Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,151,242 members, 7,811,681 topics. Date: Sunday, 28 April 2024 at 05:06 PM

My Weed Experience - Crime - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Crime / My Weed Experience (4166 Views)

Man High On Weed Caught Smoking By Police (Photos) / Man Arrested With 114 Bags On Weed In Ogun State (photo) / Policeman Shares Photos Of Girls Smoking Weed, Says "Say No To Drugs" (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (Reply) (Go Down)

My Weed Experience by Nobody: 8:21pm On May 28, 2020
Evening to you all o me just wan yarn you my bitter lesson from weed stay tuned...

Me and my guys na cigar we dey always smoke
before o naso we graduate to weed o shocked, first time I try am like this he sweet me die I no fit forget those times chai.He con be our culture to dey smoke weed everyday liedis at least 2bags a day,if I dey my house my guys go just text me for Whatsapp say Weed don dey ground naso I go comot with full speed go their side, we go tidy am but those time we never sabi mole weed na one of my guys friend dey help us roll am sha cool
Then smoking go con begin omo see CLOUD shocked chai, naso one of us dey try roll weed o and he get am omo see happiness no need to call anyone again to help us mole lolz.
Anyday we buy weed liedis I Dey try to learn roll but I no sabi at all he dey always pain me, anyways we go to bunk as-usual our smoking spot we throw cloud again grin as time goes on naso mesef start to dey roll weed o cheesy I con dey post for Whatsapp Dey form Big Boy I no no say I dey play with my life the matter long....


TO BE CONTD...

Re: My Weed Experience by illicit(m): 8:22pm On May 28, 2020
Roll it and enjoy ur roller coaster ride....

1 Like

Re: My Weed Experience by JasonScoolari: 8:23pm On May 28, 2020
smiley
Re: My Weed Experience by overdrive(m): 8:24pm On May 28, 2020
Following.
Re: My Weed Experience by Nobody: 9:44pm On May 28, 2020
I shall continue tomorrow... Sweet dreams
Re: My Weed Experience by Olabode971(f): 1:28am On May 29, 2020
I don buy popcorn.. oya, am follows grin
Re: My Weed Experience by TheSourcerer: 2:37am On May 29, 2020
Following.....
Re: My Weed Experience by elchapoo: 4:21am On May 29, 2020
Ok
Re: My Weed Experience by Jakumo(m): 6:15am On May 29, 2020
If you are smoking large amounts of weed, then the quality of your product must be very poor. Potent natural grown weed, with no chemicals, does NOT need to be consumed in large quantities. One single hit ( inhalation) of some seriously powerful cannabis, will send most mortals into the stratosphere for several hours, during which the astronaut will have NO desire to ingest any more.

The low quality dirt weed that is sold in Nigeria, is often contaminated with dangerous chemicals, so buyers need to exercise due diligence, to ensure that they do not inhale poisonous chemicals in a bid to get high.

The solution : Grow your own, in a secret location.

12 Likes

Re: My Weed Experience by Nobody: 9:30am On May 29, 2020
Olabode971:
I don buy popcorn.. oya, am follows grin
Naso I become Pablo Escobar o every day and night na smoke then my red lips starts turning black shocked my light skin starts changing too, na only me dey smoke now for my place but some times my guys go call me make we go to party na skusii and weed we go dey take, when I get home liedis na sleep straight chai...
Na that time I no serious again I dey move with smokers, now I con introduce am to my gf, anytime she visits me liedis I go give her weed make she smoke after that omo see knacking person wey no sabi knack before she con dey do like Mia Khalifa shocked omo I surprise o
I con realize say things no dey go well again o and I Dey try stop am but anytime I Dey see my guys I go still smoke o, I remember one dey wey I smoke like that one woman for my area dey ask me shey I sick ni
I don’t know I’m on the road to MADNESS cry
The matter long.....

TO BE CONTD.

3 Likes

Re: My Weed Experience by Nickshrapnel: 11:19am On May 29, 2020
Like every other drugs out there, do not abuse

1 Like

Re: My Weed Experience by DeusMagnus: 11:49am On May 29, 2020
Complete your story before dropping links everywhere. Don't bring us here and he giving us half half gist.
Re: My Weed Experience by Nobody: 12:01pm On May 29, 2020
Guy wetin happen na continue na
Re: My Weed Experience by Jakumo(m): 12:28pm On May 29, 2020
In my capacity as the official biographer of our man Mr. Nobody, let me continue his story in fluent broken language, that can easily be followed by Nairaland's Area Boys and Area Girls.

