Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 - European Football (EPL, UEFA, La Liga) (1692) - Nairaland
Nairaland Forum › Entertainment › Sports › European Football (EPL, UEFA, La Liga) › Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 (15092717 Views)
1 2 3 ... 1689 1690 1691 1692 1693 1694 1695 ... 22891 Reply (Go Down)
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by Chelseafan1: 10:45pm On Dec 26, 2015 |
Bimffo:Guy, make I tell u something, U and I no dey see face to face, we be like cat and rat, Mourinho and Wenger, and as I dey so, I no care at all, since u don attack me dt, u don find my wahala, if u like vex for me, make u dey squeeze ur face, wrinkles go full dere quick, u go just quick be like Costa. You better join in the fun, laugh and be happy, don't take anyone's post here too serious, no be anybody papa get Nairaland, we are all here to have fun, no be you get Chelsea, nobody sabi u, u are just a bloody Nigerian fan wey no get any recognition outside Nairaland and ur location. Loosen up dude, have fun, ignore posts u don't like, if una like make una yab me till next year, e no dey affect me one bit, u probably don't love chelseafc as much as I do but all of una go come here dey type epistles upon epistles dey form one yeye pundit wey no dey let me understand at tyms, analysis wey no pass Nairaland, una go still dey fyt dey abuse una sef, dey form yeye clique ![]() Yet, we all claim to be mature and sensible. how many times Mourinho or Abrahamovic or Hazard don come Nairaland kon read all our epistles.?? Abeg, make una free me and my goons o (Dmcdad. Barackohandso, Coded01)...make una no pour sand sand for my garri. I can be a pain in ur ass, I'm an idiiot, I'm very good at frustrating people if ur own wan too much, no one bot my phone, my data for me o, u like Chelsea, I like Chelsea, u come Nairaland, me sef come do my thing...I'm here to av fun, if u wanna make me ur enemy and decide to hiss at my posts, that's your headache, Femi doesn't give a fvvck broda. Let's relate as friends and be happy, all ds agidi ijesha don't cut it for me, I be confirm stubborn ijesha boy, if una ban me, my other monikers are on standby to take over. |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by sebod(m): 10:50pm On Dec 26, 2015 |
dmcdad:I just dey pity them really! |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dmcdad: 10:51pm On Dec 26, 2015 |
Chelseafan1:Well said bruv... ![]() ![]() ![]() You and your zillion accounts. Ban go be like music to you. ![]() |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by Bimffo(m): 10:51pm On Dec 26, 2015 |
Chelseafan1:Baba. Make I no lie You. I no fit read wet in You write. Too Long na.But I get ur last paragraph. |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by Chelseafan1: 10:51pm On Dec 26, 2015 |
dmcdad:dem say na me dey bring una come here, I think I'm the most hated Chelsea fan on this thread but do I give a fvvck?? ![]() |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dmcdad: 10:54pm On Dec 26, 2015 |
Chelseafan1:So na you be the judas for here abi? ![]() |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by Chelseafan1: 10:54pm On Dec 26, 2015 |
barackohandso:Oluwaseyi, waa dagba, waa gbo, waa to.... ![]() |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by Chelseafan1: 10:56pm On Dec 26, 2015 |
dmcdad:my own pass Judas my guy ![]() I fit list at least 5 Of my fellow Chelsea fan wey hate me/my moniker die but dem no know say den just dey frustrate for nothing Bimffo, number 1 ![]() |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by barackohandso(m): 11:01pm On Dec 26, 2015 |
Bimffo:Na so jare. That's the spirit Don't take life too serious, nobody comes out of it alive |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by barackohandso(m): 11:03pm On Dec 26, 2015 |
Chelseafan1:Amin sir You still never pay tithe oh. No use talk cover am |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by Dhelake: 11:04pm On Dec 26, 2015 |
Bimffo na correct guy oo.... His online personality just dey somehow Offline ... He is an happy go-lucky guy |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by Chelseafan1: 11:28pm On Dec 26, 2015 |
