Job In Naija - Jobs/Vacancies - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Jobs/Vacancies › Job In Naija (1812 Views)
| Job In Naija by Nina4u(op): 10:23pm On Jun 01, 2017 |
I been no beg to be born Yet mai Mama push me out I been no beg for una passport Yet na Naija I bi When I come beg for job Dem say I need training So I kuku beg for training Dem say ‘Sharrap that yua mouth’ |
| Re: Job In Naija by Sapiosexuality(m): 10:38pm On Jun 01, 2017*. Modified: 10:59pm On Jun 01, 2017 |
Lol. Let me add to your poetry My mama na houseboy My papa too na houseboy Me self grow for gutter My babe say I be badluck I carry block na so I faint I eat for dream I still pay I cook food salt too much Even the hair for my jaw dey scratch me Lol. It will be fine, sis. E go better... |
| Re: Job In Naija by Nina4u(op): 10:50pm On Jun 01, 2017 |
Lol I been no beg for tribe Yet I come from awa place I been no beg for enemies Yet the next village Dem no laik us at all. When I come ask for peace Dem say we need justice So I kuku beg for justice Dem say ‘Sharrap dat yua mouth’. |
| Re: Job In Naija by Sapiosexuality(m): 11:08pm On Jun 01, 2017*. Modified: 11:37pm On Jun 01, 2017 |
Lol. Nice Ah! Na me be Okonta the village hunter I put fish for trap set for bushmeat Rat wey I set trap for chop my fish The rats for my village na agbero I roast rats for stick dem steal am I plant yam for farm dem harvest Na my village people turn to rats But naija say my suffer never mature |
| Re: Job In Naija by Akalia(m): 11:23pm On Jun 01, 2017 |
Two jonsing folks. Lol |
| Re: Job In Naija by Sapiosexuality(m): 11:29pm On Jun 01, 2017 |
Akalia:Haba! I waka pass, dem say something smell I ask them whether dem don baff today But true true..na my mouth dey smell o Naija poverty dey smell for my body I greet my papa he say make I kneel down My uncle ask if I know why, I nod my head E ask wetin? I say my mouth dey smell But na Naija make my mouth dey smell |
| Re: Job In Naija by macanthony25(m): 8:01am On Jun 02, 2017 |
Wetin sef! I no beg for religion Yet dey give me cross, say I b xian I no beg for tribe Yet dey gimme d name Ibe, say I b Igbo I come beg job for west Dem say I b Omo Ibo, say make I go my state I Come go beg for my state Dem ask me "wo sent me? " I say here na my state Dem say sharrap dat yua mouth |
| Re: Job In Naija by Sapiosexuality(m): 8:29am On Jun 02, 2017 |
Lol. This could be fun My last work after NYSC na shoe maker My name no be Musa, Kabiru or Adamu I trek sotey all my shoe get stretch mark Dem bin say I go pick money for dis Lagos But all my bank acants don get heartbreak The trouser wey I wear na rope I use for belt I too lepa I dey pick race any time I smell rain Bro Mac, you fit help me beg my village pipu? |
| Re: Job In Naija by Snitch41(m): 9:50am On Jun 02, 2017 |
No money for school fees But I try pass after dem pay After 10 weeks Enter university, I bliv say God dey Na konkiri come b d work wey we dey do Dem tell me make I join gang wey dey push Meet DG make him give me work Who send you? Na mind wey I get na im carry me come! Hin look me finish na so I about turn O God! Why wasn't I born a jap or jew |
| Re: Job In Naija by Sapiosexuality(m): 10:59am On Jun 02, 2017 |
... |
| Re: Job In Naija by Sapiosexuality(m): 10:59am On Jun 02, 2017 |
Welcome bros. I no need una radio My belle dey sing for me I no need una joke My whole life na comedy I boast I go kill me Nobody even send me I no want degree again VC where my school fees? |
| Re: Job In Naija by macanthony25(m): 2:03am On Jun 03, 2017 |
Sapiosexuality:Gimme your village pipu address ![]() |
| Re: Job In Naija by Nina4u(op): 3:25am On Jun 03, 2017*. Modified: 8:17pm On Jun 03, 2017 |
I no sabi blow English but I fit tell you say I LOVE YOU.. My Geography na kpom kpom but I sabi sayWHERE you live; na in my HEART I dey bad for History but i REMEMBER di first time i see you.. My Chemistry na zero but I can tell wetin be di REACTION when you smile I am BAD in PHYSICS but I sabi di INTENSITY of SPARK in my EYES when dey SEE you... I fit be olodo for every subject but make I tell everybody now; I go pass all subjects if di TOPIC na YOU.. |
| Re: Job In Naija by Nina4u(op): 9:28pm On Jun 04, 2017 |
Every where, Even before before for Naija Dem dey take honour Tell country people Wey do better thing dem Well done. Person do better sport Dem go take honour Tell am well done. Person write better write write Dem go take honour Tell am well done. Person play better politics Dem go take honour Tell am well done. Person do better business Na honour dem go take Tell am well done. Better every every Dem go take honour say Well done. Now di moto don enter reverse, Now Naija dey dishonour honour. Today dem go catch country person Wey dey thief Naija money, Tomorrow dem go carry am go court. Next tomorrow Court go give am bail, Case file go waka, Case go finish. Next year Di country person Go show for honour, Naija dey dishonour honour... |
