Have U Heard This Before - Sports - Nairaland
Nairaland Forum › Entertainment › Sports › Have U Heard This Before (871 Views)
| Have U Heard This Before by queenxey1(op): 11:46am On Jul 11, 2019 |
1. Na person wey never see problem dey use English dey pray. 2. Book wey no gree enter head go enta exam hall 3. Goat wen get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set oh. 4.who naked no dey chuck hand for pocket...! 5. wetin concern dog wit family planning?.. 6.Na determination dey make Okada overtake trailer for road. 7. This one good, this one good na em mad man take dey gather plenty load. 8.Pikin wey go strong go strong.... No be say until dem name am Samson. 9.Na over confidence make February no complete. 10. Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start. 11.Head wey no wan think go carry load.. 12. Hand wea stay long for pocket, know say nothing de that pocket. 13. Forget Trust If trust dey, Water nor for boil Fish. 16.No matter how lizard do press-up reach, e no fit get muscle pass crocodile . 17. E de clear pimple, e de clear pimple na so bleaching de start. 18. Feel at home, feel at home na eim dae make visitor spoil remote 19. Escort me, escort me naso slave trade take start. 20. Its a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London. 21. I Sabi chop beans, I Sabi chop beans na so papa Nkiru take scatter on top bed with shiit. 22. Shit no get bone but when you match am u must Jump 23.Make I chop this guy money, Make I Chop this guy money. Na so ashawo take start oh. 24. You no need spoon and cutlery to chop slap. 25. Jollof Rice wey dey for bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro. 26. The patient dog ... Nah hungry go kill am. 27. Na I go do am later na e make fowl no fly like other birds. 28. No food for lazy man no be for pesin wey em mama get restaurants. 29. Who dey hold landlord rentage no dey fry stew way curry dey. 30. I am covered by the blood of JESUS E no mean say make u no lock door sleep oooo � |
| Re: Have U Heard This Before by ImmaculateJOE(m): 3:30pm On Jul 11, 2019 |
If I no share this one for faciibook, na hin be say I no get joy. |
| Re: Have U Heard This Before by queenxey1(op): 1:27pm On Jul 18, 2019 |
ImmaculateJOE:Lol |
| Re: Have U Heard This Before by dochenaj: 10:53pm On Jul 18, 2019 |
I have not heard a number of these before. They funny die, and most of them are actually true. |
| Re: Have U Heard This Before by MariaAngeles: 11:03pm On Jul 18, 2019 |
queenxey1:Very funny ![]() |
| Re: Have U Heard This Before by natureisgood(m): 11:49pm On Jul 18, 2019 |
queenxey1:Soooooooo Funny, ahn ahn |
| Re: Have U Heard This Before by Obainoneandonly(m): 10:04am On Jul 19, 2019 |
funny die
|
| Re: Have U Heard This Before by queenxey1(op): 10:18am On Jul 19, 2019 |
Obainoneandonly:I swear |
| Re: Have U Heard This Before by ruzell86: 11:46am On Jul 19, 2019 |
queenxey1:Lol, nice one! |
BBC Apologises After Sex Noise Was Heard In The Studio During A Live FA Cup • Have U Heard Pasuma Ft Davido – Amen • Put Sport Aside 4 Now Think Erriga Can Rap Good, You Havent Heard This Guy Rap. • 2 • 3 • 4
Olori Sharpest Tips Daily Rollover + Bankroll Of 2odds & 3odds • Cheap Fairly Used Gym Equipments, For Sale At 59 Tejuosho Street • Free
