₦airaland Forum

Welcome, Guest: RegisterLoginWith GoogleTrendingRecentNew

Stats: 3,330,995 members, 8,448,140 topics. Date: Sunday, 19 July 2026 at 08:07 PM

Toggle theme

Enigma1510's Posts

Nairaland ForumEnigma1510's ProfileEnigma1510's Posts

1 2 3 4 5 6 (of 6 pages)

RomanceRe: I Spent 3millionaira In A Night Club (my Yahoo Story) by Enigma1510(m): 11:26pm On Sep 16, 2021
TMTR:
The email on your signature, do you still have access to ithuh
Of course...
RomanceRe: I Spent 3millionaira In A Night Club (my Yahoo Story) by Enigma1510(m):
My story na same thing as the Op, imagine being a spammer coz me no like to dey chat and i no like to dey show off or club...but i fit carry babes for myself and friends and I won’t touch am and still pay am more than normal because if i later switch on my light when i get home, and you aren’t my taste, i would just sleep off, if the lady don smoke and i dey smell am, i no go sleep that room, I don’t like alcohol but i sabi sey most runs girls drink alcohol because if the way guys Bleep them. Imagine olosho falling in love with you coz of the way you treat them and wouldn’t wanna Bleep your friends no matter what. I’d just be like ama increase your money, its you my pal want. I wouldn’t say because you are a prostitute, i must treat you like one but if you cross your boundary, when i shout, u go think sey i dey possessed. I think am attracted to smart women, worst part be sey other olosho i carry for my friends fit see me again another day and go wan follow me!!! And me no dey carry same girl again. Lmao, most times you go give your niggas the money to give the girls so it won’t look like you are the one spending the cash and you niggas go Bleep the girl tire and still give am change. Their gfs go wan date you, go dey complain sey dem broke and if you transfer just 20k, dem go start to dey chat you up and dey badmouth your padi and how stingy he is...blah blah blah,

Mama talk sey buy land, me prefer gold, and i know how to bribe alot to avoid stress anywhere. the only thing was i never did anything illegal till i finish university and that was why i was able to still hit 4.11/5.00 GP in one if the toughest department in engineering.

Na that time all this SEO dey hot and I remember leapviral...lol, i was using a script then and i no buy car though i had the cash but i no sabi tell people no if dem ask for money. And i used to believe 5k was too small to give someone then...coz my brain go convert am to USD!!! Lol...
When i con finish NYSC, it was easier to become a spammer because i used to create landing pages and all and doing affiliate marketing, i sabi how much go dey my account. If i dey broke e mean sey i get like 5M for acct, my brain go dey work on how to make more coz i dey lazy. Wetin be my own with CV!!! Had already said i would never ever work under anybody. Bought my first car and i no dey post anything, na friends cast me. Bought second one for transport business a month later, bought the third for my friend whose car we were using when i had none few weeks later. All in less than 3 months, told him to pay back anytime he makes the money, i no dey comot during the day, na night, i no like people seeing me. But the noise of generator 24/7 made people wonder how i dey make money without leaving home. And i dey buy 50litres of petrol!!!
Started business with my so-called friend and was the money man but nobody knew, I wouldn’t talk to any olosho unless na my taste, dem go dey ask que who dem wan follow, you go see me wearing bathroom slipass, but anyone i choose go follow me reluctantly until we reach house and dem see sey na me be the owner of everything including the house and i always see the look in their eyes sey, so the guy in bathroom slipass na the joker. I just love wearing anything comfortable. I won’t buy clothes but would give people money to do shopping.
Na when no update dey, spent the money in my main account and started touching my savings i knew something dey happen, car developed fault, instead make i manage, i said make dem remove the whole shit under the bonnet and put another one...spent around 800k to repair a car wey no worth 3M. I just love disguising, i no dey shout but money no dey enter, na xo i start dey borrow niggas money sey when money enter, we go sort am out, na one by one niggas comot. The one wey be face of the business and i made sure the biz acct na either to sign incase i travel, him dey spend money i dey use run salary for the two of us as i dey plan to comot, na the day he withdrew 120k i talked....this guy no tell me wetin he dey use money do. Lmao...the guy go buy land with my money. Later got to know...na the same guy i buy car for, even phone wey pass mine.

Na when you dey see too much debit alert you go sabi sey something dey sup!!! Me wey go dey use one useless phone go buy better one for friends and families because i am always happy anytime i surprise anybody. But when nothing dey again, fake friends dey follow another person comot, family members sef dey shout...go find work, even if na 50k, you are too lazy. But i no lazy when i dey give everyone monthly allowance...lol or give dem money to pay salary for their workers.

