Cypriotboy's Posts
Nairaland Forum › Cypriotboy's Profile › Cypriotboy's Posts
1 (of 1 pages)
Shoo no be small thing o! As e come be na for north cyprus the olopa for yonder don come out with the full tori say them abeg make we when dey there dey mind our business and las las come dey provoke say dem no do anything wen brother OBJ los say make we no provoke o say dem dey continue the investigation. Dem come release the initial report wen dey their hand say the agbero boys wen kpuff OBJ say dem troway him body from 3 storey building from their bedroom come land for downstairs and based on how God wan take catch dem they no con see the blood when dey ground wen dem drag him bodi comot enter he own car go dump am for anoda area, say plus that one dem gbes the OBJ money wen dey im pocket plus the one wen be say dem dey owe am join. Wetin come happen be say olopa carry dem go court on friday so that judge go fit let dem hold the agberos dem for another 3 days for sanko so dem no go spoil the investigation if them release them on bail. We con put foto of the area as the olopa them release am.
|
1 (of 1 pages)