Proverbs In Pidgin - Jokes Etc - Nairaland
Nairaland Forum › Entertainment › Jokes Etc › Proverbs In Pidgin (606 Views)
1 Reply
| Proverbs In Pidgin by hakinze00(op): 2:09pm On Jul 26, 2015 |
11 Nigerian Proverbs In Pidgin 1. When thief thief thief thief thing, e don red be that. Wahala dey o. 2. Year wey get January dey get December o. 3. No matter how snake long reach, e no fit wrap imself around palm tree from bottom to the top. 4. If needle fall inside river, dem no go fit see am pick again o. 5. Na fly wey no get Special Adviser dey follow dead body enter grave (no wonder we have so many Special Advisers in Government) 6. Do to other people wetin you want other people to do to you. 7. No matter how okro plant grow reach, e no dey tall pass who plant am. When time to harvest am reach, the owner go bend am down. 8. If woman deny man food, na man go still chop am. 9. Person wey no chop beans no dey poo beans o. 10. Dem say love is blind. If blind person lead another blind person, both of them go fall inside pit. 11. Na people wey dey use Mace fight for assembly Mace go tear head, no be me wey siddon jeje for my house. Oya, spice it up by adding yours |
| Re: Proverbs In Pidgin by MRLINGTON(m): 2:11pm On Jul 26, 2015 |
lool |
| Re: Proverbs In Pidgin by importexpert(m): 2:21pm On Jul 26, 2015 |
lovely compilations. |
PROVERBS IN PIDGIN. Number 10 Will Wow You • Funny Nigerian Proverbs In Pidgin. • Funny Nigerian Pidgin Proverbs And Their Loose Translations ... • 2 • 3 • 4
Nigeria´s Latest Website • Warri Version Of Psalm21 • (photo):when Employers Want You To Have 10yrs Job Experience before 22yrs