₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register β€’ Login β€’ With Google β€’ Trending β€’ Recent β€’ New

Stats: 3,326,380 members, 8,426,288 topics. Date: Sunday, 14 June 2026 at 02:15 AM

Toggle theme

Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum β€Ί Entertainment β€Ί Jokes Etc β€Ί Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! (21710 Views)

1 2 Reply (Go Down)

Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Emzymagadon(op): 7:02pm On Apr 09
For other countries like America, you go dey hear names like:
Hammer πŸ”¨
Stone πŸͺ¨
Blade βš”οΈ
Even β€œHunter” sef… dem go dey live life steady πŸ˜­πŸ˜‚

But Nigeria my country πŸ‡³πŸ‡¬β€¦

Blessing dey hustle tire 😭
Wisdom no get sense πŸ€¦πŸΏβ€β™‚οΈ
Miracle dey beg for data πŸ˜‚
Favor no see favor 🀣
Even Success never succeed πŸ’€
Owolabi sef dey find who go borrow am 1k πŸ˜­πŸ˜‚
Grace don dey do strong things wey we no understand again 😭🀣

This life no balance at all πŸ€¦πŸΏβ€β™‚οΈπŸ˜‚
Name no dey guarantee anything for this side o 😭

#ESHEUN πŸ™

JOKE BY EMZYMAGADON

Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Emzymagadon(op): 7:21pm On Apr 09
Which name una don see wey shock una pass for real life? πŸ˜‚
Drop am make we laugh small 😭
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by fmlala: 3:43pm On May 02
NIGERIA MY COUNTRY, WE NO DEY CARRY LAST
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by saintkel(m): 3:43pm On May 02
Emzymagadon:
Which name una don see wey shock una pass for real life? πŸ˜‚
Drop am make we laugh small 😭
Treasure....I even had to ask d guy if his mum discovered treasure in banana island?
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Starz825(m):
Even Faith dey doubt God cheesy
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by allabig(m): 3:44pm On May 02
Adelabu, ,,, that one no labu o
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by ChristianMuslim: 3:46pm On May 02
Oriyomi life don scatter
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Gbadugbakun(m):
Welcome to Africa. The land of untold hardship and suffering.
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Onewazobia(m): 3:49pm On May 02
Emzymagadon:
Which name una don see wey shock una pass for real life? πŸ˜‚
Drop am make we laugh small 😭
Bush, how pesin go giv him pikin Bush angry grin angry
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by karmaolu1(m): 3:49pm On May 02
Wisdom still the pray for God to give him wisdom

And he even the ask me how will he be wise
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by oyeb15: 3:49pm On May 02
Juju plenty for this side of the world .
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by NastiLord: 3:50pm On May 02
We all know there's a curse following the name Tinubu
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by DeepSight(m): 3:53pm On May 02
Emzymagadon:
Which name una don see wey shock una pass for real life? πŸ˜‚
Drop am make we laugh small 😭
Appeal-Court

xxxxxxxxx
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Franklyspeakin: 3:53pm On May 02
Brilliant wey no know book.
Emzymagadon:
Which name una don see wey shock una pass for real life? πŸ˜‚
Drop am make we laugh small 😭
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Czarugo007: 3:55pm On May 02
Emzymagadon:
Which name una don see wey shock una pass for real life? πŸ˜‚
Drop am make we laugh small 😭
I lived in Bayelsa state in 2021,names I see there shock me.names like, Kitchen(I see for notice board for one school like that),Army,Prosecutor,Lifeboat, Emergency,Table etc.try and verify please.
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Kingsasian(m): 3:57pm On May 02
Czarugo007:
I lived in Bayelsa state in 2021,names I see there shock me.names like, Kitchen(I see for notice board for one school like that),Army,Prosecutor,Lifeboat, Emergency,Table etc.try and verify please.
true, I saw people bearing madness like postman, blackman, Whiteman, Brigade etc even my late ex from there bears "Consul" as her surname.
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Harnny(m): 4:01pm On May 02
Emzymagadon:
For other countries like America, you go dey hear names like:
Hammer πŸ”¨
Stone πŸͺ¨
Blade βš”οΈ
Even β€œHunter” sef… dem go dey live life steady πŸ˜­πŸ˜‚

