If Nigeria Animals Were On Nairaland. - Nairaland General - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › If Nigeria Animals Were On Nairaland. (464 Views)
| If Nigeria Animals Were On Nairaland. by lordmassac(op): 1:42pm On Jul 14, 2015 |
IF NAIJA ANIMALS WERE ON NAIRALAND 1. MOSQUITO’S WALL POST: Finally PHCN don off light, blood sucking things. COMMENTS: a. Shyiet, dem don on gen for my end. b. Abeg bros which area you dey? My people don fleet house. 2. DOG’S WALL POST: Na wa oh, I never even stay reach 5mins, all these Calabar people don dey eye me. *Ghost mode activated, them no go see me* escaping things on my mind. COMMENTS: - My neighbour na calabar too. The man eyes no good for where dogs dey, I go soon bite am. - Lol, guy, you dey on your own oh. 3. RAT’S WALL POST: Omo na die I dey oh. No food for my master kitchen. Na ehm books go hear am nah. Ehn think say I come dis house to watch tv abi? COMMENTS: - Your master stingy, disown am jor. - Guy, if I be you, na dat wicked master certificates I go chop sef. - you too like food 4. CHICKEN’S WALL POST: On the 1st of December, I’ll be traveling for one month, if you need my attention, abeg just enter bush, I no fit shout. All these Christmas celebrants no be am at all. COMMENTS: - No be only you oh, I dey migrate too. - My brother, your head dey dia, call me wen you dey go. - My guy, na to form bird flu o. 5. HE-GOAT’S WALL POST: Heat mood activated, any she-goat online for se’x chat? COMMENTS: - She-goat. @He-goat you’re a capital BIG fool. - He-goat. @She-goat, pretender does the worst, carry your smelling sef comot for my post jor. |
| Re: If Nigeria Animals Were On Nairaland. by pussygotlips: 1:46pm On Jul 14, 2015 |
| Re: If Nigeria Animals Were On Nairaland. by Nobody: 1:52pm On Jul 14, 2015 |
![]() |
| Re: If Nigeria Animals Were On Nairaland. by Solowande(m): 2:15pm On Jul 14, 2015 |
pus*sy 4 dey call dog bit*ch while goat go dey insult malu big fool. then, fly go call rat armed robber |
| Re: If Nigeria Animals Were On Nairaland. by lordmassac(op): 2:34pm On Jul 14, 2015 |
pussygotlips:I see una o |
10 Animals That Don’t Look Dangerous But Are Actually Deadly • If Nigeria Continues Like This, I May Have To Start Stealing • The 5 Worst Currencies In The World ( See If Nigeria Made The List) • 2 • 3 • 4
Need Diesel(AGO), Petrol (PMS) Or Kerosene, At TIANSOil,Always At Your Service • *photo* Isn't This Dangerous? • FG Suspends Comptroller-general Of Immigration
