Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,736 members, 7,817,029 topics. Date: Friday, 03 May 2024 at 11:42 PM

���� WARRI_PROVERBS ���� - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / ���� WARRI_PROVERBS ���� (698 Views)

(2) (3) (4)

(1) (Reply)

���� WARRI_PROVERBS ���� by aflovic: 12:22pm On Aug 14, 2019
1. Na person wey never see problem dey use English dey pray.�

2. Book wey no gree enter head go enta exam hall ���

3. Goat wen get mind follow lion go catch fish, make e know say weda dem catch fish or not, Lion food don set oh.

4.who naked no dey chuck hand for pocket...!

5. wetin concern dog wit family planning?..

6.Na determination dey make Okada overtake trailer for road.

7. This one good, this one good na em mad man take dey gather plenty load.

8.Pikin wey go strong go strong.... No be say until dem name am Samson.

9.Na over confidence make February no complete.

10. Do you know who I am? Do you know who I am?..Naso hold up take dey start.

11.Head wey no wan think go carry load..

12. Hand wey stay long for pocket, know say nothing de that pocket.

13. Forget Trust ��� If trust dey, Water nor for boil Fish.

16.No matter how lizard do press-up reach, e no fit get muscle pass crocodile �. ✌

17. E de clear pimple, e de clear pimple na so bleaching de start.

18. Feel at home, feel at home na eim dae make visitor spoil remote ��

19. Escort me, escort me naso slave trade take start.

20. It's a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.

21. Christianity is free, but you must buy Bible

22. Person nor dey use shame chop winch o

23.Make I chop this guy money, Make I Chop this guy money. Na so ashawo take start oh.

24. You no need spoon and cutlery to chop slap.

25. Jollof Rice wey dey for bottom of pot 2day go dey for top of cooler 2moro.

26. The patient dog �... Nah hungry go kill am.

27. Na I go do am later na e make fowl no fly like other birds.

28. No food for lazy man no be for pesin wey em mama get restaurants.

29. Who dey hold landlord rentage no dey fry stew way curry dey.

30. I am covered by the blood of JESUS E no mean say make u no lock door sleep oooh ��
31.) Pastor wey dey pray for mad person no dey Close eye.

32.) I need pikin, I nepost ikin, na e make woman no wear pant sleep.

33.) I know too much, i know too much na e make SAN no fit recite National Anthem.

34.) This write up good, this write up good, na e make me (the writer) no come know how to count 1,2,3 again.

35.) The tin wey make egg strong for port nai make yam also soft for port

36.) Pikin way Say e mama no sleep, he self no go sleep.

37.) Sun 2 hot e nor mean say fowl go Lay boiled egg.

38.) Monkey smart monkey smart, nah because tree near tree

39.) Na run wey nor serious, Na in woman de hold breast.

40.) Na cooperation dey make rice full pot

41.) Cockroach wey say him sabi acrobatic dance where cocks are doing general meeting don waka kurukere waka

42.) Say Lion dey sick, no mean say him wit cat na mate.

43.) This burial rich, this burial rich, na e make to die hungry elders

44.) This writeup sweet you, this writup sweet, no mean say you no go like � my page and share this post make your friends laugh join.

2 Likes 1 Share

(1) (Reply)

Best Whatsapp TV Ever Hahahah / See The Video Of What Boys Do To Girls When They Agrees To Sleep Over � / Work Out Gone Wrong��...

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.