Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,152,749 members, 7,817,077 topics. Date: Saturday, 04 May 2024 at 03:31 AM

JefferyUk's Posts

Nairaland Forum / JefferyUk's Profile / JefferyUk's Posts

(1) (of 1 pages)

Literature / Backseat Boys(rough Sketch) by JefferyUk(m): 1:54pm On Aug 08, 2014
Classroom setting;rowdy. 2 boys are sitted at the back engaged in a conversation
Destan: her paaaaaa!!!!!
James: hahahahahahaha ya still dey reason am?
Destan: before ncor,one small pikin go get mind curse me becos wetin? She dey jand
James: guyyyyy na ya bring yaself down wey she take see ya finish
Destan: abiiiiii,well shaaa lesson learned
In walks Tobi
Tobi: aswear Boyo na confam gay ohh
James: hahahahaha wetin suppp?
Tobi: me and em Dan be dey talk bout avengers movie and hw hulk take Bleep loki up na bros jus start to talk rubbish like he wonder hw big hulk dick be and whether da ting dey big more as he dey vex. I jus weak when I hear am
Destan and James: hahahahahahahahaahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahahaahahahahahahahahahaahahahahahahaha
Tobi: da matter tire me ohhhhh
Bell for break over rings
Destan: so 4 days in a row now we no go out for break,moneyyyyyyyyy ehnnnnn
James: aswearrrrrr,see as we jus dey lean anyhow
Tobi: iono bou una oh buh me go hustle food chop,I don be ragging master hahahahahahaha
Destan: dat na sontin wey I no fit do,make all da girls come dey reason person as beggar
Tobi: guy na ya own be dat o,life na per-head.
James: shey break don end? Hw come nobody don come? Wetin we even get right now?
Destan: na English we be get buh I no sure say he come school cos C class no do English today. Thank God sef cos me be no bring ma textbook
James: me too ohhhhhhhh,so na anoda free period. This na da 3rd one today and we neva openbook and waec na jus 3 months away. We gats serious oh
Tobi: na word ya dey talk guy buh to dey read for school get as it be for me,too many distractions and una no dey let person concentrate wiv una mumu mumu talk
Destan: all dose ones na jege,if to read dey ya body ya for read.
James: no leave am make he dey blame person for he unseriousness
Tobi: una be gbefs oh
A lil far away a group of guys arguing loudly……………
Destan: all dose ones don dey argue mumu mumu tins again
Tobi: aswearrr,it be like say na da usual argument of who strong pass btw naruto and goku
James: na wa ohhh and this na ss3 boys ohhhh,wetin jss1 boys no fit do.
Destan: guyyy no dey form tins,when I come ya house dat day no be im ya pman and he friend dey argue or ya fink say I no hear am haahahahahahahahahaahahahhaha
Tobi: hahahahahahaahaahahahahahahahahaah
James: ya jus be fool ohhh
Destan: na joke eeee guy
Tobi: ehenn James hw far Sonia na,ya still dey run am?
James: guy me na usain bolt for the matter oh buh she dey form hard to get. Me know say na initial gra gra na she jus dey do
Tobi: na sooooooo,ya head dey dere
Destan: me jus dey reason dat new ss2 girl oh; da fair onee,she bam dieee and this morning I see am dey eye me one kain. I come dey feel fly
Tobi: hahahahahaahaha no wonder ya come dey pack when we dey comeback upstairs hahahahaha why it be say when ya wan form ‘cool’ ya go come dey pack trouser dey drag ya sleeves up? Dat na small pikin tin naa
Destan: hahahahahaha guy me no know ohh,na jus force of habit
James: buh guy na Bleep up to dey run ss2 girl na,girls no dey our class?
Destan: all dese ashawos for our class wey dem don press finish? Ya dey crase ya hear. All da good girls dey either taken or them don friendzone me. Dat mumu Yvonne don friendzone me sotey she come dey meet me make I give im and her mumu bf deir couple name. ahhhhhhhhhhhh I don dieeeeeee
Tobi: hahahahahahhahahahaaahahahahaahaahahahahahahahhahahaahaaahhaahah dat one na big Bleep up ohhhhh,na ya fault shaaa cos ya too dey play and joke around so hw dem wan take reason ya as bf material? Ya don too show yaself
James: abiiiiiiiiiiiiiii,ya don dey wise ohhh Tobi
Destan: abeg make una shut up,wetin una know? If any girl no like me as I dey den make she park well. Me no fit change maself jus cos I wan impress girl
Tobi: kk ohhhhhhh broda,na ya know
Destan: ehnnnnn na me
James: make una shut up,teacher don show

In walks the English teacher,da whole class organizes itself and proceed to greet.
Mr Ode: sorry class for coming late,I am not feeling too good today #Sneezes
Destansadshouts) EBOLA tinssss
Da whole class burts into laughter
To be continued,this is somefin I did outta boredom. Not really a committment buh that can change depending on the kinda comments and views I get so if ya wanna see hw da story goes pls comment. And am still a freelance content writer,if interested hit me up on ma mail www.jeffukhurebor@gmail.com
Literature/Writing Ads / Freelance Writer In Need Of Writing Job by JefferyUk(m): 6:37pm On Aug 02, 2014
Am a freelance writer in need of writing jobs no matter the niche. I am open to a free trial before consideration as far the pay is reasonable and should suit the quality of work I am to put forward. Pls hit me up on my mail;www.Jeffukhurebor@gmail.com
And yh,no scams pls.

(1) (of 1 pages)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 17
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.