₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,699 members, 8,446,692 topics. Date: Friday, 17 July 2026 at 01:27 AM

Toggle theme

Mtv Shuga Auditions Go End Today - TV/Movies - Nairaland

Nairaland ForumEntertainmentTV/MoviesMtv Shuga Auditions Go End Today (760 Views)

1 Reply (Go Down)

Mtv Shuga Auditions Go End Today by NewsinPidgin(op):
MTV SHUGA na TV series wey dey teach about HIV/AIDS, dey fight about domestic violence and plenty plenty oda kata kata wey dey happen for our society.

Dey bin don do season 1 to 5 of the series and dem don shoot for Naija, Kenya, South Africa, and some oda African countries.

But dem dey come back our obodo Naija again for season 6 and dem bin don give notice unto dia auditions.

D open auditions bin happen for Lagos on the 12th of August, 2017 but dem come say make people wey bin no dey Lagos or wey no fit attend d video, do online contest wey be say dem go do video, act d script wey dem talk,upload am for dia Instagram page, come tag #mtvshuga and #mtvshugaaudition for the video.

The online contest bin start on d 28th of July and e dey end today wey be 23rd August, 2017.
D auditions na to get people wey go act d roles for season 6 and na only Naija people dem want and na 18+ fit do d auditions.

MTV SHUGA people don come write for dia Instagram page say d contest dey end by 11:59pm today.

So if you wan audition, you still get from now till 11:59pm. . . una goodluck o.
#confamtori

Source: http://newsinpidgin.ng/mtv-shuga-auditions-dey-end-today/

Re: Mtv Shuga Auditions Go End Today by BornnAgainChild(f): 5:14pm On Aug 23, 2017
They go still look face before them choose so no need
Re: Mtv Shuga Auditions Go End Today by gmajor10(m): 5:19pm On Aug 23, 2017
BornnAgainChild:
They go still look face before them choose so no need
Dem must look face Na, or you expect to use person
wey get Taye Taiwo face take act as playboy?

Or person with bubu physic act gym instructor.
Re: Mtv Shuga Auditions Go End Today by NewsinPidgin(op): 5:28pm On Aug 23, 2017
BornnAgainChild:
They go still look face before them choose so no need
Even if... If you get d acting tin for body, just try your luck... E fit be you o.
Re: Mtv Shuga Auditions Go End Today by NewsinPidgin(op): 5:37pm On Aug 23, 2017
gmajor10:
Dem must look face Na, or you expect to use person
wey get Taye Taiwo face take act as playboy?

Or person with bubu physic act gym instructor.
Haahahaaahahaaa... You funny die o
Re: Mtv Shuga Auditions Go End Today by gmajor10(m): 7:34pm On Aug 23, 2017
NewsinPidgin:
Haahahaaahahaaa... You funny die o
No be lie na? My sister you sef send your video, go audition I beg
Re: Mtv Shuga Auditions Go End Today by NewsinPidgin(op): 8:25pm On Aug 23, 2017
gmajor10:
No be lie na? My sister you sef send your video, go audition I beg
Me na news person na... Make I face one first abeg.
Re: Mtv Shuga Auditions Go End Today by gmajor10(m): 8:57pm On Aug 23, 2017
NewsinPidgin:
Me na news person na... Make I face one first abeg.
Oya write my story. When can the interview happen?
Re: Mtv Shuga Auditions Go End Today by NewsinPidgin(op): 10:59pm On Aug 23, 2017
gmajor10:
Oya write my story. When can the interview happen?
When you blow
Re: Mtv Shuga Auditions Go End Today by gmajor10(m): 11:23pm On Aug 23, 2017
If only you knew
1 Reply

Elderly Woman Participates In BBNaija Calabar Auditions, See Reactions"Blood Flowed, Heads Broken At Lagos BBNaija Auditions"- An Eyewitness AccountThe Crowd At The Bbnaija Auditions Is Proof Of Our Flawed Value System234

#bbnaija: Nina And Cee-c Nearly Came To Blows In The House (videos)Youngster In ‘beast Of No Nation’ Movie Now Begs For Alms In Ghana (video)Satanic Temple Threatens To Sue Netflix