₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,344,323 members, 8,511,211 topics. Date: Sunday, 01 November 2026 at 04:52 AM

Toggle theme

Only You - Literature - Nairaland

Nairaland Forum › Entertainment › Literature › Only You (217 Views)

1 Reply

Only You by Emarvel(op):
“Only You” — by Nosa Marvel

I get many women for my yard,
But make I nor lie
Na you I like,
Na you I want.

Anytime I see you,
Hear your voice,
Or even think of you,
My body go dey sweet me
Like small pikin wey don see him Christmas cloth.

My body go dey gimme joy
Like footballer wey score goal for final.
E go dey tortori me
Like politician wey just win election.
Body go dey shack me
Like person wey drink ogogoro for cold night.

I nor go lie
I fit get many women for my yard,
But na only you dey give me this kind feeling.
And na you I go like spend
The rest of my life with.

Nosa Marvel 2025✍🏻

1 Reply

• 2 • 3 • 4

ANA Celebrating An Icon At 80: Programmes Unveiled In Honour Of Prof. Osofisan • Venue Hire Melbourne • Join The Ride...