Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization - Agriculture (2) - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Agriculture › Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization (7859 Views)
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by Mariangeles(f): 9:47pm On Sep 08, 2024 |
jidestroud:You be like one of my brothers. The guy hate okro dye! ![]() You go plant waterleaves too? I learn say e dey grow fast well-well. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by jidestroud(op): 9:55pm On Sep 08, 2024*. Modified: 7:53am On Sep 09, 2024 |
Mariangeles:For waterleaves? Plant them? Kind of sound strange to me hearing that. Although, I think I have seen where it's been grown at people's backyard. For me, waterleaves na confirm weeds on my farmlands. A few of my vegetables buyers come with sacks to help me weed them out.Dey don beg me taya make I no spray Dem and kill Dem off...once once sef, me sef dey use am freestyle Edikaikong soup. ![]() |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by Mariangeles(f): 10:10pm On Sep 08, 2024 |
jidestroud:To be honest, I don't know how they're grown intentionally. They grow wildly and rapidly on our land too in the village, according to my uncle. People wey need them dey come once once come harvest them. Na free money for those your vegetable buyers be that naa. 😀 Shey na say you no get buyers for the waterleaves? Abeg! No kill them O! I like that you grow your vegetables organically. Them go get taste well-well. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by Mariangeles(f): 10:20pm On Sep 08, 2024 |
jidestroud:Some of us that were raised in the city don't know much about farming. How did you learn? |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by MrLibrarian(m): 1:28am On Sep 09, 2024 |
Mariangeles:see this miserable liar. Tufiakwa Village girl |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by IamAsiri: 3:59am On Sep 09, 2024 |
jidestroud:They are going to sell it... and not cheaply I can assure you. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by jidestroud(op): 8:27am On Sep 09, 2024*. Modified: 11:06am On Sep 09, 2024 |
Mariangeles:I'll start by saying this favorite quote of mine; It is God's blessings deposited in man and discovered, and not just discovered but put to action that makes such a man successful in life. ![]() Grew up in the heart of Lagos, Maryland & Festac to be precised. Nevertheless, we've always produced our own garri & fufu . Na so my papa go put me for his most priced car then, a Volkswagen aka Bettle aka Ijapa car, then drive all the way to ogun state villages bordering Lagos to go arrange cassavas to be processed. All those years, no farm lands we no dey enter . I would want to believe those are the years farming activities imprinted on my destiny . Moreso, we've always kept dogs, cats, rabbits and doves as pets growing up. So all these contributed to my passion for growing both livestock & loving how mother Earth gives life to plants, so fascinating. But, the main confirmation as to me going to become a farmer, came in S.S.3 (in Federal Government College, Ijanikin, Lagos State), when God personally told me, You shall be a FARMER . Heard Him loud & clearly. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by jidestroud(op): 8:31am On Sep 09, 2024 |
IamAsiri:Obviously. But the problem for me is, how do I ask them for money for the waterleaves? When most times they see me weeding it off all the time I just allow them weed it out for me. most times I see them going with as much as 2 to 3 filled sacks. ![]() |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by Mariangeles(f): 9:24am On Sep 09, 2024 |
jidestroud:Chai! I like your story O! 😀 And your papa really really do well. Nothing pass make papa teach im pikin how to catch fish, instead of to dey only give am fish. Anyways, I go dey follow your thread sha, because e dey interesting...and I dey sabi like success stories. I hope say you no go mind if I begin ask you plenty plenty question? Like, about how many times you don harvest vegetables since wey you start? jidestroud:Waterleaves no cheap for market O. ![]() |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by Munzy14(m): 8:56pm On Sep 09, 2024 |
jidestroud:Lol... Igbo blood. Every farmer is falling back to base now..More like retreating from new projects and experiment. You are doing well with this vegetables production. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by IamAsiri: 10:19pm On Sep 09, 2024 |
jidestroud:You can look for another set of traders to sell the waterleaves to. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by jidestroud(op): 8:24am On Sep 10, 2024*. Modified: 4:23pm On Sep 10, 2024 |
IamAsiri:Lol . How I wan take sell dat one bayi? Do I sell per bags or what? ABEG... freely was it given, freely make Dem pluck am comot jare. Too much on my hands right now to want to add waterleaves plucking to it. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by jidestroud(op): 8:39am On Sep 10, 2024*. Modified: 12:38pm On Sep 10, 2024 |
Why vegetables sells faster? Just this morning, I was curious enough to ask a lady who came for just N500 vegetables. Lady: Oga, this your vegetables fresh ooo and e cheap well well. I no know say u dey sell vegetables for here o. Na one lady I see wey carry am pass direct me. Me: abi na? Wetin man go do as work no dey, and Tinubu don pursue all of us go farm back. . Anyways, now you know ooo! As you can see, vegetables dey brekete... ![]() Lady: Na here I go dey buy from today. I see say you don plant Ugu. Oga, u mean business o! And if person see u for outside, Dem go think say u be alapa ike. Me: Laughs... (Dis woman don dey use style insult me biko). Yes ooo... Ugu, Ewedu and Pepper go dey soonest. But e con be like say una too like vegetables for this area ooo? Lady: laughs... oga, u no know say na vegetables soup quick prepare cheap pass. Just buy dis kind N500 Soko wey I buy now, mix am with Panla fish or even crayfish, add Iru (locust beans), even use Ata gungun (grounded pepper), Soup don set... But the other, u go spend well o. With just 1k, vegetables soup don set. Me: haaaaaaa...(laughing stupidly). Chai...Tinubu, e fit better for u so? ... Lady: Oga u try ooo, only you dey stay dis big compound? U never marry? Me: (wetin? Dis woman don dey pass her boundaries ooo. Hmmm... I Sabi dis kind well well ooo... Before u know it, Dem go ask, wetin u con dey chop? Se make we dey bring food come for you? Etc...) No ooooo.... I even get two wives sef... ( Sebi na wetin she wan hear b that)..... .... Tori don end biko |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by Hamzashaf99(f): 8:59am On Sep 10, 2024 |
