₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,346,797 members, 8,525,165 topics. Date: Thursday, 26 November 2026 at 08:17 AM

Toggle theme

Please Read This!!! - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum › Entertainment › Jokes Etc › Please Read This!!! (319 Views)

1 Reply

Please Read This!!! by Nobody: 8:38am On Sep 25, 2020
One day, I been wan comot. So I wear tight jeans without boxer because e no dey give me joy. As I comot, rain fall heavily for my area. People been dey rush to shed. I come turn see people dey cross go ATM shed, me sef follow. I come see dem dey cross the water dey go. Me as I wan cross, I see say fine fine girl dey there. I no fit fall hand na, as a fresh guy. I come go back run then I just jump. Immediately I land I just hear kpraaaaa. My people I say I hear kpraaaaa. I been think say na clap, den I come notice say fresh air dey enter from under.As my nyash black well well. I just look see my iskalaba dangling outside dey sing 'rain rain go away'. The fine girls dey laugh me. Shame come catch me eh. I just use my right hand cover the front and my left hand cover my nyash. Omo, I jejely sidon inside the water back. Choi which kind tin be dis na?
........Abeg dey wear boxers ooo!!
1 Reply

Please Read Carefully. If You Have Account(s) With The Under-listed Banks, • 2 • 3 • 4

Bad Business Advice (life Experience Comedy) • Wowtv • Carnival 2020 Mainsteet