My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State - Politics - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Politics › My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State (1349 Views)
| My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by greatiyk4u(op): 5:09pm On Aug 11, 2015*. Modified: 5:48pm On Aug 11, 2015 |
Na so I enta my favourite bar 4 Enugu town yesterday evening 2 cool down temper after d day's struggle n hustle dat usually ends in getting feeding money dez days come jam gbege oooooo As I ordered 4 one bottle of my Favourite ORIGIN 2 neutralise my near saturated n frustrated temper come see stern looking police men in about 5 hillux van storm d area in search of boys 2 arrest..... Na so some area boys wey dey enjoy dia cigarette n chilled beer run away jumping fence n leaving behind dia girl friends all in an attempt 2 escape arrest wt many of dem sustaining injuries of various degrees. As dey storm d bar na so dey ordered every body 2 stand up n hands up wen I was yet 2 finish a glass cup of my beer......I obeyed dem oooo na so dey commanded us 2 match straight 2 d car dat we were under arrest 4 a reason dat will b disclosed 2 us @ d station wen we get dia.... As an unsuspecting n patriotic Nigerian na so I tried 2 resist arrest until dey yarn me wetin I do 2 deserve d humiliation or else I wnt move.......na so one of d police men nack me "talk true" 4. My knee Angered by dia action na so I tell d police officer say make him remember say na BUHARI dey rule now ooooooooo.........no more business as usual as I can now boast of my fundamental human right ..................hmmmmmm Na dis message put fuel 4 fire oooo so tey I was 4 d first time nearly detained after serious torture if not 4 quick intervention of friends n families Which way Nigerians?........is police truly our friend? Cc lalastiaca abeg help me 2 make defunct FP |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by Nobody: 5:09pm On Aug 11, 2015 |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by docmoses(m): 5:13pm On Aug 11, 2015 |
ma hear say dem move diz tin to fp |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by Nobody: 5:13pm On Aug 11, 2015 |
[quote author=olafisoyeibukun post=36850613][/quote] |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by greatiyk4u(op): 5:19pm On Aug 11, 2015 |
docmoses:Na envy abi my story no pure? |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by Starships4u(m): 5:19pm On Aug 11, 2015 |
B4 I read lemme comment it would neva bee a good encounter now let's continue...... |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by docmoses(m): 5:21pm On Aug 11, 2015 |
greatiyk4u:i just dah tell yhu dah truth |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by mekaboy(m): 5:30pm On Aug 11, 2015 |
How we take know say e happen? picture of u being tortured. |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by greatiyk4u(op): 5:35pm On Aug 11, 2015 |
mekaboy:I don't wanna disclose my identity 4 security reason......jst believe me |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by mekaboy(m): 6:21pm On Aug 11, 2015 |
greatiyk4u:U get identity, you no disclose am to police make them free u? |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by greatiyk4u(op): 6:50pm On Aug 11, 2015 |
mekaboy:Lolz............u trying na equate me 2 urself? |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by rifasenate11(m): 6:53pm On Aug 11, 2015 |
Following |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by Nobody: 6:59pm On Aug 11, 2015 |
Make una take am easy with my man oh. im don yarn im story. Make una condemn the thing wey happen first. No be must say person go put picture. |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by greatiyk4u(op): 7:41pm On Aug 11, 2015 |
[quote author=olafisoyeibukun post=36850613][/quote]Speechless? |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by Omololu007(m): 8:35pm On Aug 11, 2015 |
Which kin bar b dat one sef,I hav neva been arrested in a bar before in lag or ibadan |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by greatiyk4u(op): 6:18am On Aug 12, 2015 |
Omololu007:It is a norm in Enugu here ooo |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by otokx(m): 7:04am On Aug 12, 2015 |
No picture, no name of the police station, no name of the bar, bros you no try at all. |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by IbokUtoroh(m): 7:30am On Aug 12, 2015 |
no picture, are u kidding or just being a fool?
Police harrass person, n u expect d person to snap pix, naija una mumu. |
| Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by greatiyk4u(op): 2:47pm On Aug 12, 2015 |
otokx:Will u b of any help? |
Make A Sentence Wt Nigeria • Police In Igando Used Drone To Track Movement Of Militants, Lagos. PICS • LASTMA Official, Army Cadet & Police In A Brawl In Lagos Today (Pics) • 2 • 3 • 4
The Slaves Of Nigeria Politics (according To History Of Politics In Nigeria) • Part V: Premium Times Confirms List Of Stolen Wealth That I Published - Cramjone • Nigeria Or Biafra...strange Prediction 6 Months Ago