Eadiatu's Posts
Nairaland Forum › Eadiatu's Profile › Eadiatu's Posts
1 2 (of 2 pages)
You do well my brother. Mek all of us dey support Nigerian Pidgin together. E.M. Adiatu |
[url][/url] https://www.youtube.com/watch?v=1zQ4K2NtijY |
How You Fit Get Money Tek Start Your Own Bizness To tek start your own bizness no be moi moi at all. No matter how the bizness fit small reach, the true talk be sey you go need money. The question be sey, how you fit get money tek start your own bizness and at last mek you be your own oga? Savings: The best wey to start your own bizness na make you save the money yourself. With that, you go get rest of mind as you dey do your bizness. You fit open bank account to take save the money or you fit open policy with insurance company. Before you open eye close am, you go done save beta money to take start your own biz and at last, you fitbe your own oga for life. Friends and family: The second wey to tek save money for your bizness na to go meet your friend or any one for your family.Na like this many bizness pipul tek start their own bizness. You fit dey reason am say why you need to go ask for loan from a friend or relative? The reason be sey those pipul know you wella, dem no sey you no go fit cut back. Another advantage wey dey there be sey, them no go ask you make you go bring document for your house or car to tek do collateral. Pension Fund: If e remain small mek you retire and you wan start your own bizness, you fit use your pension money or part of am tek arrange your biz. Banks: The fourth wey to take raise money tek start you won bizness na to go collect loan from bank. I beg, remember sey nothing goes for nothing o, bank go ask you mek you brink collateral and the interest wey dem go put on top no be small o. But if you fit plan you bizness well well, you go fit pay back the money wey you borrow from dem and your bizness go still dey go well. Copyright: E.M. ADIATU For more articles in Nigerian Pidgin, please visit: [url][/url]www.nigerianpidgin.com |
[url][/url] https://www.youtube.com/watch?v=M5w2NaVbbTc |
[url][/url] https://www.youtube.com/watch?v=isXwIutC2qg |
[url][/url] https://www.youtube.com/watch?v=vugFi5S_wFY |
[url][/url] https://www.youtube.com/watch?v=isXwIutC2qg |
[url][/url] https://www.youtube.com/watch?v=NuLrKMZYHCU |
[url][/url] https://www.youtube.com/watch?v=uW91hWLTEG4 |
[url][/url] https://www.youtube.com/watch?v=_MwwK__HHCE |
[url][/url] https://www.youtube.com/watch?v=3lBUctN1OCI |
https://www.youtube.com/watch?v=E5nYQDCdfaQ[url][/url] |
https://www.youtube.com/watch?v=vugFi5S_wFY[url][/url] |
How to Survive Economic Crisis Many countries are going through economic recession. With the fall in oil price, many nations are earning less than what they are earning and for sure will affect their expenses. Some countries had already devalued their currency. The simple truth is that it’s not easy to live in a country with economic crisis. What you buy yesterday make be double tomorrow due to disvalue currency and inflation. During economic crisis, food will become expensive, many will lost their job. Sometimes, they may be serious unrest in some countries which always come with looting and sometimes, even loss of lives and property. When such problems occur, the rich pays very little for it. Who pay the big price? It is the poor one. The simple truth is that you can’t control your government policies but you can certainly control what you do, how you spend your money. Here are few things you can do to survive during economic crisis. Once again, how can you survive economic crisis? Pay off All Your Debt: Do you own someone some money or you need to pay some outstanding bills, the first thing to do is to pay them. If you are owing some money in dollars. They best thing is to pay off those debt before your currency gets devalued. Surrender Your Fixed Deposit Account: Do you have a fixed deposit in your local currency, the best things to do is to terminate it, collects all your money and change the money into a more stable currency like Us dollar, Pound, or Euro. Change Your Kids School: In some countries, many parents enroll their kids in private school which are very expensive. Some private schools are affordable while some are only for the rich. During economic crisis. Please do not be ashamed to exchange your children to cheaper schools yet a school Prepare Your Food: One of the best ways to save money is to prepare your own food. It’s cheaper and healthier than buying food at restaurants. Work Online: During economic crisis, it’s possible for you to lose your job. When that happens, try to get a job online. Often time, employer pays better and you can get foreign change from that. Drink Water: Most of us spend lots of buying buying wines, soda, juice and beer. During economic crisis or when you are broke, its best to stop buying those drinks or you reduce buying them. The best drink to turn to is water. It’s cheaper and healthier than beer and other drink. Try this and you will be surprise how much money you will save for yourself. Buy Fairly Used Cloths: Instead of always buying new cloths. You can buy used cloth. They are always affordable and you can save lots of money for yourself and your family by buying them. Some people felt its look odd buying fairly used cloth. The truth is that no one will know if your cloth is new or used except you let the know. Sell what You Don’t Need: It’s wise