Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,800 members, 7,817,309 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 09:57 AM

WHIZKIDEFE's Posts

Nairaland Forum / WHIZKIDEFE's Profile / WHIZKIDEFE's Posts

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) (11) (of 99 pages)

Literature / Re: My Life At DESPO By Whizkidefe by WHIZKIDEFE(m): 9:22pm On Oct 28, 2023
Just remember one Saturday night when I go Meekest side go crash.

Dis kine time, na so the boy start to play Jehovah Withness hymns for him phone.

I fess shock, con quiet dey observe am.

"wetin dey sup for here??"

The thing be say the hymns con dey play dey go - from one to another.

I just dey try process wetin dey play for my front, and questions dey enter my mind the more I dey try understand, like...

"Since when my guy convert go JW wey I no know?"

"Abi e get new JW babe when he dey learn these hymns to impress?"

" Abi somebody dey try influence my gee enta the ukoko, he no wan clear me."

Omo, I say the questions dey pile up the more I dey try think of how e dey goes.

"Oshare, wetin dey happen to you na?" I ask am, "which one be dis JW hymns you dey play dis night?"

He looked at me, shook his head and smile.

"You no go understand," he replied.

"Understand wetin?,"

"No too think am cos you no go understand," he replied.

"If na so, na e be say you go off that your hymn fess o, cos I no dey feel am at all," I replied.

"Why you go feel am before? You think say life na about to dey jam dem Wizkid, Erigga, Akon, and Kendrick Lamar all the time abi, " he look me, "listen to hymn make you dey in the spirit"

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) (11) (of 99 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.