jidestroud: ![]() |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by jidestroud(op): 12:46pm On Sep 10, 2024 |
Attention Please Silly of me not to have mentioned this earlier, I always advice anyone going into crop farming to always make sure they take their Anti Tetanus injections... Very Essential!!! The rate at which I put my hands into the soils filled with decomposing manure ehn, me sef dey fear fear. , with all the pathogens chai!!! One of the reason while, I love cured manure. You never can tell if you have cuts on your hands. Oyinbo people dey use gloves ooo!!! |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by Mariangeles(f): 2:57pm On Sep 10, 2024 |
jidestroud:😀 Women dey sabi like hardworking men, na why. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by jidestroud(op): 3:47pm On Sep 10, 2024 |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by IamAsiri: 4:01pm On Sep 10, 2024 |
jidestroud:You are right. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by Mariangeles(f): 4:34pm On Sep 10, 2024*. Modified: 5:37pm On Sep 10, 2024 |
jidestroud:Money does not always equate hardworking . Some men with that mindset easily offend women. It is okay for a woman to just admire a hardworking man. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by jidestroud(op): 6:15pm On Sep 10, 2024 |
Mariangeles:I bad. Point taken. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by jidestroud(op): 12:45pm On Sep 12, 2024 |
O! Beautiful Thursday you are Ojó 'Bo or Ojó Alamisi“ This is the day on which names of the days arrived. It is a day on which Ancestors visit the family. This is why every important festival begins on Thursday- Ọjọ́ Bo / Ọjọ́ Alamisi. Woke up with a cheerful spirit, knowing fully well, it's going to be a beautiful blessed day. Just as I finished my early morning prayers to the One true God, my gate don dey make noise; gbam gbam gbam gbam!!! A fe ra Ewedu ati Soko ooo!!!. . (Make I no lie, na the bangs on the gate make me finish the prayer sharp sharp. Baba God forgive your son ooo).I got out of my small Hamlet on the farm, did a quick stretch, and screamed; I dey cooooome ooooooo, make unaaaa no break my gate because of Efo ooooo. ( walahi, my belle just dey sweet me). To cut the long story short, I was able to sell 4 Soko beds at N7,000. And about 1k Ewedu, making a total income of N8,000. Chai... Nothing will stop Iya Alaje from seeing me tonight, A plate of Cow tail pepper soup with a bottle of Pepsi (unfortunately, I don't take alcohol....chai, e pain me dieeeee). |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by jidestroud(op): 12:47pm On Sep 12, 2024 |
Pictures of the beds sold out... Firstly, My most valued asset, my 45k Crocs, my close companion...love u dieeee
|
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by Mariangeles(f): 4:44pm On Sep 12, 2024 |
jidestroud:You know, for some reason, I thought vegetables grew taller than what I'm seeing. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by IAmHim1: 5:02pm On Sep 12, 2024*. Modified: 10:20pm On Feb 26, 2025 |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by bassdow: 7:28pm On Sep 12, 2024 |
jidestroud:why not RENT land from land Owners, or OmoOnile ? Let me know if interested for land BUT you fit meet people wey get land wey dem never get money develop. Even if small foundation dey inside, e no too matter OR just meet OmoOnile |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by bassdow: 7:30pm On Sep 12, 2024 |
jidestroud: you mean say you wear 45,000 naira for LEG ? |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by jidestroud(op): 10:39am On Sep 13, 2024 |
IAmHim1:Thanks for the awareness, although my not taking alcohol wasn't born out of healthy living. I'm just a fan of Pepsi that's all. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by IAmHim1: 2:46pm On Sep 13, 2024*. Modified: 10:19pm On Feb 26, 2025 |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by jidestroud(op): 2:57pm On Sep 13, 2024 |
IAmHim1: ![]() Thanks... Didn't know a Pepsi & Cowtail pepper soup once in about 2months could make one diabetic. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by FashionCapital(m): 2:57pm On Sep 13, 2024 |
Mariangeles:Me self dey reason same thing. But probably the camera angle cus I can't even see the stems which should be thick I guess. |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by IAmHim1: 3:30pm On Sep 13, 2024*. Modified: 10:19pm On Feb 26, 2025 |
| Re: Efo Tete (african Spinach) And Efo Soko (lagos Spinach) Monetization by jidestroud(op): 3:31pm On Sep 13, 2024 |
FashionCapital:Misconception here. Like I said, the picture uploaded is from an harvested bed. Yes, those are already cut vegetables. |
Get Your Vegetables( Ugu, Shoko, Tete, Water Leaf) And Cassava For Wholesale • Edible Amaranthus Cruentus (efo Tete Pupa) Seeds And Food Grade Polyols Needed. • Dry Season Lagos Spinach (soko) For Sale In Ibadan • 2 • 3 • 4
The Most Lucrative Animal To Farm • Affordable Peanut Coating Machine Manufacturer • Garri Processing Factory, Abeokuta, Ogun State
. The last time I ate Okro soup should be back in the 90's if my memory isn't failing me. 

gbam!!!

.