| Re: Job In Naija by Nina4u(op): 9:41pm On Jun 04, 2017 |
Everywhere for Naija Na wahala. For right Na wahala. For left Na wahala. For centre sef Na wahala. Wahala full Naija... If e no be “Igbo Presidency”, E go be “Yoruba autonomy”. If e no be “Ogoni self-government”, E go be “Ijaw republic”. If e no be “Boko Haram insurgents”, E go be “former Niger Delta militants”. If e no be “cashless economy”, E go be “five thousand naira note”. If e no be “subsidy scam”, E go be “Bakassi”. If e no be dis, E go be dat. Wahala full Naija. Even inside di Villa, Wahala don enter. Madam di madam Dey for yonder Dey take treatment For belle bite. Wahala full Naija.... |
| Re: Job In Naija by Sapiosexuality(m): 10:17pm On Jun 04, 2017 |
I forget this thread. I dey come |
| Re: Job In Naija by Sapiosexuality(m): 10:31pm On Jun 04, 2017 |
If I dey lie make I baff N'aked My CV for hand I greet her ma Pikin of 20 dey look me one kind Like say I too worwor for the job Yes I worwor, na naija make me worwor I greet her again 'who dash you ma' She look me 'hiss' my body dey hot I tell her say I want submit my CV She stretch her palm I drop the thing She carry am like say na tissue paper I ask her make I dey go she form deaf The 3rd time she move her middle finger I get the message na so I waka comot For this naija I don eat different type of shi't Small pikin shi't Big person shi't My mate shi't and Craze man shi't but God dey |
| Re: Job In Naija by Nina4u(op): 4:15am On Jun 05, 2017 |
I remember Dat time for Naija Wey be say Everything we dey talk Na good luck. Musician dem Dat time na good luck. Write write people dem Dat time na good luck. Farmer dem Dat time na good luck. Fisher dem Dat time na good luck. Even trader dem Dat time na good luck. I remember How we take enter Dis good luck wahala. Now Good luck don waka, Bad luck don enter. I remember Dat time for Naija Wey be say Everything we dey talk Na good luck. I remember How we take enter Dis good luck wahala... |
| Re: Job In Naija by Nina4u(op): 4:23am On Jun 05, 2017 |
Naija people dem, Dem dey gossip gossip, Dem dey yan say Presido no dey sharp, Dem dey yan say Presido only sabi chop chop. For newspaper Dem dey write write. For radio Dem dey talk talk. For television Dem dey talk talk. Dem dey yan say Presido dey lavish money. Naija people dem, Dem don carry yan go facebook, Dem don carry yan go twitter. For blackberry sef Dem dey ping ping, Dem dey yan say Presido wife no sabi nak gramma. Di bad bad yan Wey dem dey yan be say Presido dey shack ogogoro. All na lie lie, Presido na coffee im dey drink, Presido no dey shack ogogoro, For that one Me, wey be Abatalk I go swear for Presido.... ![]() |
| Re: Job In Naija by Nina4u(op): 7:28am On Jun 05, 2017 |
Warehouses Don turn to worship houses. Companies don waka, Churches, Mosques Na dem dey now, Everybody now na prayer warrior. You need water You go borehole go buy. You need security You go police go pay. If you need light You buy generator. Petrol nko? You buy from black market. Every day, Every day Dem dey yan say 2020 na di year. Na di year Wey light go shine well well, Wey water go flow everywhere, Milk and honey sef go flow. 2020 wey dey run dey come so, Wey be like tomorrow Na im be di year Wey every every go boku, Wey better life Go yafu yafu for Naija. So we siddon dey look, Dey listen to this kin yan. Reply With Quote Sha... |
| Re: Job In Naija by AlwaysUltraPad: 11:28am On Jun 05, 2017 |
Thread for jobless Nigerians? |
| Re: Job In Naija by Sapiosexuality(m): 12:49pm On Jun 05, 2017 |
AlwaysUltraPad:Lol. Poetry in Pidgin. It's not easy. Always Ultra Pad? |
| Re: Job In Naija by Nina4u(op): 2:25pm On Jun 05, 2017 |
AlwaysUltraPad:I'm going to work right now.. Its 6.25 am I just love pidgin emglish |
| Re: Job In Naija by AlwaysUltraPad: 2:28pm On Jun 05, 2017 |
Nina4u:pidgin is the best "alternate" thing ever created out of English. How do you learn pidgin? |
| Re: Job In Naija by Nina4u(op): 2:30pm On Jun 05, 2017 |
AlwaysUltraPad:its been many years and lot of friends I had on fb that got me into it |
| Re: Job In Naija by AlwaysUltraPad: 3:19pm On Jun 05, 2017 |
Nina4u:brilliant! And I'm sure you'd learn more here on nairaland. |
| Re: Job In Naija by AlwaysUltraPad: 3:20pm On Jun 05, 2017 |
Sapiosexuality:it's not easy. Yes, that's the moniker. You like it? |
The Funny Names Of COVID-19 In Naija • These 6 Tips Will Help You Get An Ideal Job In 2018 • How I Got A Job In This RECESSION • 2 • 3 • 4
Coscharis Group Limited Graduate And Non-graduate Recruitment, October 2017 • Who Else Got Or Knows About The Interview Invite From C & I Leasing Plc • ..
