Know This And Know Peace - Culture - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Culture › Know This And Know Peace (163 Views)
1 Reply
| Know This And Know Peace by ariesbull(op): 2:27pm On Aug 06, 2025 |
Know these and know peace; 1. Yahoo na stealing 2. Hook up na prostitution 3. Shisha na smoke no be sweet 4. Taskforce na agbero work 5. SA or PA to politician no be employment 6. Introduction no be marriage. 7. Cotonou na abroad 8. Say your husband dey post you no mean say him no dey cheat. 9. Popularity for Facebook no mean say you get money 10. Say INEC declare you no mean say court no go fit remove you. 11. Say you catch your wife no mean say she no go do am again. 12. Say him handsome no mean say him no dey beat woman. 13. Say she dey fast and pray no mean say she never do abortion before. 14. Say you dey call me boss, no mean say I be boss, you just wan bill me. 15. Say she fine no mean say she get better character 16. Say you dey see her fine pictures for social media no mean say she dey use iPhone (na abeg abeg send me those my pictures wey Dey your phone) 17.Say I borrow money from loan app no mean say I no get bright future👌 18.Say them send messages to all my contacts no mean say na them go repay the loan 19.Say you fine no mean say you go marry rich man or do big wedding 20.Say you no people no mean say u get connection 22.Say you and your husband Dey lie seriously for Fb on una birthdays no mean say love Dey una marriage 23.Say you dress well no mean say u don make am 24.Say u no like me no mean say God no go bless me 25.Say you dey form nawww no mean say u use one day reach where u dey today . Last last God is the greatest. |
| Re: Know This And Know Peace by Celestialsword: 3:01pm On Aug 06, 2025 |
ariesbull:Nor be who first start race dey take first Nor be who first marry dey first get pikin |
Maltina Reaffirms Commitment To Promoting Nigerian Culture Through Zazzau Durbar • The Evolution Of Media In The Digital Age: A Deep Dive • Ogbuefi Man Way Never Build House Still Go Remarry(update)