One day be one day when Mr. Nobody just use credit collet one parcel of Ogbomosho Yanga Bush, put am for pocket begin dey wakka go house, na from there police patrol when dey pass, come smell am from inside dem moto, before dem come jump down begin dey pursue Mr. Nobody, gbudu-gbudu-gbudu.

Mr. Nobody no kukuma wait to ask any queshon. As him see say police don dey run face am, na so hin sef pick race, begin dey pass all corner-corner when he sabi for that area, say make police dem no see chance fire am for leg.

In short, na Papa God save Mr. Nobody dat day, because, as him dey run 440 because of police, na so the parcel of Ogbomosho Yanga Bush come throway for inside him pocket. As the packet of Yanga Bush fall for ground, gbosaa, BIGI police dog, when remain small to cash Mr. Nobody, come divert to collect that exhibit for ground, and turn back to go give hin oga, Sgt. Dongoyaro, dat wicked oga polisi when get red eye.

Everybody know say Sgt. Dongoyaro no dey take eye see corret canna-bush, make he no come talk say hin wan go test am for laboratory, so, in short, after when all anti-crime police see say suspect don run go, drop betta ting for ground, na him dem kukuma kak seat for inside patrol vehicle, begin dey share dat fine aromatic bush equal dividend of democracy, make everybody go test hin own exhibit for house sharply.

As all dat one dey happen, Mr. Nobody run sotaaaay reach hin house, fiam-fiam-fiam-fiam, and sweat don full all him body, before him come begin dey check hin pocket to commot the Ogbomosho Yanga Bush, put am fire, take am relax and tank Jah say how as policeman no sabi run at all, witi dat dem bigi belle.

Na dat time Mr. Nobody come see the bush when him go collet am for credit ten thousand naira, don mistake fall for road, during dat time when hin dey run for police dem.

(To be Continued)

4 Likes 1 Share

Re: My Weed Experience by Nobody: 12:45pm On May 29, 2020
Jakumo:
In my capacity as the official biographer of our man Mr. Nobody, let me continue his story in fluent broken language, that can easily be followed by Nairaland's Area Boys and Area Girls.

One day be one day when Mr. Nobody just use credit collet one parcel of Ogbomosho Yanga Bush, put am for pocket begin dey wakka go house, na from there police patrol when dey pass, come smell am from inside dem moto, before dem come jump down begin dey pursue Mr. Nobody, gbudu-gbudu-gbudu.

Mr. Nobody no kukuma wait to ask any queshon. As him see say police don dey run face am, na so hin sef pick race, begin dey pass all corner-corner when he sabi for that area, say make police dem no see chance fire am for leg.

In short, na Papa God save Mr. Nobody dat day, because, as him dey run 440 because of police, na so the parcel of Ogbomosho Yanga Bush come throway for inside him pocket. As the packet of Yanga Bush fall for ground, gbosaa, BIGI police dog, when remain small to cash Mr. Nobody, come divert to collect that exhibit for ground, and turn back to go give hin oga, Sgt. Dongoyaro, dat wicked oga polisi when get red eye.

Everybody know say Sgt. Dongoyaro no dey take eye see corret canna-bush, make he no come talk say hin wan go test am for laboratory, so, in short, after when all anti-crime police see say suspect don run go, drop betta ting for ground, na him dem kukuma kak seat for inside patrol vehicle, begin dey share dat fine aromatic bush equal dividend of democracy, make everybody go test hin own exhibit for house sharply.

In the meantime, Mr. Nobody run reach hin house, and sweat don full all him body, before him come begin dey check hin pocket to commot the Ogbomosho Yanga Bush, put am fire, take am relax and tank Jah say how as policeman no sabi run at all, witi dat dem bigi belle.

Na dat time Mr. Nobody come see the bush when him go collet am for credit ten thousand naira, don mistake fall for road, during dat time when hin dey run for police dem.

(To be Continued)

baba this one no relate at all

2 Likes

Re: My Weed Experience by Jakumo(m): 12:46pm On May 29, 2020
NobodyW:
baba this one no relate at all

But na you give me contract now.
Re: My Weed Experience by Nobody: 1:12pm On May 29, 2020
Then on this day we go smoke for my guy side I remember that time well I roll wan weed wey long like drumstick I con smoke am finish only me I still take another tiny join am o then after we were about to leave liedis I no sabi the road again o I just Dey use style follow my guys for back dey do like say I sabi shocked
Na that time one spirit enter me o I just Dey reason cheesy omo the reason deep one thing dey tell me for mind say make I stop all this my smoking say he no good make I serious for my life naso I go house that day, I con dey think about my life omo the weed hit me grin. The following day I just go my guys side dem still talk say shey I go smoke omo I said no lol I no do again dem just Dey laugh cheesy

So one time like that I stopped the weed for about 2 weeks my guys con dey surprise say I no smoke again I just tell them say I go smoke but not for now but later o na that time dem change am for me lol anytime wey Weed or party dey like this dem no go call me again, I feel neglected but no shit.