But Nigeria my country πŸ‡³πŸ‡¬β€¦

Blessing dey hustle tire 😭
Wisdom no get sense πŸ€¦πŸΏβ€β™‚οΈ
Miracle dey beg for data πŸ˜‚
Favor no see favor 🀣
Even Success never succeed πŸ’€
Owolabi sef dey find who go borrow am 1k πŸ˜­πŸ˜‚
Grace don dey do strong things wey we no understand again 😭🀣

This life no balance at all πŸ€¦πŸΏβ€β™‚οΈπŸ˜‚
Name no dey guarantee anything for this side o 😭

#ESHEUN πŸ™

JOKE BY EMZYMAGADON
Bro... have you been to that abroad?
Cos you will see Hammer wey drugs dey hammer am.
Stone wey dey stoned.
Blade wey don pierce everything.
Hunter being hunted by debt recovery.
Wealth wey dey live on benefit.
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Klington: 4:11pm On May 02
Tinubu brought untold hardship to Nigerians.
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Pootle: 4:14pm On May 02
a positive name does not translate to success, i know a boy named omojesu his a young adult now that boy na devil servant
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by TGreatGatsby: 4:30pm On May 02
ChristianMuslim:
Oriyomi life don scatter
The name be like whining becos the people wey I don see dey bear that name na cast o
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Excellent93(m): 4:31pm On May 02
No matter how you take offend God
No give your pikin tinubu or buhari as a name
Cause the future will curse them for what they don't know grin grin grin
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Ayo25: 4:33pm On May 02
Holiness na womaniser🀣

I use to think some parents don’t understand that the weight of the meaning of some names they give to their kids could weigh heavily on the kids in the future as most will struggle to live up to Theo names.
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by yommen:
Onewazobia:
Bush, how pesin go giv him pikin Bush angry grin angry
But things no Bush for am na. You know Bush Family? They have produced 2 American presidents already. Bush na wealth o.
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by phorget(m): 4:36pm On May 02
Pootle:
a positive name does not translate to success, i know a boy named omojesu his a young adult now that boy na devil servant
Which area abeg? I wan check wether na the same omojesu wey I sabi.
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Shantyken(m): 4:37pm On May 02
Emzymagadon:
Which name una don see wey shock una pass for real life? πŸ˜‚
Drop am make we laugh small 😭
Drinkwater

That Chelsea player that year
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Pootle: 4:37pm On May 02
phorget:
Which area abeg? I wan check wether na the same omojesu wey I sabi.
ajegunle olodi apapa, where you at
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Osariemen12: 4:38pm On May 02
You forgot to note that not all of us who bear Osariemen have wealth or has succeeded in life. In fact, the only Osariemen to become a governor in my state was ousted by the court of appeal sitting in Aduwawa to enthrone Oshiomole. Whatever Oshiomole means to the Afemai people I do not know. I am just interested in the beautiful meaning of my name and how the bearer could not complete one term in office as a governor.


What a world!
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Kennitrust(m): 4:41pm On May 02
The only sure mysteries of life is having good leaders.


Once you have a government that think more of the people welfare, you won't consider your name as any obstacles.
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by Kennitrust(m): 4:45pm On May 02
Vote tinubu out

Vote even a goat instead bringing back this man to power
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by T0BY(m): 4:52pm On May 02
For naija, Even "mercy" no mercy as you think am. Wickedness for wickedness.. craze for craze
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by udeh3(m): 4:52pm On May 02
I have a friend who's surname is Nigeria and his name is School
Re: Abroad Names Vs Nigeria Reality This Life No Balance! by daddy001: 4:53pm On May 02
A wealthy man from Bayelsa State has the surname Government.
1 2 Reply

Bovi Want To Teach Nkem Owoh And Charles Inojie How To Act.this Life No Balance β€’ Life No Balance,,,if Nepa Dey Use Generator β€’ Kenya Vs Nigeria Battle On Twitter β€’ 2 β€’ 3 β€’ 4

Lagos Conductors And Their Uniqueness. β€’ Answer And Win: Questions About Nigeria β€’ Best Jokes Of D Year.laughing Gas.