₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,325,290 members, 8,421,206 topics. Date: Friday, 05 June 2026 at 11:51 PM

Toggle theme

Only You - Literature - Nairaland

Nairaland ForumEntertainmentLiteratureOnly You (193 Views)

1 Reply

Only You by Emarvel(op):
“Only You” — by Nosa Marvel

I get many women for my yard,
But make I nor lie
Na you I like,
Na you I want.

Anytime I see you,
Hear your voice,
Or even think of you,
My body go dey sweet me
Like small pikin wey don see him Christmas cloth.

My body go dey gimme joy
Like footballer wey score goal for final.
E go dey tortori me
Like politician wey just win election.
Body go dey shack me
Like person wey drink ogogoro for cold night.

I nor go lie
I fit get many women for my yard,
But na only you dey give me this kind feeling.
And na you I go like spend
The rest of my life with.

Nosa Marvel 2025✍🏻

1 Reply

234

The Tortoise I Knew - A Piece Of RealityThe Last Letter Before GraduationAttention-grabbing Copywriting For Businesses!