Share Your Experience When You Get Drunk. - Jokes Etc - Nairaland
Nairaland Forum › Entertainment › Jokes Etc › Share Your Experience When You Get Drunk. (1254 Views)
| Share Your Experience When You Get Drunk. by hardeyincah(op): 2:28pm On Jan 09, 2016 |
fellow NL! its time to confess our experience when we get drunk, let me bell the cat. I can't forget that horrid moment! I drank ecxess Campari, I was so drunk that I slept naked at the entrance of my house. to make matters worst na my landlady come wake me for morning with my jingle bell standing and ready for action...... |
| Re: Share Your Experience When You Get Drunk. by BeeBeeOoh(m): 2:49pm On Jan 09, 2016 |
Mine was d day I attended 1 big wedding like that, mehh I cum high but no b sey I high reach Most High. I drank 1 kind scotch(Alize) like that in conjunction with Star lager beer(d only beer that is ordained in heaven), wedding don dismiss & pepul don begin go I still dey shaak shayo. Mehn, I don gauge finish cum begin go enta bike reach my side. D bike man drop me, immediately police people cum double-cross(stop there! Stop there!! Una know NPF way nah) us na im me begin tear unplanned & unexpected race after fews steps(running) i cum fall enta gutter still dey race inside gutter(shayo bad), I cum reach were culvet dey begin climb out(stewpeedity) meanwhile police people don leave d bike-man wey kari me waka sef. As I tear race finish I still cum back cum meet d bike man, he begin ask me weda I kari gun or exhibit?..I said NO! He begin vex wit me, I know even know sey na army man hin be, I give am #500 2giv me change, my money na #200 but d man chop d money clean mouth was even tear me army people slap(una know d characteristics of soldier man slap nah). I kukuma begin go house cum sleep, as I wake up 2moro monin I cum notice sey I wound sef, I lost my designer watch(breitling) that day, my plain trousers tear for knee. Mehn e no easy oh, from dat day I no dey 2 shaak 2much again.. |
| Re: Share Your Experience When You Get Drunk. by Cholls(m): 2:54pm On Jan 09, 2016 |
my brother one the most memorable experience is when my nephew got drunk and started kissing our Christmas goat.........damnn |
| Re: Share Your Experience When You Get Drunk. by missdebs(f): 2:59pm On Jan 09, 2016 |
wine makes mockery of a man...spreads mat |
| Re: Share Your Experience When You Get Drunk. by donziller(m): 6:18pm On Jan 09, 2016 |
I gat no Experience 2 share so am here 2 read comment, |
| Re: Share Your Experience When You Get Drunk. by AVVS(m): 7:58pm On Jan 09, 2016 |
you ever high reach standing in the front of ya mirror saying" your are a bad guy and a sinner.. your mate don dey make millions" and wanted to slap ya reflection cos you think he's talking back? |
| Re: Share Your Experience When You Get Drunk. by Abbeytoy(m): 9:36pm On Apr 05, 2016 |
hardeyincah:U sure this is ur worst experience of alcohol? I still remember d day my cele best friend drunk and take kettle did ablution and praying like Muslim in toilet. |
| Re: Share Your Experience When You Get Drunk. by calculator123(m): 7:36pm On Apr 06, 2016 |
that day i withdrew my boss money on his behalf,went to the nearest bar to chill.never knew when i started to distribute money like babaolowo.woke up the next day,my neighbor told me i was giving 500naira each to every tom, dick and harry i saw.na so i enter gbese. |
Watch Trending Video Of A Drunk Man • Joke: Drunk Driver Busted By Tattle Tale Wife • Ladies!!! See Why You Should Not Get Drunk In A Club(picture) • 2 • 3 • 4
Latest President Buhari *picture* • Photo Of The Day [funny Pics] • Naija Parents Palava ;D