! Na so my papa house own enter me, park my bag, wear my shoe dey go my house around 10:45 pm. cheesy I just go home go crash on top bed.


A week later guy see me for street, guy's face be like say him jam trailer. I come pity am ask am wetin happen. Na so baba gimme story lol. That night wey I leave him place ehn, him come back inside no see me. Him come tell him friend say make them trace me come my house, naso some people jam them for street, beat them like mad come call them thieves. Chai! The beating no be here , Na him friend I pity pass, I apologise to him Sha, but as for that my ex ehn nah bitter sweet feelings for me. One part of me dey pity am, other part dey talk say good for am. Well I stayed for the relationship for a month Sha, but finally break up when he cheated. grin

That beating though grin grin I saw pictures he took ,I come dey feel for am.

but Im COLLECT? Lol

Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Mastakija(m): 4:39pm On Aug 02, 2020
B4 i tell my story i wanna ask this question
does putting leaf in a mouth infront of a deaf and dump person makes dem aggressive..
bcuz. then dat wad what we believed and then i tot twas a superstition until i tried it
i wanted to prove to someppl dat dose kind of supperstitions arent real(though i was very little den)

So den i went to a typical calabar girl lyk dat (this ones na farm dem dey go, u would obviously know through their hand,cuz it will b extremely hard) so i went and told one of my friends dat he will see dat notin will happen if i put a leaf in my moth. so i cut a leaf and held it
lyk... i dont know maybe someone had told her dat there is a guy trying to challenge her or something, i havent even put d leaf in my mouth dat she rushed to me nd started saying some stuffs (u know lyk deaf and dumb words) but then BOOM!
she just started rushing me slaps upon slaps my parents or even my teachers ive neva done to me b4, with dat her HEFTY HARD hand
i could not talk, cuz they were all laughing at me

1 Like 2 Shares

Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 9:20am On Aug 09, 2020
Mastakija:
B4 i tell my story i wanna ask this question
does putting leaf in a mouth infront of a deaf and dump person makes dem aggressive..
bcuz. then dat wad what we believed and then i tot twas a superstition until i tried it
i wanted to prove to someppl dat dose kind of supperstitions arent real(though i was very little den)

So den i went to a typical calabar girl lyk dat (this ones na farm dem dey go, u would obviously know through their hand,cuz it will b extremely hard) so i went and told one of my friends dat he will see dat notin will happen if i put a leaf in my moth. so i cut a leaf and held it
lyk... i dont know maybe someone had told her dat there is a guy trying to challenge her or something, i havent even put d leaf in my mouth dat she rushed to me nd started saying some stuffs (u know lyk deaf and dumb words) but then BOOM!
she just started rushing me slaps upon slaps my parents or even my teachers ive neva done to me b4, with dat her HEFTY HARD hand
i could not talk, cuz they were all laughing at me
It wasn't about the leaves, it was sth about disrespect.
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 9:21am On Aug 09, 2020
Sparkyhayzee:
let me write mine in pidgin too.

I remember that year for isawo comprehensive senior high school, e get one fat gal then the gal dey curse pple like mad. long story cut, na hin the gal curse me one day as per say I no even offend her, na hin my niggas push me say make I beat he'll commot her body, but me Sabi say na weight the gal go take finish me as per say the gal fat die.

Las Las, we close na hin my niggas tell me to go attack her for road me self cun mumu go. low-key the gal and her paddies self don plan how Dem go give me the beating of my lovely life.

I finally attacked the gal but she too fat, na one hand she take lock my school uniform she cun use the second hand spoil my fine boy face, she burst my lips, even tear my eyes self. I cry dat day no be small.

But I trust the really niggas wey I get, we later set the gal up I best the hell out of her life, I tore her school uniform too remain small make I even tear her bra. since then she dey fear me like mad.
Laughs.
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by Mastakija(m): 9:42am On Aug 10, 2020
chatinent:
It wasn't about the leaves, it was sth about disrespect.
dey r not well
Re: Dem Don Beat You Before? Share Your Experience. by chatinent: 11:52am On Aug 26, 2020
Lalasticlala, dominque

(1) (2) (Reply)

Peter Obi Regardless? / Governor Wike Revealed What Tinubu Told Him During The Primary's / Obadiah777 Is The New Religion Section Mod !!!

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 51
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.