barackohandso:You no happy say I call you day before yesterday. wey u hear my sweet voice, voice wey dmcdad still dey pray make hin hear.... ![]() |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by coded01: 11:31pm On Dec 26, 2015 |
This one wey men dey sweet talk each other for phone! ![]() |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dmcdad: 11:34pm On Dec 26, 2015 |
![]() Guy na 14 years you dey take joke so oooooooo. ![]() Chelseafan1: |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dmcdad: 11:35pm On Dec 26, 2015 |
For where be that? Them sweet talk you sef same way them sweet talk barack? ![]() coded01: |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by coded01: 11:37pm On Dec 26, 2015 |
dmcdad:I no trust you... |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by barackohandso(m): 11:37pm On Dec 26, 2015 |
Chelseafan1:You get mouth jare But wait oh who dey deceive you say your voice sweet? |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by Chelseafan1: 11:37pm On Dec 26, 2015 |
dmcdad:Lol....say wetin happen, wen fresh babes boku, na man go kon dey attract me, make I die Na to hail my guy for Xmas I do ooo....I dey scroll my phone dey call my padis, I kon dey find ur number, I no c am, I don forget say I no save cos of my whatsapp privacy ![]() |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dmcdad: 11:39pm On Dec 26, 2015 |
You dey find wetin no lost. ![]() Keep looking. Chelseafan1: |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by barackohandso(m): 11:40pm On Dec 26, 2015 |
dmcdad:Dem don even add additional 14 years join am |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by dmcdad: 11:40pm On Dec 26, 2015 |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by barackohandso(m): 11:41pm On Dec 26, 2015 |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by Chelseafan1: 11:42pm On Dec 26, 2015 |
barackohandso:lol...my babe .....hahahaha, e sha no be like agbero own. |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by barackohandso(m): 11:42pm On Dec 26, 2015 |
dmcdad:Sweet talk ko pillow talk ni |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by barackohandso(m): 11:45pm On Dec 26, 2015 |
Chelseafan1:Ah Well na money wey she dey see collect from you make her talk am sha |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by chrisley024(m): 11:47pm On Dec 26, 2015 |
Bimffo:Hope airmark sees this and repents ![]() |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by Chelseafan1: 11:48pm On Dec 26, 2015 |
barackohandso:lol....my babe no dey demanding jor...na true she dey talk. |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by airmark(m): 12:04am On Dec 27, 2015 |
chrisley024:Una no go let person sleep, na to dey mention my name up and down. Depay is a condemned property as it stands. As he is beyond repair, so his present state is beyond trolling. No sane person will continue beating a dead dog. |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by chrisley024(m): 12:19am On Dec 27, 2015 |
airmark:I agree with all the above but reread what he wrote. |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by coded01: 12:28am On Dec 27, 2015 |
dmcdad: Chelseafan1: |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by bigkesh(m): 1:10am On Dec 27, 2015 |
Seriously these barca boys are derailing the thread..if you won't contribute anything (whether the trolling or the sensible one) please back off....... At least I can laugh or hiss at trolling, which one is the whatsapp- like chats on pur thread...... No be una fault, shebi na some chelsea fans bring them come........ Please guys,sensible comments abeg |
| Re: Official Chelsea Fan Thread: Club World Cup Champions 2025-2029 by Danhumprey: 8:34am On Dec 27, 2015 |
just wondering what ibime,nateevs,griffon and nihilists will be thinking when they scroll through the last 2 or 3 pages. ![]() where is nitlad sef?? ![]() |
Official Chelsea Fan Thread: Pride Of London • Offical Bayern Munich Fan Thread: 6x Champions Of Europe • Manchester United Fan thread: Forever Reds • 2 • 3 • 4
Viewing this topic: Phant0mStranger and 14 guest(s)
I actually expected that kind of reply from You. When I didn't attack You in anyway. Says so much about being a skepke fan.
Too Long na.