Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,153,526 members, 7,819,893 topics. Date: Tuesday, 07 May 2024 at 05:39 AM

Chukwukapromise's Posts

Nairaland Forum / Chukwukapromise's Profile / Chukwukapromise's Posts

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) (11) (12) (13) (of 116 pages)

Education / Re: The medical students and aspirants thread by chukwukapromise(m): 9:59am On Jun 06, 2020
drvt:


wow! nice meeting you cheif. just the post utme and admission process. that's all. I'm from kwara state too.

I know say you no call my name ooo.. But i call myself..

If nah Uniport u wan run, Then nigga Just dey prepare your school fees keep, that is if you get sense ooo.. You coming from kwara alone nah very big advantage, as uniport Nah one of the few schools I know wey get catchment for all the states them, So even if you no too reach cut off like that, the Blood of kwara go cover you..

Post utme nah just normal normal Jamb, Before before medics bin dey run maths add to their jamb combo, but Last year people dem no write maths, so luck Don dey shine for your side be that.. The post utme nah 50 question 30 minutes, if you Sabi jamb past questions well well, u no go too get issues.

And to kon butter your bread inside, you go see your results live After you submit.. Naso the school take unique put.. If you fit get an aggregate of 290+ Then Your admission Don Land be that, no mago mago untop unique uniport, No tribalism or Dem do me ojoro.. And the competition for this side no too high if you compare am to other schools them.

Admission quota for Medics, reach 130 Abi 150, abi watin Dat provost talk again?, but i sha know say out of that number about 60-70 go come from UTME, so nigga, Road clear for your side.

3 Likes

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) (11) (12) (13) (of 116 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.