Later on I don dey see say things don dey work well for me again o then I say make I try weed again o cus he don tey at least make I reason small naso I go buy weed again o I no no say this will be my last destination, naso I buy weed that day but one thing dey tell me for mind say make I no smoke am since everything is going well for me what do I need weed for but I no follow my heart at all o
That day I sha roll one weed I snap am for my phone post am for Whatsapp status dey happy grin angry I smoke am liedis I no first feel anything but about some hours naso one SPIRIT enter me o shocked I con sit down for my room dey press phone naso one guy message me say make I no smoke this weed again say he dey distroy person life he still dey ask me do I know Jesus lol I just block the contact lol sad but I don’t know that all these warning is leading somewhere dangerous.

TO BE CONTD.
Re: My Weed Experience by Nobody: 1:26pm On May 29, 2020
jasonscoolari
illicit
overdrive
olabode971
thesourcerer
elchapoo
nickshrapnel
deusmagnus
macro231101

2 Likes 1 Share

Re: My Weed Experience by TheSourcerer: 1:47pm On May 29, 2020
Jakumo:
If you are smoking large amounts of weed, then the quality of your product must be very poor. Potent natural grown weed, with no chemicals, does NOT need to be consumed in large quantities. One single hit ( inhalation) of some seriously powerful cannabis, will send most mortals into the stratosphere for several hours, during which the astronaut will have NO desire to ingest any more.

The low quality dirt weed that is sold in Nigeria, is often contaminated with dangerous chemicals, so buyers need to exercise due diligence, to ensure that they do not inhale poisonous chemicals in a bid to get high.

The solution : Grow your own, in a secret location.
I wanna grow mine but , I dunno it doesn't grow

2 Likes

Re: My Weed Experience by TheSourcerer: 1:49pm On May 29, 2020
NobodyW:
Naso I become Pablo Escobar o every day and night na smoke then my red lips starts turning black shocked my light skin starts changing too, na only me dey smoke now for my place but some times my guys go call me make we go to party na skusii and weed we go dey take, when I get home liedis na sleep straight chai...
Na that time I no serious again I dey move with smokers, now I con introduce am to my gf, anytime she visits me liedis I go give her weed make she smoke after that omo see knacking person wey no sabi knack before she con dey do like Mia Khalifa shocked omo I surprise o
I con realize say things no dey go well again o and I Dey try stop am but anytime I Dey see my guys I go still smoke o, I remember one dey wey I smoke like that one woman for my area dey ask me shey I sick ni
I don’t know I’m on the road to MADNESS cry
The matter long.....

TO BE CONTD.
though smoking irresponsibly is not healthy , but to control you habits and self when using is key to balance
Re: My Weed Experience by Terver23(m): 2:11pm On May 29, 2020
OP shut up Ya mouth. your head no carry am

4 Likes

Re: My Weed Experience by Bojack(m): 4:16pm On May 29, 2020
TheSourcerer:
I wanna grow mine but , I dunno it doesn't grow
I tried mine too but the seeds won't germinate

3 Likes 1 Share

Re: My Weed Experience by Jakumo(m): 4:21pm On May 29, 2020
Bojack:
I tried mine too but the seeds won't germinate

If the seeds are taken out of compressed weed, those seeds are likely to be broken and damaged. Since seeds are easy to come by, plant a bunch of them and then select the seedlings that look healthiest, for onward cultivation. Direct strong sunlight makes a huge difference in all phases of the plant's life.

OP Oya continue ya tory. I nogo join hand again, so far you don cancel my contract, as Tory Master consign.

3 Likes

Re: My Weed Experience by Nobody: 6:52pm On May 29, 2020
Terver23:
OP shut up Ya mouth.
your head no carry am
He go shock you
Re: My Weed Experience by DeusMagnus: 7:06pm On May 29, 2020
Issokay
Re: My Weed Experience by Nobody: 7:48pm On May 29, 2020
Yes those warnings wey I no listen to don dey react for my body now I just sit down for my room dey browse nonsense for google naso I reach one page for google wey say ‘RUN FROM THE COPS’ na that time panic attack enter me naso I comot for my house go my barber shop, my barber con dey ask me say wetin do me, why am I shaking, I no even know how to answer his questions the answer I was giving him was just meaningless o that time na evening, my barber just tell me say he wan go buy petrol naso I follow him o omo see as I Dey shake like say someone or something dey pursue me shocked on the way to buy petrol naso I see one of my guy wey we dey gather smoke weed naso I stop and tell my barber say I go see am later na that time I follow that my guy go hin side o as I enter him room I see my other guy too so we don be 3 of us for room that time na like 7pm naso dem dey ask me why I dey shake for body I no even know wetin to talk naso I chop small fried egg, so out of 3 wey Dey the room 1 don sleep na me and the other guy wey I see for road dey awake naso I begin to dey tell that one story o grin
Omo see stupid things wey I dey talk like ‘the apple logo is eaten by Adam and its to attract ladies when den see iPhone grin
By 1pm liedis something more dangerous happen o the matter long

TO BE CONTD..

