Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,161,585 members, 7,847,464 topics. Date: Saturday, 01 June 2024 at 06:02 PM

Prayer Request - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Prayer Request (573 Views)

The Single Goal That Can Change Our Life! Prayer...<just Like Chelsea>read! / Prayer For Nigeria In Distress. / Re: Prayer 'i Hate Being A Black Woman' (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Prayer Request by afroxyz: 5:04am On Dec 15, 2012
Baba God,
For dis gate
of tears,
Na him I put
my prayer request.
Yet,
after 5 years
You still no send.

My life
be like flute,
Wey dey sound
like gen.
My heart
be like fruit,
Wey be poison
to belle.

Cloth no fit
cover my shame,
Perfume no dey
hide my odour
Cos I never
change my last name
or bring man come
knock my papa door

I be virgin,
I dey fast.
I dey choir,
be church worker
Yet runs girls
like cynthia
Come even
get husband

My pikin,
I see your
prayer requests,
and baggages
for the gate of tears,
But yes, I send.
ur husband
since 5 years.

You remember
broda luke
Wey you yab
with your friend
You say e no fit buy
tyre tube
I don make
am millionaire.

What about Seyi?
You talk say
him too short.
Becos you
From itsekiri,
You no even
gree am talk

You be virgin,
I gree.
Church worker,
E good.
But you no fit keep,
Broda chidi,
Cos ​​U̶̲̥̅̊ dey do S.​​U̶̲̥̅̊
Long skirts, no make-up.

So my pikin,
Wetin I do do?
My job
na to send husband,
Your job
na to keep am.
Na why I give you brain.
For yourself, make way.

(1) (Reply)

Serious Issue / The Sun / Men Of God Or Men Of Greed?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 6
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.