What Two Chelsea Fans Were Discussing This Morning In A Taxi - Nairaland General - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › What Two Chelsea Fans Were Discussing This Morning In A Taxi (1243 Views)
| What Two Chelsea Fans Were Discussing This Morning In A Taxi by Dez80(op): 7:44am On Nov 15, 2015 |
OF ALL THE PROBLEMS IN THE WORLD AND IN THE COUNTRY, NA CHELSEA MATTER WER TWO CHELSEA FUNS FIT DISCUS DIS MORNING FOR TAXI? NA WA O *1ST FAN - WEN INT'L BREAK DEY FINISH SEF? *2ND FAN - NEXT WEEK O AND MY MIND DON DEY CUT *1ST FAN - HOW I WISH LEAGUE FOR FINISH TODAY *2ND FAN - IF LEAGUE FINISH TODAY,NA 16TH WE GO DEY O *1ST FAN - EHEN NA, WE NO GO RELEGATE AND WE CAN START AFRESH FOR NEXT SEASON *2ND FAN - BUT WE NO GO GO UCL OR EUROPA NA AND OTHER FANS GO LAUGH US TIRE *1ST FAN - E BETTER PASS MAKE WE FOR RELEGATE GO CHAMPIONSHIP *2ND FAN - CHAI, WETIN DEY HAPPEN NA? ME I GO RUN GO BARCA OR MADRID FOR NOW O *1ST FAN - NA DAT TALKATIVE MOURINHO I BLAME, HOW HIM GO CALL FOOTBALL FAKE? HOW HIM GO SAY HAZARD BETA PASS CR7? HOW HIM GO QUARREL WITH WOMAN? U SURE SAY THAT DOC EVA NO BAFF NAKED FOR BAFFROOM CURSE CHELSEA? *2ND FAN - HMMMMMM MY PEOPLE IMAGINE, SO CHELSEA PROBLEM DON BE MAJOR ISSUE? THE GODS MUST BE REALLY ANGRY UNA GOODMORNING AND HAPPY SUNDAY LALASTICLALA DO THE NEEDFUL TO EASE TENTION ABEG |
| Re: What Two Chelsea Fans Were Discussing This Morning In A Taxi by Emperortj93(m): 8:33am On Nov 15, 2015 |
Downloading laugh 7%............. |
| Re: What Two Chelsea Fans Were Discussing This Morning In A Taxi by PapaOyoyo: 10:22am On Nov 15, 2015*. Modified: 6:22am On Nov 16, 2015 |
Hehehehehehehhehehe Useless chekpe boys, dem no go discuss how Buhari go take pay Nigerians dia promised 5k |
| Re: What Two Chelsea Fans Were Discussing This Morning In A Taxi by PapaOyoyo: 10:23am On Nov 15, 2015 |
Emperortj93:The download don finish? Send me abeg, make I on my bluetooth jare |
| Re: What Two Chelsea Fans Were Discussing This Morning In A Taxi by Emperortj93(m): 10:34am On Nov 15, 2015 |
PapaOyoyo:bros no vex my network slow cont downloading laugh 28% |
| Re: What Two Chelsea Fans Were Discussing This Morning In A Taxi by Nobody: 9:27pm On Nov 15, 2015 |
Emperortj93:Na 3g u dey use? 2g for ere nogree download am.. |
| Re: What Two Chelsea Fans Were Discussing This Morning In A Taxi by Emperortj93(m): 10:01pm On Nov 15, 2015 |
WeedSeller:i kukuma upgrade go 4G still yet the laugh no gree me download Downloading laugh 49% |
| Re: What Two Chelsea Fans Were Discussing This Morning In A Taxi by PapaOyoyo: 6:24am On Nov 16, 2015 |
Emperortj93:Stop using empty hen, you no go hear. E never finish to download? |
| Re: What Two Chelsea Fans Were Discussing This Morning In A Taxi by Emperortj93(m): 7:33am On Nov 16, 2015 |
PapaOyoyo:abeg u fit borrow me ur etisalat sim?? ![]() |
| Re: What Two Chelsea Fans Were Discussing This Morning In A Taxi by PapaOyoyo: 9:57pm On Nov 16, 2015 |
Emperortj93:Mb no dey. Na wi-fi wer dey near Sambisa forest i dey use No tell person o |
| Re: What Two Chelsea Fans Were Discussing This Morning In A Taxi by olukayoday(m): 9:53am On Nov 17, 2015 |
so Mr Man you took your pen and notebook and started writing down what two jobless fellas where saying,anyway sha i no blame una na our nigerian government i blame |
Python That Eats My Neighbour's Chicken Caught Alive This Morning • Psquare Poses With Two Chelsea Stars • See The Snake That Was Killed This Morning In My Area • 2 • 3 • 4
YEAP WHATSAPP GROUP CHAT IS BEEN CREATED(Youth Employment Agriculture Programme) • Ghen Ghen!! Hon. Patrick Obahiagbon Finally Speaks About Dasukigate - • What Punishment Will Best Suit This Rat?