Bro, my account entered red!!! I never knew i was just being lucky and people dey pretend to be my friend coz of what they were collecting and they were keeping their own...a week turned into a month and a month turned into a year and didn’t make that big money, was only making money to survive...i still believe everything was a big lesson but i fit borrow to make others happy.
The day it dawned on me was the day i was calling everyone i needed 200k and was gonna return it thesame day and nobody gave me 1 naira i knew I made a fucking big mistake despite all the humility and everything. Didnt know how to spend. My own is make money enter and make e comot!!! Sey big money is coming. We all budget for money we never see, like saying once i see 20M, dear remind me to do this...

Me wey no fit do job wey less than $5k con dey do job of $1k, $200 just to sha work and continue trying. Nobody told me to close my laptop and start afresh...thats my plan...i know my big moment is still coming but i gotta wakeup and know sey i no dey yankee but Naija and make my brain no dey convert!!! You go just hear me talk sey ordinary 50,000naira wey be $100btc.
Lmao. I don’t get intimidated so when i see guys using a ride of 17M, because i would just convert the 17M to dollars and laugh it off...na dubai made me realize cars are not expensive at all!!! Na naira no get value...who wouldn’t wanna earn in dollars and change it to naira. I would still laugh and think lets see whats gonna happen in 5 years.
At least i got my certificate which i earned without doing any runs. I read like my life depended on it and i earned it but certificate i never sabi who i gave to help me keep sef. I just have the scanned copy of everything.

Now i don get CV but i no sabi how dem dey look for work. I no get any shirt, tie or those shoes you go wear go interview. Not even one!!! It’s depressing like mad coz u go dey reason sey u wey dey spend 50k daily without leaving house con dey look for 10k. Na music dey help atimes!!! And na mood go determine the genre if music to listen to.
So Op, we all gotta retrace our steps and start from the scratch because game money will always go back into the game if not well spent!!!
I always tell people I didn’t spend lavishly because thats what people would say but na lie, if you give someone 10k, they would think you must have up to 500k, not knowing you even gave them outta the money you borrowed.

I realized i started seeing money at a young age(19years) affected my thinking till now. When i was importing but wasn’t good at marketing so i partnered with a friend then too and the biz got bleeped up, got broke and later started making money again, still dropped all the cash for another business but they were big money to us then, 200l student wey get 500k for acct, and dey collect 6k for pocket money every month. So i no sabi spend, but i sabi borrow ppl money dem no go return. And i sabi drop money for biz but people must not know na me drop the money. I no like overhyping. Thesame way i was hiding my result and was always sitting at the back of the class and missed series of tests until my stupid department pasted our result even with our names on it. That was when people no teach me anything again.
It took me years to realize never to borrow ppl money again but just give them what you can or borrow them and forget the money because it would never come back!!!

Saying all these tonight made me feel good. Sold all my gold, sold lotta stuffs just to satisfy ppl, na when i called my mum i wanted to sell the only car left and my wife started crying i realized I need to act like a man and not wait for the money to come...man must have a constant source of income. My next move is in my mind. I just dey call everybody i dey look for work, dem no believe...

Sorry for all the typo errors, I don’t have time to be correcting anything.



MODIFIED: My whatsapp number is

‪+1 (920) 634‑8758‬

Got tons of people messaging me through Nairaland, i’d never reply for security reason, I always think things through and i have checked each and everyone’s profile that sent me PM, my email in my signature is the only way to contact me because NL refused to allow me change my account’s email. Please if you wanna chat me up and beg for anything, I cannot help, but if it’s about something that gonna make me use the 60% of my brain I haven’t used because I have been lazy, chat me up. And please always go straight to the point, no sad stories or anything. Am in SW, don’t wanna mention the particular state because thats gonna make give some people clue about who i am. The email on my signature is always active and even if you see it being changed everytime, it would always be active.
Rule 1: Never trust a faceless forum, people acts alot and we have informants here that wanna cash in. So be careful whatever you post on any social media!!! Because if i am caught for my past misdeeds, I might be left alone thesame day even as am broke, but you might be charged to court because some people are just fucking dumb!!!
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 9:25am On Feb 14, 2015
kingbus:
what is the fate of those he owes now ? I hope they all get their monies back
Am one of them, i dont think we can get anything back. It was really hard to cope though
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 9:23am On Feb 14, 2015
dragnet:
and what would be the contents of the thread?
Was planning to ask people for his whereabout, to show them our chat and also tell my story. But i later realised i would be wasting my time doing that coz i have better things to do than creating a thread.
PoliticsRe: APC Manifesto Spending Plan To Cost N53trn Over Four Years - Business Day by Enigma1510(m): 5:49pm On Feb 06, 2015
JONATHAN EBELE AZIKIWE ANSWER THE FOLLOWING QUESTIONS : * In 2008 when Obasanjo picked you to be Yaradua's running mate who were the people that first kicked against your candidacy? The Ijaws did. Their reason was that the 2 years as governor in Bayelsa you did ABSOLUTELY NOTHING. Till date, your erra is still termed the worst in Bayelsa.

