Pidgin Only - Culture - Nairaland
Nairaland Forum › Nairaland General › Culture › Pidgin Only (2571 Views)
| Pidgin Only by Phemour(op): 2:49pm On Nov 17, 2008 |
As i dey yarn say Pidgin Only, wetin i mean be say any skill wey u knw talk am, this Pidgin na our language. No hesitate to speek am oooooo Ma pal slap me in front of his date e pain me no be small. she mock me no be lie Mak i fight him or wetin u think? Yours Faithfully [size=5pt]PHEMOUR[/size] |
| Re: Pidgin Only by HOLAYINCA(m): 5:22pm On Nov 17, 2008 |
d tin be say, this our pidgin we like am n we go talk am. but wetin we wan Yarn about |
| Re: Pidgin Only by HOLAYINCA(m): 5:25pm On Nov 17, 2008 |
i guess u intro ur self to us. abi |
| Re: Pidgin Only by category(m): 6:13pm On Nov 17, 2008 |
guy try arrange one headline make we yan no be say u go come here com dey show urself abi u wan make i just dey talk like ode? wetin dey wori u self? |
| Re: Pidgin Only by Phemour(op): 7:08pm On Nov 17, 2008 |
HOLAYINCA:Intro? Ok. Ma name na PHEMOUR u fit call me Cool ma guy. lot of pidgin to come |
| Re: Pidgin Only by Phemour(op): 7:17pm On Nov 17, 2008 |
category:Ok Ma pal slap me in front of his date e pain me no be small. she mock me no be lie Mak i fight him? |
| Re: Pidgin Only by blackspade(m): 1:55am On Nov 18, 2008 |
LOL! Una no go kill me! ![]() |
| Re: Pidgin Only by Phemour(op): 12:08pm On Nov 18, 2008 |
blackspade:We no kill u ma guy ![]() |
| Re: Pidgin Only by HABAS(m): 1:38pm On Nov 18, 2008 |
@PHEMOUR nak am hammer for head |
| Re: Pidgin Only by hai4real(m): 1:44pm On Nov 18, 2008 |
MAKE YOU SLAP AM WELL WELL. NO PITTY AM AT ALL BCOZ HIM NO FIT REMOVE YOUR FEARTHER OUTSIDE AND COVA IT INSIDE. ONE LUV |
| Re: Pidgin Only by Phemour(op): 2:29pm On Nov 18, 2008 |
HABAS:I no wan do him [size=17pt]Brutality[/size]!. he be ma guy, he dey feed me when i broke ![]() |
| Re: Pidgin Only by Phemour(op): 2:35pm On Nov 18, 2008 |
hai4real:mak i no lie, dis guy pass my power, he giant pass me |
| Re: Pidgin Only by xtan(m): 4:53pm On Nov 18, 2008 |
just cut em kidneys |
| Re: Pidgin Only by Phemour(op): 5:27pm On Nov 18, 2008 |
xtan:To cut his kidney? da one is too [size=18pt]Deadful[/size] ma guy |
| Re: Pidgin Only by HABAS(m): 7:36pm On Nov 19, 2008 |
U people are too wicked. PHEMOUR forgive him |
| Re: Pidgin Only by category(m): 6:55am On Nov 20, 2008 |
guy u dey Bleep up oh! go re-arange that guy. come bak come tell us how u waka mehn! u must treat him Bleep up |
| Re: Pidgin Only by Phemour(op): 3:39pm On Nov 20, 2008 |
HABAS:I no fit forgive him the tin pain me |
| Re: Pidgin Only by HABAS(m): 8:12pm On Nov 20, 2008 |
Hire Guys Go Carry him for house |
| Re: Pidgin Only by Phemour(op): 5:37pm On Nov 21, 2008 |
HABAS:Pls u fit hire u? i go pay |
| Re: Pidgin Only by Phemour(op): 1:05pm On Nov 26, 2008 |
category:ehen i don go report him for police station |
| Re: Pidgin Only by joyblinks(f): 7:18pm On Nov 26, 2008 |
@POSTER see if u be my boyfriend i for don disboyfriend u or even go sell u give one aboki. how ur fellow boy go slap you and u no fit do anything. chei (hands on my head) u don proove say u no be man. even if na giant. u dey fear gaint? u no hear say na small david na him kill gollaiat. (i spell my gollaiat for pidgin) so make nobody crucify me well as e be say e pain you, jst enter house go cry. na my advice be that finito. |
| Re: Pidgin Only by Phemour(op): 4:53pm On Nov 29, 2008 |
joyblinks:ouch dat guy is dead just forget |
| Re: Pidgin Only by Andala: 4:25am On Dec 02, 2008 |
I don't speak pidgin ![]() |
| Re: Pidgin Only by ojimboIV: 10:12am On Dec 02, 2008 |
femo, ur pidgin dey sound like ghana pidgin, na wa o. i fear my head o. but anyhow kanda na meat. as u say u chappy tear u slap. u go don fall ya hand beyond jankara repair. u never tell us wetin u do. |
| Re: Pidgin Only by Phemour(op): 10:41am On Dec 02, 2008 |
ojimbo IV:Neva wonder ma mumsy be frm Ghana ![]() ojimbo IV:I neva do anything but i dey think maybe mak i go hire guys go carry him |
| Re: Pidgin Only by joyblinks(f): 7:53pm On Dec 02, 2008 |
u no dey shame sef carry guy go carry am? wetin u be? abi u be woman? chei. na wah oh |
| Re: Pidgin Only by H2O2: 7:58pm On Dec 02, 2008 |
Phemour:see that your pepeye mouth. you no sabi pidgin |
| Re: Pidgin Only by joyblinks(f): 8:00pm On Dec 02, 2008 |
my dear no blame am, na Ghana pidgin be that |
| Re: Pidgin Only by KnowAll(m): 2:48pm On Dec 04, 2008 |
My people wetin na feel about the people wey dem butcher like nama( nama is meat in Hausa ) for jos. |
| Re: Pidgin Only by Ibime(m): 6:35pm On Dec 04, 2008 |
O boy make you soji yaself. How man pikin go sound you, you no even make pim. If na me, I for don slap de guy, carry him babe sef add on top. Nothing nothing sha, I know say na play play slap wey him slap you. |
| Re: Pidgin Only by Hesperus(m): 6:42pm On Dec 04, 2008 |
See dis guy o! U mean say ur fellow omo boy woz u for gbangba, n u de there de look? Wey u suppose augment am wit bottle! U come de hala say d babe laff u. Shey na only laff? Small time she go begin use ya blokos roll dice, as u no fit step up! |
| Re: Pidgin Only by OBVIOUS(m): 6:47pm On Dec 04, 2008 |
i no understand weting una dey yarn jare, abi wetin. |
Nigeria Pidgin Proverbs & Their Meanings • Some Nigerian Proverbs – In PIDGIN • Nigerian Pidgin English as Our National Language? • 2 • 3 • 4
Brief Profile Of The Youngest Monarch To Ascend A Royal Throne (photos) • Why Are Isoko People Of Delta State Very Stingy? • Some Nigerian Parents Refusing To Teach Their Children Their Native Language

dat guy is dead just forget