₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,325,212 members, 8,420,845 topics. Date: Friday, 05 June 2026 at 12:28 PM

Toggle theme

JUDAS And Addiction Wey Cause Him Wahala - Christianity Etc - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralChristianity EtcJUDAS And Addiction Wey Cause Him Wahala (851 Views)

1 Reply (Go Down)

JUDAS And Addiction Wey Cause Him Wahala by PidginPriest(op): 7:24pm On Mar 22, 2016
As our Judas bin Don comot before Jesus talk "Do this in memory of me" e mean se him miss priestly ordination. Him no chop last supper sef.

Na só the guy take expel himself from seminary. grin grin

But na him expel himself? Abi na Jesus expel am? Coz na Jesus send am message mek him do comot so that him no go dey when he go tell others "do this in memory of me".

Anyway, e dey clear se na money cause the chairman wahala. And na something wey him Don de do tey tey coz John 12:1-11 call am thief come talk the kain things him de do.
Habit na one thing wey suppose de careful with. E de begin with one day, then later we go se "nothing do am sef mek I try again" and before we go know one stupid act go plaster for our mind as habit and we no go see am as anything. From stealing enter insults, masturbation, fornication, dey dodge church plus prayer, lie, etc. All of them bad bad thing wey we de do na candidate for habit.

Mek we check ourselves try sabi dem places we done enter habit. We go need God to help us comot from them. Mek we no shame call them when we de talk to God and him go help us.
Re: JUDAS And Addiction Wey Cause Him Wahala by Nobody: 7:39pm On Mar 22, 2016
PidginPriest:

. . . . na true yarn you talk my broda. May God help us all.
Re: JUDAS And Addiction Wey Cause Him Wahala by PidginPriest(op): 8:26pm On Mar 22, 2016
modelmike7:
. . . . na true yarn you talk my broda. May God help us all.
Na u do pass. Mek God really de help us de go
Re: JUDAS And Addiction Wey Cause Him Wahala by PidginPriest(op): 7:57pm On Jul 12, 2017
God be our muscle
1 Reply

Do You Think It's Right Blaming Judas Iscariot For Jesus Death?Judas Iscariot Now Trending On TwitterChristians And Addiction: 5 Facts About Addiction That You Need To Understand234

Who Is Really A Sacrifial Between The Two Sons 'ISMAEL Or ISAAC'Muslims Storm Schools As Aregbesola Disclaims Hijab OrderYou Modern/moderate Muslims.