2 Likes

Re: My Weed Experience by Nobody: 7:52pm On May 29, 2020
BY THE WAY THOSE TIMES I DEY HEAR STRANGE VOICES TALKING TO ME LIKE EVERYONE DIRECTLY TALKING TO ME NEGATIVELY
Re: My Weed Experience by Jakumo(m): 8:26pm On May 29, 2020
NobodyW:



BY THE WAY THOSE TIMES I DEY HEAR STRANGE VOICES TALKING TO ME LIKE EVERYONE DIRECTLY TALKING TO ME NEGATIVELY

If you are hearing strange voices in your head after smoking cannabis, then it is 100% sure that some very dangerous chemicals were added to that sample that you smoked. No matter how powerful cannabis smoke can be, it will NEVER cause a sane person to hear voices in their head.

Alcohol, on the other hand, can and does trigger instant madness and senseless violence, while alcohol also causes thousands of avoidable road accidents and deaths every year. If you drink alcohol AND smoke weed, all bets are off, and all manner of crazy and even suicidal antics become possible and imminent.

Weed alone, with no chemicals added, will never cause users to hear voices or lose touch with reality.

3 Likes

Re: My Weed Experience by Rafoski: 10:54pm On May 29, 2020
Jakumo:
If you are smoking large amounts of weed, then the quality of your product must be very poor. Potent natural grown weed, with no chemicals, does NOT need to be consumed in large quantities. One single hit ( inhalation) of some seriously powerful cannabis, will send most mortals into the stratosphere for several hours, during which the astronaut will have NO desire to ingest any more.

The low quality dirt weed that is sold in Nigeria, is often contaminated with dangerous chemicals, so buyers need to exercise due diligence, to ensure that they do not inhale poisonous chemicals in a bid to get high.

The solution : Grow your own, in a secret location.
I couldn't agree more with this guy.

I remember my friend complaining to me about nausea after smoking something with low THC but high chemicals man. Then someone else smoked Colorado and complains about pain in his lungs. Man, natural indica or a hybrid does it for me. You don't need more than two/three long held drags. Plus, many people abuse this plant. You get dopamine shortage man.

1 Like

Re: My Weed Experience by DeusMagnus: 2:45am On May 30, 2020
following
Re: My Weed Experience by Nobody: 8:11am On May 30, 2020
So 1pm reach like this naso I switch off my phone o I con tell my guys say make dem dey pray shocked omo I become pastor immediately cheesy he shock me shocked omo see prayer like say I hold night vigil shocked
Naso I Dey feel like one powerful electric shock all over my body omo I wan die that night, he just be like say dem plug my body to transformer embarassed
Naso my guys dey pray con dey wonder too say wetin happen to me sef naso I go where dem dey urinate for one bucket inside room I con use my guys urine am rub my head lol and hands o shocked
Naso I run comot from the room with my phone and ran out side o for 1am midnight o shocked I no wear any cloth na only one jean short I wear with my phone in my hand.
Now race begin, I run inside one un-completed building I dey breath heavily o naso I pluck leaves dey chop for mouth shocked I chop leaves o, after that I con dey hide from moon grin make moon no see me from there I waka pass one tarred road enter my own street naso I jump inside one big stream o with my phone, phone of 105k cry as I go deep inside the stream naso one force push me out immediately like rocket o, naso I waka go my house o I con dey use stone bang gate like make the gate comot for wall I con dey shout make dem open gate o I swear I heard my landlord saying who’s that o he dey fear for that night omo he no open gate o, naso I try climbing gate I just used my hand wound the gate thorn o blood dey comot from my hand and he no even pain me, so I went back to another street where one Hunter dey naso I Dey speak with the hunter say I dey come from one place and my house is over there bla bla bla....

TO BE CONTD..

2 Likes

(1) (2) (3) (Reply)

Breaking ! Nigerian Girl Was Brutally Murdered In Russian( Graphic Content) / Taliban Orders Local Leaders To Present List Of Girls Aged Over 15yrs / My Mother Poisoned My Sister, Asked Me To Rape And Suck Her Vagina For Ritual

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 66
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.