* Why did Obasanjo find it difficult to sell you to his allies and PDP as Yaradua's running mate? You Jonathan had a case with EFCC has documents proved you embezzled N9,000,000,000 (NINE BILLION NAIRA) while your wife Patience laundered $4,000,000 (FOUR MILLION DOLLARS) all these within two years.

* Ebele, who was your biggest opposition in becoming Yaradua's running mate? The answer is EDWIN CLARK. The man who today is your mouth piece and who is pretending loves you the most.

* Azikiwe, amongst other tricks, what did you do to gather public sympathy? You Mr Deceitful sent people to blow up part of your house in Bayelsa to make it look like it was your political opponents. The SSS released a report which you guys later hid to debunk your dubious claim.

* Jonathan, when Yaradua made you to be in charge of negotiations with the Niger Delta Militants, who were those who objected and what was their reasons? Asari, Tompolo, and Boyloaf. Their reason being that you are not sincere in the Niger Delta course but only after your pocket. SHOULD I GO ON?

* What was your agreement with PDP regarding a 2nd term. You promised and even swore you will go for a SINGLE TERM

*Why did you jail James Ibori and forced Aoandoka to go underground? To revenge their utmost loyalty to the late Yaradua .

* Did you fulfill your agreement to Tinubu and others even when they had to betray their party at that last minute in order to canvass for you. ABSOLUTELY NO.

* How did you try to mock and tarnish Obasanjo? You didn't only remove all his loyalist from your government, you also made sure you made his enemies your closest allies. You don't need me to start calling names right? * Who is Jonathan's BIGGEEST Northern Ally? Alli Modu Sherrif. The CHIEF SPONSOR OF BOKO HARAM. AWAY FROM POLITICS.

* You promised Nigerians incentives in order to remove subsidy. Things like stable power, metro buses (in Lagos and Abuja), full road rehabilitation etc. MR LIAR WHERE ARE THEY.

* Obasanjo's government brought GSM amongst other things, Yaradua's short time in government brought RULE OF LAW. Jonathan what has yours brought? NOTHING EXCEPT INCREASE IN CORRUPTION.

* Never in the history of Nigeria has all institutions witnessed as much strike as yours.

*Jonathan WHERE ARE THE CHIBOK GIRLS.

* Jonathan what in Heaven's name do you need FIVE presidential jet for even with the high rate of poverty in the land.

* Ebele, the ONLY Nigerian president that tried all means to DIVIDE Nigeria along Religion and Ethnic line.

* The ONLY AFRICAN PRESIDENT THAT OPENLY CELEBRATES CRIMINALS AND EX CONVICTS. Kashamu, Alameisia (or whatever), Bode George.

* Jonathan will rather gallivant with Nollywood stars than have a session with those brains who are truly making Nigerians proud both Home and Abroad. Or better Still, compose a comforting message to the people of North East. Nigeria as at today HAS NO GOVERNMENT. We provide our water - borehole. We provide our light - generator/ inverter We provide our security - high fence/ cctv We provide our education - private school. We produce fuel yet pay the most in the world. We have no motorable federal road. A BIG SHAME NIGERIA HAS NO NATIONAL CARRIER. HIGH Uneployment in the land. High rate of Corruption (the CLOWN wants to curb corruption with technology). JONATHAN YOU ARE A FAILURE!!! Even if WE give you 10 terms ( 40 YEARS). YOU WILL STILL NOT TAKE US TO THE PROMISE LAND