to check your house and see things that are of value that you don’t use that your can sell of and save some money for yourself. Do you have two fridges, while not sell one and keep one. What if you have two televisions, you can sell one. In some countries, It is not unusual for people to have up to four cars in their garage. While keep four cares at home. All you need is one. You can sell off the rest and have enough money to survive economic crisis. Think Before You Buy: Often times, we focus on what we want, not what we need. If you live in a country where there is economic crisis or you just lost your job, the best thing is to buy only the few things you really need. Our goal should be to focus on three import needs in our life. Food, clothing and shelter. That is the most important thing. All other things are secondary. Impress no One: We live in a society where people love to show off. People buy things they don’t need just to prove they are humans to their work mates, friends and family. But in reality, we don’t need to prove to people we are rich. We don’t need to impress any one. If you can live your own life and only buy the few things you need, you will have enough money to do other things. Change Where You Live: If you live in a region for the rich where living condition is very expensive and you have to pay huge amount of money for your accommodation. It’s better to move to a cheaper region where you can afford the living expenses. Create Time For Your Family: It’s not easy coping with economic crisis or a lost of job. Often time, most people tends to spend more time looking for more money. They spend more time at word and as a result have little or no time for their family. The truth is that you can survive an economic crisis if you learn to live a simple life. For more articles please visit [url]www.nigerianpidgin.com [/url] |
[url][/url] https://www.youtube.com/watch?v=1KWwBBvq_hE |
Among all the country wey dey for the continent of Africa, na Nigeria be the country wey people plenty pass. Na about 180 million people dey live for Nigeria. No be one language all this 180 million people dey speak o and no be one way of life all of them get. Nigerian people get different different language wey we dey speak. Among dis language na Igbo, Yoruba, Efik, Hausa, Gun, Edo, Esan, Isoko and many many other one like that. English na the official language wey we dey use for Nigeria. That one mean say na English we dey use for school and for business. Remember say for school, our teacher dey tell us say na only English we suppose dey talk because na im be the only language wey dem accept for school. Na im make many poeple for Nigeria sabi speak English well well. Some people for Nigeria even sabi speak am pass oyinbo people wey get the language self. But because English na our official language no mean say we suppose forget our own language. Some people for Nigeria don forget their own language like Yoruba, Igbo, Efik and other one like that. Some papa and mama dem no dey speak their language with their children. Na so so┬а English dem dey speak to dem. Them believe say if dem they speak Yoruba or Efik with dem, dem no go sabi English well well. That one na big lie. Doctor people don talk say children fit learn many language and e no go affect dem at all. E good make we respect our language, make we dey speak am well well. Some people sabi speak ten language. That one mean say we fit dey speak English and our own language together. If you be papa or mama. I beg you, teach your pikin dem your own language. The fact say dem dey speak your language no mean say dem no go fit speak English well. E good make wey sabi speak plenty language. But among this language wey we dey speak for Nigeria, e get one language wey really bring all of ┬аtogether. The language bring us together pass English self, that language na Nigerian pidgin. Just imagine say you dey for one big market for Lagos. Many people like Yoruba, Hausa, Igbo, Urhobo and others like that dey buy and sell market. The truth be say no be all of them go sabi English. Which language you think say dem go use? Na pidgin dem go use. Make we talk true. Pidgin na the language wey bring all of us together. Whether we go school or we no go. Na almost all of us sabi pidgin. Pidgin na we language, e dey flow well well for our mouth. In fact, when people dey speak English with their friend and them no know the grammar wey dem go use, them go turn to pidgin sharp sharp. Just like other language like Yoruba, Igbo, Efik and other one for Nigeria dey face problem, na so pidgin dey face problem too. Some people think say Pidgin na for people wey no go school. Dem think say any body wey go school no suppose dey speak Pidgin at all. Na only English dem suppose to dey speak. That kind thinking no correct at all, language na language. No language dey for people wey no go school. E good make you dey speak Nigerian pidgin. Make you speak am and read am well well. Na our language. I beg speak pidgin make I hear you. For more Nigerian pidgin articles and poems, please visit www.nigerianpidgin.com Copyright: E.M. Adiatu |
