₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,331,011 members, 8,448,228 topics. Date: Monday, 20 July 2026 at 02:01 AM

Toggle theme

Una Bye Bye!!! I No Go Ever Visit Sweden Again - Snoop Dogg - Celebrities - Nairaland

Nairaland ForumEntertainmentCelebritiesUna Bye Bye!!! I No Go Ever Visit Sweden Again - Snoop Dogg (1028 Views)

1 Reply (Go Down)

Una Bye Bye!!! I No Go Ever Visit Sweden Again - Snoop Dogg by AKPOSbaba(op): 2:45pm On Jul 27, 2015
America rappa,Snoop Dogg,don tell all him Sweden fans say make dem blame dia police pipo for di swear wey him swear say,
him no go eva visit dia biutifu kontri again.
Snoop yarn dis wan on top twitta on sunday afta Sweden police stopam for road,
arrestam go station and force am to piss for cup
sake of say dem won do test wit di piss to know weda igbo(marijuana) dey him system.
Snoop bin go do show for di university town of Uppsala Stockholm,Sweden.
Snoop later yarn say na bicos him na black man
naim make dem tritam like dat but di police pipo say na lie bicos na dia work dem just dey do.
If u check and balance am,u go blame Snoop?
For police to arrest am go station from him car and force am to piss for cup and no be say dem catcham wit igbo,naim be say dat wan pass opression.

SOURCE....http://ogakpatakpata..com/2015/07/una-bye-bye-i-no-go-ever-visit-sweden_27.html

Re: Una Bye Bye!!! I No Go Ever Visit Sweden Again - Snoop Dogg by kazmanbanjoko(m): 3:21pm On Jul 27, 2015
Did snopp dogg really say dis "pidgin english" abi na yu just add yur own swag join.
Re: Una Bye Bye!!! I No Go Ever Visit Sweden Again - Snoop Dogg by AKPOSbaba(op): 6:40pm On Jul 27, 2015
kazmanbanjoko:
Did snopp dogg really say dis "pidgin english" abi na yu just add yur own swag join.
U gat me laffing grin
Na Snoop yarn di pidgin
Snoop na Kwale boi na!
Wit d thickness of dia Smoke,u Shall know dem
Re: Una Bye Bye!!! I No Go Ever Visit Sweden Again - Snoop Dogg by Eliza5050(f): 6:46pm On Jul 27, 2015
kazmanbanjoko:
Did snopp dogg really say dis "pidgin english" abi na yu just add yur own swag join.
Loling cheesy
Re: Una Bye Bye!!! I No Go Ever Visit Sweden Again - Snoop Dogg by 2dice(m): 7:57pm On Jul 27, 2015
I love your style Op... Your head dey there like konkere
1 Reply

Gifty: I No Longer Pick Soma's CallsTayo Sobola Slams 'Whistle Blower': "I Get Car, I No Want Again"Muhammad Ali's Picture In Heaven By Snoop Dog234

PHOTOS: Seun Kuti Tattoos His Late Mum On His TummyShella B Timaya Scandal:- She Now Claims To Carry A Gun Cos Of His ThreatsOlamide And Oritsefemi Feuding Over Song Feature Fees