NO BE ME TALK AM OOOO...na copy and paste. Before all his brainl*ss boys chase me back to my village. AM sure sey AJIMOBI go save my blacka** grin grin grin
Technology MarketClosed!!! by Enigma1510(op):
Closed
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 1:11am On Dec 21, 2014
kingbus:
arrested? But he says he lives in america .
Dunno hw he was running the business bt na calabar d guy dey stay sha.
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 11:35am On Dec 16, 2014
Soyedele1:
grin
Na laughing matter oooo. Thank God Linkto has been arrested. Am planning to create a thread about this soon.
InvestmentRe: How To Raise Any Amount Of Cash To Do And Buy Anything You Want For Free.3 by Enigma1510(m):
Hgg
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 11:21am On Sep 06, 2014
Enigma1510: thread don die.
Linkto!!!
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m):
thread don die.
Jobs/VacanciesRe: Moderators Needed by Enigma1510(m): 11:10am On Jul 08, 2014
ikoyila: questions r welcomed. @enigma u knw dts not a question. i guess av som oda tin u wanted to say. pls spill it out. it wil b answered here. u can as wel visit d website for veification purposes
I already visited the site. The reason why i asked for pictures is just to confirm if truly the site is paying out. Sorry if i sounded amateur-ish bt am talking from experience. Thanks
Jobs/VacanciesRe: Moderators Needed by Enigma1510(m): 2:38pm On Jul 07, 2014
Is this real? And do you have pictures to convince people?
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 5:14pm On Jul 02, 2014
linkto: i'm online now.
saw u online, sent u several msgs bt you didn't reply.
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 4:09pm On Jul 02, 2014
folex: Offline!!!
thought na my phone dey do weyrey. Lmao. D guy is offline, yet he said he's online. Thank God i posted that picture. Linkto, if you are nt ready to discuss anything, just tell us than calling us fools indirectly pls. That's my 50cents undecided huh

Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 3:56pm On Jul 02, 2014
linkto: Online
i don use torchlight search you. I no see you.

Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 1:42pm On Jul 02, 2014
linkto: I'll be online on Wednesday. Do get in touch with me. Thanks
offline? cheesy

Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 12:18pm On Jun 30, 2014
texaco1: sorry for the loss bro,let's pray. Everything works out for good.
Thanks Bro. grin
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m):
Hhh
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 3:51pm On Jan 08, 2014
humblesteve: Drop your contacts bro, let me see how I can help
Chk my signature Bro.
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 11:30am On Jan 08, 2014
@Toyosi and Humblesteve, you pipz dnt knw aw I feel. I only got two days to return d cash I borrowd. Called Linkto, he refused to pick up den switched off his f**king phone. Sent messages, didn't get any reply. He's nt using YM again. I hate it when am being ignored. I dnt even need any excuse from him again. Its either I collect my items/cash or nothing.
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 11:07pm On Jan 04, 2014
humblesteve: linkto!!!
Linkto, you are beginin to get on my nerves. No items, no cash, and no update. Are we morons?
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 12:12pm On Jan 02, 2014
Soyedele1: He sent you a phone too?
Yea, he did.
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 8:18am On Jan 02, 2014
Tonjeola1: If you want to enjoy 2014 in peace, make your clients happy by getting them their goods or refund their cash. some of the cash are borrowed.
Thanks Bro. I supposed to refund d cash I borrowed from someone on 10th of this month with a 10% interest. I only got a 115$ phone from linkto. Av lost all my customers, gat no cash to buy anything. Having family probs now. Datz why I said he's turning me to a mad man. I still have over 100k with him. Seriously, d phone he bought for me is very very good but still expecting my items/cash. Linkto, u knw av neva talked rudely/harshly to U all because I respect everybody equally and I knw what to do in dis kinda situation. Abt ruining your life, I gat nothing to gain there bt don't push oda ppl to do it. Update d thread and let us know what's going on. Happy New Year my brothers in da House. We gotta be patient pls. God'll help him solve all his probs. Thanks.
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 8:10am On Jan 02, 2014
digi101: oga linkto;
No one can really fantom what went down that led to to the liquidation of 6 million in terms of your clients funds, however the responsibilty is on you to do the honourable and right thing by reimbursing your clients for the funds in question. That said, i can imagine you may not have 6million lying around, i suggest you stop the peek a boo game and hold a joint discussion with your clients (like you proposed earlier), taking time to explain what went down (they deserve to know, no matter how crazy it may be),proposing a refund plan & listening to their responses. Theres no short cut to redemption here, and it wont be easy, but if your name is worth anything you'll see it through and come out stronger on the other side.

Goodluck
Thanks a lot Bro. Good write-up
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m): 9:43am On Dec 31, 2013
I wake up each day still hoping he's gonna come around. At this juncture, we shouldn't give up. If this thread dies, then our hard-earned/borrowed cash is gone!!! Dunno what's going on coz he's not updating us. Linkto, if you are seeing this, you better do d right thing. Even if everything is not going as planned, d best thing is to keep us updated coz its gonna give us hope. To be disappointed earlier is better than waiting and thinking if one is gonna get disappointed later. I don't wanna say -ve things but if u make me go mad, am gonna...to be continued!!! For those that still gat some items/cash with him, what should we do? Should we still wait and see if he's gonna contact/update us?
Technology MarketRe: . by Enigma1510(m):
Linkto, have u travelled back to the states or what? Been trying to get intouch with you. Am like a lost goat right now and i need to clarify some things. Call me or maybe we should meet on YM. My numbe

1 2 3 4 5 6 (of 6 pages)