Water No Get Enemy You fit imagine how our life go be if water no dey. How we go fit bath, Wash cloth, even cook food. To talk true, we no go even fit live, na die be that. Among all the thins wey dey for this earth, water dey among the most important thin. Doctor people don talk say e go make we dey drink water well well, In fact, some doctor say make we dey drink up 16 cup every day. Dem talk say, he good make we dey drink water wen we wake up for morning. This na the many fact about water Water Dey Give Energy Wen you feel say you no get power, e fit be sign say you suppose drink water. Because if you no drink enough water, you fit dey weak. Water go also help your heart dey pump blood well well. If You Wan Reduce Weight Doctor people done talk say water they help us reduce weight. Wen we drink water well well, our bele for fill up. E go reduce food we go chop. Instead to they drink soft drink, you fit drink water. Our Body Scientist people talk say about 60 percent of our body na water. Just reason nam say most of your own body na water. That one show say water dey very important. If we dey drink enough water, we no go dey sicki sicki. Our body go fit digest food well. Our Muscle Wen we work or do exercise, our muscle dey lose water. If we dey drink water well well, our muscle go strong kakaraka. Our Kidney Kidney dey clean our body from waste and e dey send our urine to our bladder. Water dey help our urine flow well well and make e no dey smell. Our kidney need water for am to work well. ┬аPerson wey no dey drink water well fit get sickness wey dem dey call kidney stone. Our skin Water dey reduce wrinkle and pimple from our body. To dey focus Water fit help you to dey focus for wetin you dey do. Wether na for work or na for school. As you done read now why e good to drink water well well, try make you carry water with you wen you wan do exercise. Try to dey eat plenty vegetable like tomatoe, onion, leaf, carrot because them get many water inside dem. Make you also try to dey keep water with you wen you dey work. As you read this article finish. I beg, you fit carry one cup of water make you drink? Copyright: E.M. Adiatu For more Articles, please visit www.nigerianpidgin.com |
HOW YOU FIT ENJOY YOUR RETIREMENT After many year wey you don work, wake up for early morning go work come back home weak, e good mek you retire. For some pipul, na many hour for traffic. If you sit down calculate how may hour some pipul dey spend for third mainland bridge for Lagos because of traffic, you go know say Life no easy. Mek we do small mathematics. Some people dey spend up to four hour for traffic for one day. By the time dem go retire, dem go don spend like four years of their life for traffic. Come reason say we wan calculate how many year dem go done spend for work. That one no be moi moi o. Wen time reach to retire, e suppose to be time for enjoiment. Wen you go fit sleep well and chop better food. No oga wey go dey control your life again. Na to dey collect money every month. But for some people wey don retire, dem dey feel like say their life don dey end small small. But them no suppose to dey reason like that. Retirement time suppose be good time for you. The truth be say, you fit enjoy your retirement. This article go fit help you enjoy am well well. Retirement Party: As you retire finish, e good mek you call your friend, your work mate, and your family people mek dem come joli with you. The party no need to dey big, wey you go kill cow, wey people go chop like say tomorrow no dey. Simple party done do. That one na to thank God for your life. Sit Down Mek You Enjoy Life: If you get beta money from your retirement, you no suppose do any work again. Retirement time no be when you suppose dey save money. Spend the money wey you get before you go. If na chicken dey hungry you, I beg chop am. Some time, e go mek you dey go better restaurant with your family mek you gbadun your life with dem. Take Care of Your Body: Once you don retire, you know say you no be small pikin again. E good mek you take care of your body. Dey go see doctor well well. That one go help your bodi strong kakaraka. Party: Na retirement time you go get time to go wedding and other better party well well. When you still dey work, many people go done call you for party but you no get time to go. Dis time, e good mek you dey go. But e no mean say na every party person suppose to dey go. Select the beta one wey you fit go. Help Your Pikin Them: If you get children, retirement time go give you better time to care for them well well. Even though dem go don dey on their own. In fact, dem go done marry, even get their own pikin. Try to go dey see them, dey advice them. Spend time with your grand pikin dem, e good mek you dey close to them. E dey important make┬а you no forget your wife or husband. Find time for am. Travel: He good to travel around to place where you no get time to go before. If you get money self, you fit travel go other country dem. Dat one go mek you happy. Help other Pipul: Retire time na good time to help pipul. Be like papa and mama for dem. If you don retire or you go soon retire. I congratulate you. I beg enjoi your life. Copyright: E. M. Adiatu For more articles, please visit www.nigerianpidgin.com |
Mind your own I beg mind your own Na my lane I dey No put mouth for my matter My wahala no be you matter Even if I poor, e no matter Leave me make I live my own life No be the day fem born us I beg park well, dey your own lane make I dey my own lane Mind your own, make I make my own. Copyright: E.M. Adiatu More poems and articles at www.nigerianpidgin.com |
