₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,325,362 members, 8,421,550 topics. Date: Saturday, 06 June 2026 at 03:57 PM

Toggle theme

Pidgin Proverbs - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland ForumEntertainmentJokes EtcPidgin Proverbs (970 Views)

1 Reply

Pidgin Proverbs by deparagon(op): 9:21am On Mar 19, 2016
1. Na for old age ashawo dey knw the value
of pikin.


2. Woman wey never see problem... Na im
dey still hold breast run.


3. Woman wey dey find pikin no dey wear
pant sleep.

4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later e
go hear am.

5. Na for afternoon dem dey find black goat.

6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay
boiled egg.

7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.

8. Pikin wey him mama back cross water, wey
say him march fish, wetin him mama go
march?

9. Small pikin wey dem carry for back no
know say the journey far.

10. Person wey don faint before no be
stranger to death.

11. Person wey chop belle full, no know wetin
hungry man dey see.

12. No be as woman dey close eye enjoy sex
she dey enjoy labour pains.

13. Yansh no get teeth but e dey cut shit.

14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if
nobody hail am!! é go hail himself

15. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND,
SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.

16. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.

17. Na cricket tell him children say, No matter
how ground strong, Them no go sleep outside.

18. Pikin wey say him mama no fine they use
style call him papa blind man.

19. No be eye wey dem take chop eba dem
take dey share meat.

20. Person wey use Elephant set trap, na him
know wetin he wan Catch.

21. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.

22. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS,
BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW
BOOK.

23. Dem no dey tell tortoise say race don start.

24. Dem no dey tell blind man say salt no dey
for food.

25. Before you see monkey, monkey don see
you.

26. Thief wey jump fence enter house where
owner dey wait for am, no go jump again.

27. If pikin say he sabi die, him papa sef go
tell am say him sabi bury.

28. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im
dey kill am.

29. If e be like say everybody dey craze" na
you dey craze.

30. Meat wey you dey forbid, no use your
teeth cut am.

31. My thing and our thing no be the same oh.
1 Reply

Nigeria Pidgin ProverbsSome Common Nigerian Pidgin Proverbs*some Laffable Warri Pidgin Proverbs To Forget Recession234

Read This And Put A Smile On Your Face.Caption This Photo Of A Kid Disappointed With The Present GovernmentIs This Uncle Wicked?