₦airaland Forum

Welcome, Guest: Register • Login • With Google • Trending • Recent • New

Stats: 3,346,212 members, 8,521,802 topics. Date: Friday, 20 November 2026 at 03:17 AM

Toggle theme

Buzzkill666's Posts

Nairaland Forum › Buzzkill666's Profile › Buzzkill666's Posts

1 (of 1 pages)

Music/Radio › Re: Tekno – Freetown ( Lyrics ) by Buzzkill666: 9:57am On Feb 26, 2023
What goes up must come down
When I dey vex I dey calm down
Sierra Leone is a freetown
But the people no dey see chow

So me go down to Lagos city
Giant of Africa wey no get constant electricity (hmm)
Say me go to the street too many people I dey pity
3 years old for road dem dey beg money,
Highway no be for small pikin

For how long we go pray make e better?
How many times we go pray make e better?
Since mama born me my people dey pray say make e better.
Offering and tithe, everyday them dey pray, say make e better.

I go talk my own with my melody
Me no care if no one care for me
Who I fit help I go give money
Na the kind thing wey dey ginger me
And me no fit help everybody
But anywhere I go they want to hail me
Some dey wey dey argue who get money
But no better hospital wey dey for street

Instablog na him television
Them no fit post our politician
Election na selection
Omo get ehm position

What goes up must come down (what goes up)
When I dey vex I dey calm down
Sierra Leone is a freetown
But the people no dey see chow (no de see chow, no de see chow)

So me go down to Lagos city
Giant of Africa wey no get constant electricity
Say me go to the street too many people I dey pity
3 years old for road dem dey beg money,
Highway no be for small pikin

For how long we go pray make e better?
How many times we go pray make e better?
Since mama born me my people dey pray say make e better
Offering and tithe, everyday them dey pray, say make e better
(say make e, say make e better)

Tell me where I wan begin
Hunger, wan kill person pikin
Don bad since 1993, Still be like this in 2020

(Dunno) How things dey go like this
(Tell me) How the road bad like this
Fuel scarcity for country wey get everything e need to de very funky.

What goes up must come down
Food no dey
Light no dey
Water no dey
Work e no pay
How my people go dey?
How una dey?

1 (of 1 pages)