Love No Dey Fail Na love I follow come I no say e no go fail me Na one mind I get. Na you I know. I carry my heart give you but for your own heart, Na payan e dey. E far from me no be small My friends tell me say I be mumu My mama tell me say I no get sense But na love I carry come Na one mind I get Even as you leave me, Love no go leave me People dey fail but love no dey fail Copyright: E. M. Adiatu More poems at www.nigerianpidgin.com |
Thank you Sam. More poems at www.nigerianpidgin.com |
Black and white Na black and white we be I be coffee na you be the tea Dem talk say we no be the same but the truth be say our hearts na same. We fit be be black and white But na same we be Yes, the same mind, the same heart, Na love bring us together Na the same God make us Na the same the blood we get. As Kano dey far to Lagos, Na so your place far from me. But our hearts glue together Me and you gel together Even if people dey laugh us, I no go send them Because na you I want. Na black and white we be. Na me be the coffee na you be the milk. We go dey together under one roof Border no fit separate us I beg you, if bad belle people wan spoil your mind Na deaf make you be. Na me make you dey love. I no go fall your hand. For more poems and articles, please visit www.nigerianpidgin.com Copyright: E.M. Adiatu |
Among all the country wey dey for the continent of Africa, na Nigeria be the country wey people plenty pass. Na about 180 million people dey live for Nigeria. No be one language all this 180 million people dey speak o and no be one way of life all of them get. Nigerian people get different different language wey we dey speak. Among dis language na Igbo, Yoruba, Efik, Hausa, Gun, Edo, Esan, Isoko and many many other one like that. English na the official language wey we dey use for Nigeria. That one mean say na English we dey use for school and for business. Remember say for school, our teacher dey tell us say na only English we suppose dey talk because na im be the only language wey dem accept for school. Na im make many poeple for Nigeria sabi speak English well well. Some people for Nigeria even sabi speak am pass oyinbo people wey get the language self. But because English na our official language no mean say we suppose forget our own language. Some people for Nigeria don forget their own language like Yoruba, Igbo, Efik and other one like that. Some papa and mama dem no dey speak their language with their children. Na so so┬а English dem dey speak to dem. Them believe say if dem they speak Yoruba or Efik with dem, dem no go sabi English well well. That one na big lie. Doctor people don talk say children fit learn many language and e no go affect dem at all. E good make we respect our language, make we dey speak am well well. Some people sabi speak ten language. That one mean say we fit dey speak English and our own language together. If you be papa or mama. I beg you, teach your pikin dem your own language. The fact say dem dey speak your language no mean say dem no go fit speak English well. E good make wey sabi speak plenty language. But among this language wey we dey speak for Nigeria, e get one language wey really bring all of ┬аtogether. The language bring us together pass English self, that language na Nigerian pidgin. Just imagine say you dey for one big market for Lagos. Many people like Yoruba, Hausa, Igbo, Urhobo and others like that dey buy and sell market. The truth be say no be all of them go sabi English. Which language you think say dem go use? Na pidgin dem go use. Make we talk true. Pidgin na the language wey bring all of us together. Whether we go school or we no go. Na almost all of us sabi pidgin. Pidgin na we language, e dey flow well well for our mouth. In fact, when people dey speak English with their friend and them no know the grammar wey dem go use, them go turn to pidgin sharp sharp. Just like other language like Yoruba, Igbo, Efik and other one for Nigeria dey face problem, na so pidgin dey face problem too. Some people think say Pidgin na for people wey no go school. Dem think say any body wey go school no suppose dey speak Pidgin at all. Na only English dem suppose to dey speak. That kind thinking no correct at all, language na language. No language dey for people wey no go school. E good make you dey speak Nigerian pidgin. Make you speak am and read am well well. Na our language. I beg speak pidgin make I hear you. For more Nigerian pidgin articles and poems, please visit www.nigerianpidgin.com Copyright: E.M. Adiatu |
Una do well for una comment. Other poem dey for www.nigerianpidgin.com. I beg visit this blog. E good make all of us promote Pidgin English |
Visit www.nigerianpidgin.com you can read lots of articles and poems in Nigerian pidgin. |
My Brother – A Nigerian Pidgin Poem You be my Brother, my real person Na true say no be the same mama born us but na my brother you be Na the same mind we get Yes, the same believe, the same hope Tea thick pass water but na blood thick pass You be my blood No be because say na the same mama born us but na because you be my friend Copyright: E.M. Adiatu emadiatu@yahoo.com www.nigerianpidgin.com |
Nigerian pidgin Na we language. E dey flow well well for our mouth. www.nigerianpidgin.com |
My blog is www.nigerianpidgin.com Read articles and poems in Nigeria pidgin. Please visit and drop your comment. |
www.nigerianpidgin.com is a blog to promote Nigerian pidgin. You can read many articles, poems and proverbs in Nigeria pidgin. Please visit this blog and make your comments. |
1 2 (of 2 pages)