₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,325,153 members, 8,420,577 topics. Date: Friday, 05 June 2026 at 03:41 AM

Toggle theme

Proverbs In Pidgin. - Business - Nairaland

Nairaland ForumNairaland GeneralBusinessProverbs In Pidgin. (451 Views)

1 Reply

Proverbs In Pidgin. by VALENTINOEREAK(op): 2:27pm On Feb 20, 2017
PROVERBS IN PIDGIN.
1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin.
2. Woman wey never see problem na im dey still hold breast run.
3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep.
4. Rat wey follow lizard enter rain, na later é go hear am.
5. Na for afternoon dem dey find black goat.
6. Weather hot!! E no mean say fowl go lay boiled egg.
7. Eye wey dey cry dey see road.
8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him march fish, wetin him mama go march?
9. Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far.
10. Person wey don faint before no be stranger to death.
11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see.
12. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy labour pains.
13. Yansh no get teeth but e dey cut shit.
14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail am, e go hail himself.
15. If girl take husband do boyfriend, she go take boyfriend do husband.
16. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.
17. Na cricket tell him children say, No matter how ground strong, dem no go sleep outside.
18. Pikin wey say him Mama no fine dey use style call him Papa blind man.
19. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat.
20. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan catch.

Re: Proverbs In Pidgin. by saintikechi(m): 3:51pm On Feb 20, 2017
nice one
1 Reply

Bill Gates Speaks Pidgin English On BBC (Video)World Richest Man, Bill Gates Speaks PidginOyinbo Man Spotted In Nigeria Pricing Banana In Fluent Pidgin English234

Potential Security Alert For Cloudflare DOS ProtectionNew On D BlockHow Can I Make Money From Internet