safarigirl: I love the shoes I'm seeing in Nengi's box right now. So promising for Saturday Night.
Sadly, she has said she cannot dance. I would have been anticipating so much, but she dey like who go knack heels, go siddon for party.
Bright O dey like who their eye go just dey shine for the party, e go dey one corner dey judge the other housemates
Eric go knack glasses, dey one corner, while Lilo go dey dance on top him lap. Ndi otu Ike
KiddWaya and Ozo go just dey smile for one corner, but dem no go follow dey dance
Keisha go dey like JJC wey dem invite come big boys party, she sef go dey smile, dey sip drink.
Erica, Ka3na and Dorathy go dey shake yansh, dey dance dey go.
Neo, Prince and Praise go dey do dance competition.
Vee go dey shake yansh for Neo, when he is not doing choreography with Prince and Praise
Praise go dey grab yansh occasionally.
Wathoni go dey dance for corner.
Tricky go dey do barman work.
Tochi go dey do bodyguard work for Kiddwaya.
Laycon go knack glasses, dey smile at the dancing girls. But DJ go play him track, housemates go come hype am, e go enter dancefloor. E fit dey hyped for other rap artistes tracks too.
Who did I miss?  You missed old mama youngie and sour sour face |