₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,346,140 members, 8,521,344 topics. Date: Thursday, 19 November 2026 at 09:30 AM

Toggle theme

My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State - Politics - Nairaland

Nairaland Forum › Nairaland General › Politics › My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State (1349 Views)

1 Reply (Go Down)

My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by greatiyk4u(op):
Na so I enta my favourite bar 4 Enugu town yesterday evening 2 cool down temper after d day's struggle n hustle dat usually ends in getting feeding money dez days come jam gbege oooooo

As I ordered 4 one bottle of my Favourite ORIGIN 2 neutralise my near saturated n frustrated temper come see stern looking police men in about 5 hillux van storm d area in search of boys 2 arrest.....

Na so some area boys wey dey enjoy dia cigarette n chilled beer run away jumping fence n leaving behind dia girl friends all in an attempt 2 escape arrest wt many of dem sustaining injuries of various degrees.

As dey storm d bar na so dey ordered every body 2 stand up n hands up wen I was yet 2 finish a glass cup of my beer......I obeyed dem oooo na so dey commanded us 2 match straight 2 d car dat we were under arrest 4 a reason dat will b disclosed 2 us @ d station wen we get dia....

As an unsuspecting n patriotic Nigerian na so I tried 2 resist arrest until dey yarn me wetin I do 2 deserve d humiliation or else I wnt move.......na so one of d police men nack me "talk true" 4. My knee

Angered by dia action na so I tell d police officer say make him remember say na BUHARI dey rule now ooooooooo.........no more business as usual as I can now boast of my fundamental human right
..................hmmmmmm
Na dis message put fuel 4 fire oooo so tey I was 4 d first time nearly detained after serious torture if not 4 quick intervention of friends n families

Which way Nigerians?........is police truly our friend?

Cc lalastiaca abeg help me 2 make defunct FP
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by Nobody: 5:09pm On Aug 11, 2015
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by docmoses(m): 5:13pm On Aug 11, 2015
ma hear say dem move diz tin to fp
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by Nobody: 5:13pm On Aug 11, 2015
[quote author=olafisoyeibukun post=36850613][/quote]
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by greatiyk4u(op): 5:19pm On Aug 11, 2015
docmoses:
ma hear say dem move diz tin to fp
Na envy abi my story no pure?
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by Starships4u(m): 5:19pm On Aug 11, 2015
B4 I read lemme comment it would neva bee a good encounter now let's continue......
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by docmoses(m): 5:21pm On Aug 11, 2015
greatiyk4u:
Na envy abi my story no pure?
i just dah tell yhu dah truth
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by mekaboy(m): 5:30pm On Aug 11, 2015
How we take know say e happen?
picture of u being tortured.
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by greatiyk4u(op): 5:35pm On Aug 11, 2015
mekaboy:
How we take know say e happen?
picture of u being tortured.
I don't wanna disclose my identity 4 security reason......jst believe me
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by mekaboy(m): 6:21pm On Aug 11, 2015
greatiyk4u:
I don't wanna disclose my identity 4 security reason......jst believe me
U get identity, you no disclose am to police make them free u?
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by greatiyk4u(op): 6:50pm On Aug 11, 2015
mekaboy:
U get identity, you no disclose am to police make them free u?
Lolz............u trying na equate me 2 urself?
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by rifasenate11(m): 6:53pm On Aug 11, 2015
Following
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by Nobody: 6:59pm On Aug 11, 2015
Make una take am easy with my man oh. im don yarn im story. Make una condemn the thing wey happen first. No be must say person go put picture.
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by greatiyk4u(op): 7:41pm On Aug 11, 2015
[quote author=olafisoyeibukun post=36850613][/quote]Speechless?
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by Omololu007(m): 8:35pm On Aug 11, 2015
Which kin bar b dat one sef,I hav neva been arrested in a bar before in lag or ibadan
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by greatiyk4u(op): 6:18am On Aug 12, 2015
Omololu007:
Which kin bar b dat one sef,I hav neva been arrested in a bar before in lag or ibadan
It is a norm in Enugu here ooo
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by otokx(m): 7:04am On Aug 12, 2015
No picture, no name of the police station, no name of the bar, bros you no try at all.
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by IbokUtoroh(m): 7:30am On Aug 12, 2015
no picture, are u kidding or just being a fool? Police harrass person, n u expect d person to snap pix, naija una mumu.
Re: My Experience Wt Nigeria Police In Enugu State by greatiyk4u(op): 2:47pm On Aug 12, 2015
otokx:
No picture, no name of the police station, no name of the bar, bros you no try at all.
Will u b of any help?
1 Reply

Make A Sentence Wt Nigeria • Police In Igando Used Drone To Track Movement Of Militants, Lagos. PICS • LASTMA Official, Army Cadet & Police In A Brawl In Lagos Today (Pics) • 2 • 3 • 4

The Slaves Of Nigeria Politics (according To History Of Politics In Nigeria) • Part V: Premium Times Confirms List Of Stolen Wealth That I Published - Cramjone • Nigeria Or Biafra...strange Prediction 6 Months Ago